ADC announce Rotimi Amaechi as Vice Presidential candidate, as Court order Inec to remove ADC, odas from register

Chibuike Amaechi dey shake hand wit Atiku Abubakar as dem pose face camera.
Amaechi wear red cap with flowered cream colour cloth while Atiku wear sky blur cloth wit bue cap wey dey design.

Wia dis foto come from, ADC /X

Published
Read am in 7 mins

Di African Democratic Congress (ADC) don announce former Rivers State govnor, Chibuike Rotimi Amaechi as di running mate to dia Presidential candidate, Atiku Abubakar.

Wit dis announcement, di former Minister of Transportation don becom di vice-presidential candidate for di 2027 general election.

Di Action Democratic Congress describe di collabo as "unity and rescue ticket."

ADC National Publicity Secretary, Mallam Bolaji Abdullahi, wey do di announcement for di party social media platform, X tok say dem no just choose Amaechi like dat, dem pass thru broad consultations within di party.

Im add say dis selection reflect im strong performance as runner-up for di party presidential primaries as well as im track records of service to im State and di kontri.

"Amaechi extensive experience across both di legislative and executive arms of govment, as former Speaker of di Rivers State House of Assembly, two-term govnor of Rivers State, and former Minister of Transportation, make am uniquely qualified to complement Atiku leadership, strengthen di party national appeal, and bolster di campaign to offer Nigerians an experienced and credible alternative ahead of di 2027 presidential election.

For statement wey ADC release on Monday 15 June, 2026 di party tok say di kain experience wey Amaechi get na only few pipo get am for di kontri.

Di party add say Amaechi balance for ground wit experience from di legislative and executive arm of govment.

Dis depth of experience go dey invaluable in supporting di next ADC administration from day one.

"Beyond im impressive credentials, Rt. Hon. Amaechi strengthen di ticket strategically. Im political influence across di South-South and wider Southern Nigeria, im reputation as a reform-minded administrator, and im proven ability to build coalitions across political, ethnic, and regional lines make am uniquely positioned to complement di candidacy of Atiku Abubakar.

Togeda, Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi carry true-true national ticket - di one wey dey bridge regions, generations, and political traditions.

"Dia combined experience for governance, economic management, public administration, party organization, and nation-building go offer Nigerians a credible and compelling alternative wey dey capable of restoring confidence for govment and push national development."

Mallam Bolaji Abdullahi wey be ADC tok-tok pesin explain say dis Amaechi and Atiku ticket dey come at a time wen millions of Nigerians dey demand for competent leadership, economic revival, job creation, security, and national unity.

"Atiku-Amaechi ticket send a clear message: di ADC dey prepared to govern, prepared to unite di nation, and prepared to deliver results.

Di leadership of di ADC dey confident say dis partnership go ginger our growing coalition, inspire hope among Nigerians, and provide di leadership wey dey necessary to build a stronger, safer, and more prosperous Federal Republic of Nigeria."

Atiku beat Amaechi for di ADC Presidential primary. According to di political party, Atiku get 1,846,370 votes as im beat im closest rival, wey be former Rivers State govnor Rotimi Amaechi, wey score 504,117 votes.

Im and oda aspirants bin reject di results, Amaechi bin tok for one interview bifor di primary for local media say im no go also step down for anybody.

ADC na one of di opposition parties for Nigeria wey form coalition wen members from oda political parties wey get kasala joinbody togeda to form di party.

Kenneth Okonkwo reject Atiku/Amaechi ticket

Nigeria actor and politician, Kenneth Okonkwo, tok say im no go fit campaign for former Vice President Atiku Abubakar for di 2027 presidential election if im political party no pick dis vice-presidential candidate from South-East.

Okonkwo tok dis afta African Democratic Congress (ADC) appoint Rotimi Amaechi as di party vice presidential candidate on Monday.

According to am di founding father of ADC na from South-East and if dem no select anyone from di region e mean say dem still dey face marginalisation as di region neva produce any president or vice president candidate since 1999.

E tok say if Atiku and oda party statemen fit confam to am say South-South go be di preferred candidate im wish dem well.

"I hear from social media say ADC don pick vice presidential candidate from di South-South. If dis na true, e dey unfortunate, as dis go continue to dey marginalize South-East," Okonkwo tok.

"Dis Geo-Political Zone neva produce President or Vice President since 1999. To deny di South-East di opportunity to produce di President or Vice for ADC in 2027 go mean say dem dey continue di marginalisation."

"Di ADC founder na Ralphs Nwosu from South-East, e create am in 2005. E sacrifice to give up di party for 2025, for di coalition wey go bring bettaNigeria. E no fit make dat sacrifice to marginalise im own pipo."

"Di only favor wey I sey ask Atiku Abubakar, wey don openly declare say na im be di pathway to di South-East presidency, na to show am by picking pesin from South-East to be im Vice. If dem confam say im don pick candidate from South-South, I wish am well. But I no go fit campaign for any presidential ticket wey no get pesin from South-East as President or Vice for 2027."

Chibuike Rotimi Amaechi Profile

Dem born Chibuike Rotimi Amaechi on 27 May 1965 and na Nigerian politician wey come from Rivers State.

Im bin serve as Minister of Transportation for Nigeria from 2015 to 2022 under former President, Muhammadu Buhari.

Amaech serve two terms as di Govnor of Rivers State between 2007 to 2015.

Between 1999 and 2007 Amaechi serve as Speaker of di Rivers State House of Assembly.

Im resign im ministerial position to contest for presidency under di ruling All Progressive Congress (APC) for 2022 but im bin lose for di primaries for 2022.

For di party primaries im finisg second behind incumbent Nigeria president, Bola Tinubu.

Court order Inec to remove ADC, Accord, odas from register

Federal High Court for Abuja don order di Independent National Electoral Commission (Inec) to remove African Democratic Congress (ADC) and four oda political parties from dia register.

Di oda political parties Action Peoples Party (APP), Action Alliance (AA), Accord Party (AP), and Zenith Labour Party (ZLP).

Dis dey come afta Justice Peter Lifu give judgement for case wey di National Forum of Former Legislators bin carry go court dis 2026.

For di suit di group pray di court to determine weda Inec get constitutional power to remove political parties wey fail to meet di electoral performance threshold wey dey for Section 225A of di 1999 Constitution (as amended), and wey dey reinforced by di Electoral Act 2022 and Inec regulations.

For dia case, di group tok say di five political parties wey dey listed as defendants for di mata no dey meet di constitutional benchmarks wey dey required to retain dia registration evritime.

Di former legislators explain say di requirements include to win at least 25 per cent of votes for a state during a presidential election or to at least get one elective seat for di national, state, or local govment level.

Dem tell court say di ADC and di four oda parties no perform well at all for di 2023 general elections and by-elections wey Inec conduct sake of say dem no win seat across important govment seats.

Di group explain say to recognise ADC and di oda defendants as recognised political parties dey unlawful and e dey undermine di integrity of di electoral system for di kontri.

Dem tell di court to declare say na Inec duty to deregister dat kain party dem as dem also tell court to give inec order to deregister di five political parties bifor preparations for di 2027 elections start to serious.

Di group tell court to stop di five affected parties make dem no participate for di general elections or engaging in political activities like campaigns, rallies, and primaries.

Dem also seek court injunction wey go stop inec from recognising or dealing wit di parties in any official capacity unless and until dem strictly comply with constitutional provisions.

E neva dey clear weda dis judgement go affect di candidates of di political parties wey dey affected including former Vice President Atiku Abubakar and Chibuike Amaechi wey ADC just name as dia Vice-Presidential candidate to contest di 2027 presidential election.