See everitin wey happun during Ghana 2020 Elections

Ghana election 2020 latest news from BBC Pidgin as Ghanaians dey go to polls on Monday 7 December.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Princess Igho Williams

  1. Dis na how de voting dey waka for Presby primary school Bantam constituency, Kumasi

    Wetin we call dis Video, DVoting for Presby primary school Bantam constituency, Kumasi.

    Short video of how de voting dey waka for for Presby primary school Bantam constituency, Kumasi.

  2. Voters plenty for Methodist Junior high school, abrepo constituency for Kumasi

    Ghana Election

    Plenti voters don show for Methodist Junior high school, abrepo constituency for Kumasi.

    De electoral officers dey make ready for de election to start for 7am

    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
  3. Video of how electoral officers plus voters dey make ready for Volta region

    Wetin we call dis Video, How electoral officers plus voters dey make ready de election

    Video show how electoral officers plus voters dey make ready for de Adidome old district assembly polling station for Central Tongu, Volta region.

  4. Voters dey check name if e dey regiister

    Ghana Election

    Voters for Presby school Bantama dey check name if e dey regiister.

    Meanwhile Ghana Electoral Commission don bin talk say register voters wey their Voter ID Card dey miss still fit vote today.

    Di electoral commission say make them just go de polling station wey them register and mention their name to de officers wey go then look for de name.

    Ghana Election
    Ghana election
  5. Electoral officers for kumasi dey set up for voters

    Ghana Election

    Electoral officers dey set up for Presby primary school Bantam constituency., Kumasi. Voters don also dey for queue

    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
    Ghana Election
  6. Ghanaian voters turnout as early as 2:00am on 7 December election day

  7. Okada bikes use to distribute election material

    Ghana Elections

    Okada bikes dey distribute electoral materials for Central Tongu district for Volta region.

    Ghana Election

    Wia dis foto come from, bbc

  8. Ghana Election

    Wia dis foto come from, bbc

    Dis Ghanaian voter, Kwame Azamati carry en own chair from house, put am for head to de polling station for en wife sake of he dey anticipate say de day go be long.

    De Ghana electoral commission dey expect voting to end by 5PM but even say Kwame Azamati come de polling center early, he no want take chaces.

  9. Meet de ‘three wise women’ who form queue since 2.00am

    Ghana Election

    Three middle aged women for Ghana colonize de Manet court 2 polling station, Ledzokuku Constituency after dem come form queue as early as 2.00am.

    Aunty Mary den two other mothers say dem leave house at dawn to de polling station sake of dem wan be de first to vote.

    “We leave our little kiddies for house o, wey we come dey here dey wait since 2.00am. We just want be de first to vote today” Aunty Mary talk BBC Pidgin.

    17 million Ghanaians dey go de polls today to cast dema ballot to elect new president den 275 parliamentarians.

    Ghana election
  10. Ghana election

    Early voters start dey form queues for Ledzokuku Constituency, Accra on Election Day.

    Some voters come sleep de polling station in hopes say dem go be first to vote.

    Ghana Election

    Wia dis foto come from, bbc

    Ghana Election

    Electoral Officers start dey set up polling stations for voting which dey start 7.00am.

    Ghana Election
  11. More than 17 million Ghanaians dey expected to vote today

    Ghana Elections

    More than 17 million Ghanaians dey expected to vote today as de country dey elect a new president and members of parliament.

    De elections go hold for more than 38,000 polling stations across de 16 regions of Ghana.

    Jean Mensa, de woman wey dey organize dis election don warn say make political parties and media houses avoid to declare any results.

    De Chairperson of Ghana Electoral Commission say na only dem get right to announce results according to di law.

    Our man Favour Nunoo wey dey for one of de polling stations dis morning say:

    "Voters come out as early as 2:00am for today Ghana Elections"

    Meanwhile Ghana President, Nana Akufo-Addo address im kontri last night ahead of today election.

    Akufo-Addo say make people no allow Covid -19 stop dem from coming out to vote and say security agents go deal with offenders no matter dia political colour.

    Ghana electoral body say na within 24 hours. Just follow BBCPidgin website and Facebook page to get di result.

  12. Una Welcome to Ghana Election day!

    Ghana election

    Una good morning and welcome to de live coverage of Ghana presidential and Parliamentary elections.

    275 parliamentary wey dey candidates dey contest for different constituency.

    We go dey update una as de election dey waka.

    Ghana EC

    Wia dis foto come from, Ghana EC

    Here na de guidelines of how de voting process supose be.

    Ghana election

    Wia dis foto come from, Ghana EC

  13. See what Ghana Prez Akufo-Addo talk Ghanaians ahead of Monday elections

  14. History of Ghana, de land of Yellow, Brown, den Black Gold

  15. , .

  16. Why some voters for Oti Region no go vote fit vote in parliamentary elections

    Some voters for de Guan District wey dey Oti Region no go participate in parliamentary elections, Ghana EC reveal.

    Electoral Commission for statement inside explain say sake of de creation of Guan District Local Assembly and pending creation of de Guan constituency, voters for Guan District go vote only in de Presidential Election but not de Parliamentary Election.

    Residents of de Guan District, Oti Region ask Electoral Commission (EC) say dem for come clear on whether dem go participate in de parliamentary election or not.

    In de EC response, dem talk residents to take note say dem just go vote in de Presidential election on December 7.

    Ghana Elections 2020

    Wia dis foto come from, Ghana EC

  17. Stay away from declaring 7 Dec. election results - Ghana EC warn political parties, Ghana Electoral Commission explain how Monday election go be

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin

    Let de citizen know' press briefing wey Ghana EC do ahead of tomorrow election don start.

    Before dem start de press conference, dem do singing of praise and prayers to commit tomorrow election inside God hand.

    An account of wetin dem don do for de peaceful and credibly election. Procurement of logics: things to use for de election.

    38,622 polling station in de country and distributed two weeks before de election to improve de overall quality of de election.

    Stringent safety protocols: they were able to test it during de special voting exercise.

    De Ghana Electoral commission chairperson, Jean Mensa say dem dey confident about wetin dem don do for ground before de election.

    For de first time in history all first officer sign to abide by the code of conduct of de EC.

    Feedback from De recent special voting indicates that de voting equipment function effectively.

    Last week de commission made registered voters available so far voters go fit check dia names. 38,622 polling station 10,000 more than de 2016 polling station.

    Call center: for prompt feedback back on issues. De no is 0800100100 from 6am to 7pm no charges involved.

    De only aspects of de election process wey don change na De efficiency wey dem build in dem.

    De commission go received result from de 16 collation center not as dem bin dey do am before.

    No electronic transmissions but photo of result scan to de commission.

    By law EC is de only one to declare de result.

    De EC caution political parties, stakeholders to remain patients.

    I pledge to remain true to our Moto and operate with fairness and integrit, de EC Chairperson tok.

    De result that would be delivered will reflect de will of de people only.

    87.8 percent turnout from de special voting and de EC de expect higher turnout tomorrow.

    De intention to declare results in 24 hours is not cast in stone. But we are doing it with one thing in mind, if you do have de results why keep it.

    why hold de nation on ransom If for one reason or de other we are not able to achieve it we are not falling short of de law.

    Wetin we call dis Video, Ghana Electoral Commission [EC] chairperson Jean Mensa on 2020 election results
  18. How to cast your vote during Ghana 2020 election

  19. See how election be conducted in Ghana & important facts about election 2020

  20. “Make nobody fear to come out and cast dema vote”, Ashanti Police spokesperson Godwin Ahianyo

    ASP Godwin Ahianyo

    Ghana Police Service don dey ready for de election wey dey happun on Monday 7 December, 2020.

    ASP Godwin Ahianyo,Police Public Relations Officer for de Ashanti Region talk BBC Pidgin today say dem dey consider every polling station as a flashpoint.

    So everything dey in place to make sure security tight well for every polling unit.

    “As de election dey go on, where we see say problem dey, we go send our men there”.

    He tok say make nobody fear to come out come cast dema vote, he say dem go ensure everybody wey dey eligible to vote no go experience any form of intimidation.