Ekiti govnorship election 2022 as e happun

Residents of Ekiti state vote for who go govern dem for di next four years.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Ekiti decides 2022 key numbers

    Ado Ekiti, Ekiti capital

    Di Independent National Electoral Commission, Inec say di number of registered voters for Ekiti state na 988,923.

    See details below of di key numbers wey go determine who become di next govnor of Ekiti.

    • Number of pipo wey don collect PVC - 734, 746
    • Number of polling units - 2,455
    • Number of wards - 177
    • Number of local goment - 16
    • Number of candidates - 16
  2. Meet di candidates

    Di candidates

    Wia dis foto come from, Collage

    Unlike oda elections for Ekiti state, dis year own go different becos no be di two main parties for Nigeria - Peoples Democratic Party (PDP) and All Progressives Congress (APC) get candidates wey pipo dey tok about - oda parties da candidates too dey di race.

    In short, di election no go be two horse race. Di emergence of Dr Wole Oluyede of di African Democratic Congress (ADC), former Governor Segun Oni of Social Democratic Party (SDP) and Chief Reuben Famuyibo of Accord don expand di contest.

    However, na sixteen parties dey contest dis election but sake of how pipo fit vote based on popularity and oda factors we go reduce di number of di main contenders to four.

    Di four na; Biodun Oyebanji, Debo Ajayi, Bisi Kolawole and former govnor Segun Oni.

  3. Political parties end campaign ahead of Saturday election

    APC round up dia own campaign on Tuesday

    Wia dis foto come from, BOA

    Political parties don conclude dia campaigns ahead of di governorship election for Ekiti state on Saturday.

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) put Thursday midnight as final day for campaign - di na according to dia guideline.

    Di All progressives congress (APC) and Social Democratic party (SDP) hold dia final rallies on Wednesday and Thursday to beat Inec deadline - Peoples Democratic party (PDP) continue wit dia street to street campaign wey also end on Thursday.

    SDP candidate Segun Oni na one of di leading candidates for di election

    Wia dis foto come from, SDP

    Di Ekiti governorship election on Saturday go start from 8am (Nigerian time) - according to Inec dem dey use di Bimodial voter accreditation system (Bvas) wey go allow pipo to accredit and vote at di same time.

    PDP no do mega rally but dem continue wit dia street to street campaign wey end on Thursday

    Wia dis foto come from, PDP

  4. Ekiti residents tok wetin dem expect from new govnor

    For dis interview we run for di streets of Ado Ekiti, Ekiti capital, some residents tok about wetin dem expect from dia new leader.

    Wetin we call dis Video, Ekiti governorship election 2022: Residents tok wetin dem expect from new govnor
  5. Police show dem sef ahead of Saturday election

    Soldiers join police and oda security agencies for di show of force
    Wetin we call dis foto, Soldiers join police and oda security agencies for di show of force

    Police don come out to show dia strength for wetin dem call 'Show of force' ahead of di Ekiti state governorship election tomorrow Saturday.

    'Show of force' na part of police routine to remind pipo wey get plan to cause kasala for di election to change dia mind.

    Na Deputy Inspector General of Police, DIG Johnson Kokumo dey oversee di election.

    Di police patrol happun for Ado-Ekiti, di Ekiti state capital and oda neighbouring towns for di state.

    Remember say di Inspector-General of Police, Usman Alkali bin announce di deployment of 31 senior officers go Ekiti for di election - dis na besides di thousands of police personnel dem deploy for di election.

    On Thursday, DIG Kokumo say di number of officers and personnel no be to make pipo fear but to give dem confidence to come out come vote.

    E also say sojas go dey for borders of communities "to prevent any form of intruders and we go withdraw all policemen wey attached to VIP go return to base."

    Soldiers join police and oda security agencies for di show of force
    Soldiers join police and oda security agencies for di show of force
    Soldiers join police and oda security agencies for di show of force
    Soldiers join police and oda security agencies for di show of force
  6. Ekiti decides 2022

    INEC banner

    Residents of Ekiti state dey prepare to go to di polls to elect new govnor wey go take charge of di affairs of di state for di next four years.

    Di election go happun on Saturday 18 June, 2022, for di South West Nigerian state - e go be di seventh time since di kontri return to democracy in 1999 and since di creation of di state for October 1, 1996 under di military rule of General Sani Abacha wey di election go take place.

    Ekiti state no dey elect dia govnor wen most states for di kontri dey do and dis na sake of one electoral palava wey happun for 2009.

  7. Una good afternoon!

    Welcome to our live coverage of di Ekiti election wey go happun on Saturday, di 18th of June, 2022.

    Na here we go bring una all di tori as e dey happun live starting from today before di election proper tomorrow

    Make you stay with us.