See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections

Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams

  1. Ghana Police Service dey ready for Monday polls

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Ghana police

    Ghana police service don begin deploy officers and men to different constituency and region wey go cover tomorrow election.

    BBC Pidgin tori pesin for Kumasi Ashanti region report say thousands of police na im dem deploy .

    Ghana police
    Ghana police
    Ghana election
    Ghana election
    Ghana election 2020
    Ghana election
    Ghana election
    Ghana election
    Ghana election
  2. Ghana Prez. go address de nation today

    Election 2020

    Wia dis foto come from, Nana Akufo-Addo

    Ghana President, Nana Akufo-Addo go address de people of Ghana by 8pm Accra Time on Sunday.

    Dis nationwide address na wetin de president wan to tell de country ahead of dia 7 December election.

    Meanwhile Ghana Electoral Commission go brief tori pipo today about dia final preparation for di election.

  3. Police clear de air on New Patriotic Party Chairperson Bernard Antwi Bosiako 'arrest video'

  4. Prez. Akufo-Addo endorsement mistake of Nii Lante, .

    Pipo don dey react afta President Nana Akufo make mistake call di name of NDC Parliamentary Candidate, Nii Lante Vanderpuye instead of im own NPP party candidate, Nii Lante Bannerman.

    Dis one happun last night wen im dey conclude e presidential campaign for James town.

  5. Meet de woman who dey organize Ghana 2020 election

  6. No wear party colour on election day - Ghana Police Service, .

    "No wear party colour on election day"

    Na de election security tip for today from Ghana Police Service ahead of tomorrow election day.

    Ghana Elections 2020 polls
  7. Missing Voter ID Card owners fit vote on election day, .

    Ghana Election results

    Registered voters for Ghana wey dia Voter ID Card dey miss still fit vote on election day 7 December, 2020.

    De electoral commission say make dem just go di polling station wey dem register and mention dia name to di officers wey go then look for am.

    Meanwhile, Ghana Electoral commission don talk say on election day, dem go use di Biometric Verification Devices(BVD) take verify voters.

    Di BVD get record of both di fingerprint and facial recognition of each registered voter. So in case machine no fit detect voter fingerprint, then facial recognition go come be di alternative.

    Also, Ghana Electoral Commissionsay dem no go allow any voter wey no wearnose mask enta Polling Station on Election Day.

    Click here to sabi all di COVID-19 protocols wey di EC don put in place for di safety of everyone.

  8. Four unique things about Ghana 2020 Elections you need to know

  9. Ghana economy, corruption scorecard under Mahama vs Akufo-Addo

  10. How Prez. Akufo-Addo wrap up im presidential campaign, .

    Ghana President, Nana Akufo Addo go today conclude im presidential campaign for di 7 December election.

    President Akufo-Addo address NPP supporters on Saturady for James Town, Accra.

    According to election law all political get today as deadline to finish dia campaign for Monday election.

    De Ghanaian leader ask de people of Ghana whether en deliver on de promise to develop Ghana in de last four years since im enter office on 7 January, 2020.

    Ghana Elections 2020
    Ghana Elections 2020
  11. "Why I want to declare Ghana Presidential election results within 24 hours"

  12. Fotos from Ghana elections 2020 peace pact agreement

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

    Ghana election peace pact signing

    Wia dis foto come from, John Mahama

  13. Crowding around polling unit fit distract de process - Ghana Police Service

    Today Daily Election Security Tips from Ghana Police Service on electoral offences na say "crowding around polling unit fit distract de process".

    Ghana Elections 2020 Polls

    Wia dis foto come from, Ghana Police Service

  14. Ghana Elecetion 2020 battleground - See de 'must-win' regions, In order for any party to win de 2020 elections, dem for win at least two out of de three battlegrounds

    Ghana Elections 2020 polls

    Wia dis foto come from, Getty Images

    In order for any party to win de 2020 elections, dem for win at least two out of de three battlegrounds.

    Dis be Greater Accra, Central den Western Region.

    Historically, dis coastal regions who dey change dema voting pattern in every election - so all eyes dey on Accra, Central and Western ahead of de elections.

    "Word Bank" Factor

    In addition to winning these regions, de NPP and NDC get dema strongholds or what Ghanaians dey call - "world bank."

    De volume of votes from Ashanti Region dey determine how well NPP go perform.

    Wey volume of votes from Volta Region dey determine how opposition NDC go perform.

    In 2016 for instance, NDC record 115,000 less voter turnout for Volta Region compared to de 2012 turnout, contributing partly to dema loss.

    So on December 7, dis be de elements wey you for look out for if you want see who dey win or lose.

  15. "Elections be about counting heads not counting deaths", John Mahama make commitment for peace deal

    "Elections be about counting heads not counting deaths"

    Na de commitment of NDC Candidate John Dramani Mahama after en sign peace deal wit Prez. Nana Akufo-Addo on Friday.

    Presidential Candidates 2020 in Ghana:John Dramani Mahama
  16. America wish Ghana peaceful election

    Presidential Candidates 2020 in Ghana:

    US embassy for Ghana commend Ghana election 2020 Peace pact wey President Nana Akufo Addo and John Mahama de leaders of de two main opposition party, sign ahead of de 7 December polls.

    For tweet de embassy say de threat of electoral violence be threat to democracy anywhere for de world.

    “Political ambitions no suppose be allowed to tear down what generations be don build for ground”

    Dem wish Ghana a peaceful election.

  17. Ghana EC boss meet wit election observers today

    EC meet wit local observers

    Wia dis foto come from, Electoral commission of Ghana

    De Ghana electoral commission chairperson, Jean Mensa meet wit local and international election observers on Friday ahead of Monday 7 December polls.

    De meeting be to update dem on de progress made as dem be dey prepare for de 2020 Presidential and Parliamentary General Elections.

    Madam Jean Mensa emphasize make de commission dey ready for successful, credible, orderly, timely and peaceful elections.

  18. I promise to accept de verdict of de people of Ghana - Prez Akufo Addo

  19. De moment Prez Akufo-Addo & John Mahama sign peace deal Ghana election 2020, .

    Wetin we call dis Video, Ghana Elections 2020 Polls: Nana Akufo-Addo and John Dramani Mahama sign peace deal
  20. "I don talk say we believe in elections, and I dey happy to accept de verdict of de people of Ghana", President Nana Akufo Addo

    Ghana Elections 2020

    I don talk say we believe in elections, and I dey happy to accept de verdict of de people of Ghana.

    Na de commitment of President Nana Akufo Addo after en sign peace deal wit John Mahama on Friday.