Ekiti govnorship election 2022 as e happun

Residents of Ekiti state vote for who go govern dem for di next four years.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. How election dey happun for Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti

    Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti

    More fotos of how di Ekiti govnorship election dey waka.

    Dis fotos na from Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti.

    Voting still dey happun dia.

    Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti
    Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti
    Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti
    Irona unit 13 ward 011 Ado Ekiti
  2. Breaking, APC candidate Biodun Oyebanji don vote

    APC candidate, Biodun Oyebanji don cast im vote.

    E be one of di favourites to win di election.

  3. Breaking, SDP candidate Segun Oni don cast im vote

    SDP candidate Segun Oni don cast im vote.

    E vote for Ifaki Ekiti, ward 2, unit 4.

  4. More fotos from #Ekitidecides

    more fotos from Ekiti election

    See more fotos from Ekiti state wia our tori pipo dey monitor di govnorship elections.

    Voting start around 8:30am and go end by 2:30pm.

    more fotos from Ekiti election
    more fotos from Ekiti election
    more fotos from Ekiti election
    more fotos from Ekiti election
    more fotos from Ekiti election
    more fotos from Ekiti election
  5. #EkitiDecides2022 dey trend for social media

    As pipo for Ekiti State, south west Nigeria dey decide who dia next leader go be.

    Some pipo enta enta social media to tok about di process wit #EkitiDecides2022.

    Some post fotos of how dem vote while odas tok wetin dem observe for di polling units.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2

    End of X post, 2

    Skip X post, 3

    End of X post, 3

    Skip X post, 4

    End of X post, 4

    Skip X post, 5

    End of X post, 5

    Skip X post, 6

    End of X post, 6

  6. Roads empty for Ifaki as election dey go on

    Ifaki empty road

    Wia dis foto come from, Other

    Wetin we call dis foto, Ifaki road empty

    Voting and accreditation dey also happun for Ifaki Ekiti even as di roads dey empty

    Ifaki na wia SDP candidate Segun Oni go vote.

    Sabi pipo say e be one of di top choice to become di next govnor of Ekiti.

    Meanwhile for Ward 2, unit 4, di voting process start around 8:15am.

    Poling unit for Ifaki

    Wia dis foto come from, Other

    Wetin we call dis foto, Polling unit for Ifaki
    Polling unit for Ifaki
  7. Video: Ekiti voters protest against alleged 'See and Buy'

    Some residents protest against wetin dem call 'See and Buy' for Ward 11, Oke-Oriomi polling Unit 9 and 16 for Ado - Ekiti.

    Watch for di facebook link below.

  8. Traders continue business inside Ekiti election

    Traders shade dia market during Ekiti decides

    As election dey happun trading activities dey go on for some markets for Ekiti state.

    Market women gada for Esa Oke market for Ado-Ekiti dey do dia business.

    "Dis dia election no go give me food. If I no sell today my children go hungry," one market woman tell BBC Pigdin.

    Apart from some women wey dey sell for market, some oda street trading dey also go on.

    Traders shade dia market during Ekiti decides

    Most of di street traders na food vendors wey dey sell food mostly for voters.

    Traders shade dia market during Ekiti decides
  9. Meet di major contenders for Ekiti govnorship election 2022

  10. Foto from polling units for Ekiti Decides

    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti.

    See some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti.

    While di turn out dey high for some locations, pipo no too come out for some places.

    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti.

    But accreditation and election start for most polling units according to Inec guideline for di election.

    Di Inec adhoc staff dem use di Bvas machine for di accreditation of voters.

    See more fotos below.

    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti.
    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti.
    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti
    Some foto of how di governorship election activity dey go for Ekiti
  11. First pesin to vote!

    First voter for polling unit 2 for ward 6 Ado Ekiti
    Wetin we call dis foto, First voter for polling unit 2 for ward 6 Ado Ekiti

    Accreditation and voting don start for some polling units for di Ekiti governorship election.

    Di process start at exactly 8:30am for polling units 2,3 and 4 for ward 6 Oke-Inyimi for Ado-Ado Ekiti.

    Owolabi comfort na di first pesin to vote for unit two.

    Inec officials dey use di Bimodal Voter Accreditation system (Bvas) dey do di accreditation and voting at di same time.

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) bin introduce di Bvas machine during di November 18, 2021 governorship election for Anambra state.

    For Ekiti, di commission say di Bvas machine go work well as dem don upgrade am.

    Voting don start for Ado
  12. Watch: Ekiti residents dey vote for govnorship election

    Voting don officially begin for di Ekiti govnorship election.

    Watch how e happun for Okeyinmi ward 6 unit 2, Ado Ekiti.

  13. Breaking, Voting don start

    Voting don officially start for di Ekiti govnorship election 2022.

    Inec say voting go start by 8:30am and end by 2:30pm.

  14. Accreditation go start by 8:30am - Inec

    Di Independent National Electoral Commission, Inec, wey dey in charge of di process of di election say accreditation and voting go start by 8:30am and close by 2:30pm.

    But anybody wey join di queue before 2:30pm go still dey allowed to vote.

    Check out more from Inec about di process from dia Tweet below.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. Inec officials arrive early for polling units

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Some residents of Ekiti state don come out position for dia polling units to participate for governorship election wet dey happun today.

    As at 7:15am adhoc officials of di Independent National Electoral Commission (Inec) don arrive most polling units for Ado-Ekiti, di state capital dey set up.

    Dis na afta Inec don conclude distribution of materials from di Residential area centres (Rac) centres as as early as 3am.

    Di voters for most polling units dey happy say di Inec officials wey be serving Youth corps members arrive on time.

  16. Voting never start..., ...But voters don dey come out

    Pio dey wait to vote

    Voting never start but some voters don already dey polling unit dey wait for Inec officials.

    Pipo dey wait to vote

    Voting go officially start by 8:00am.

    Pipo dey wait to vote
    Wetin we call dis foto, Pipo dey wait to vote
  17. Wetin you need to know in sharp points

    Ado Ekiti capital

    Di residents of Ekiti state dey head to di poll to vote who go govern dem for di next four years.

    See key points you need to know.

    • Di govnorship election for Ekiti state dey hold on 18 June, 2022
    • Na 16 candidates dey contest for di state top seat
    • Sabi pipo say di race go dey between di APC, PDP and SDP party dia candidates
    • Police IGP announce say dem deploy 31 senior officers go Ekiti for di election
    • Thousands of police personnel dey ground to maintain peace and order
    • Voting process go start by 8:00am
  18. Una good morning!

    Welcome to Ekiti Decide 2022.

    Di pipo of Ekiti state for south west Nigeria dey go to di polls to decide who go lead dem for di next four years today.

    Dis na wia we go bring una all di updates LIVE as e dey happun.

    Stay with us!

  19. Una bye-bye!

    Inec Ad Hoc staff dey move materials

    Na here we go march break on our coverage of di Ekiti state govnorship election today.

    We go leave una wit dis pictures from di Residential area centres (Rac) centres as INEC ad hoc staff dey deploy for di elections.

    Make you join us again by 7:00am on Saturday for our election live coverage.

    Good night!

    Inec Ad Hoc staff dey move materials
    Inec Ad Hoc staff dey move materials
    Pipo dey check dia names for list
  20. INEC dey do final movement of materials to LGAs, So far Ekiti state dey calm

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    INEC RAC centre
    Wetin we call dis foto, INEC election materials

    Inec don begin final movement of election materials and adhoc staff to dia various RAC centres.

    Our reporter sight over 50 chattered local buses wey dey move ballot boxes, registers and oda election materials from di SUBEB RAC centre for Okesha axis.

    Security officers dey escort each bus wey dey move out to di LGAs.

    So far, Ekiti state dey calm. We no witness any form of violence.

    Security teams been do show of force parade earlier in di day ahead of tomorrow election.

    Accreditation and voting dey expected to start by 8:30 am Saturday morning

    Election materials
    Wetin we call dis foto, Election materials