Breakdown of Irepodun/Ifelodun local goment area
For dis local goment area, APC win 13125 otes, SDP take 5010 while PDP get 4712 votes.

Residents of Ekiti state vote for who go govern dem for di next four years.
Helen Oyibo and Victor Ezeama
For dis local goment area, APC win 13125 otes, SDP take 5010 while PDP get 4712 votes.

APC win Irepodu/Ifelodun local goment area for di results Inec announce.

For Ekiti West, APC floor di oda arties with 15322 votes.
APC win Ekiti West local goment area wit 15322 votes.
PDP beat APC for Efon local goment area wit 6303 votes.
APC get 4012 while SDP get 339.

PDP don win dia first local goment area inside di ones officials don declare so far.
PDP win Efon with 6303 votes.
For Moba, APC take di lead, SDP follow and den PDP.

APC again don win Moba local goment area.

For Ilejemeje, APC get 4357 votes while SDP get 2344.
APC win Ilejemeje local goment area wit 4357 votes.

See di breakdown for Ikere local goment.
For hia, APC come first, PDP second while ADC na third with 3764 votes before SDP wey score 1943.
APC win Ikere local goment area.
APC win Ekiti south west local goment area wit 9679 votes while SDP get 4577 votes.

APC don win Ekiti Southwest local goment area.

APC win Emure local goment area.
SDP come second while PDP come third.
APC don win Emure local goment area.

See di breakdown for Ijero local goment.
APC win SDP second and PDP third.
APC don win Ijero local goment area.

Before we continue just to remind una about some key numbers wey go determine di result.
Di Independent National Electoral Commission, Inec say di number of registered voters for Ekiti state na 988,923.

Evri don set for Inec to begin declare results.
First dem go announce di result local goment by local goment dem finally declare di winner of di election.
According to Inec, candidate for a contested election to di office of govnor go dey declared winner if e get: