Wetin be di latest for di election?

Wia dis foto come from, Getty Images
E don pass 24 hours since election polls first open for United States and about 12 hours since e close. And till now we still neva sabi who di next president go be.
Dis no be suprise as di kontri dey count many postal votes dis year pass before sake of coronavirus pandemic.
Votes from post office dey take longer to count, and e dey very normal for pipo to continue voting for some days for US.
Dis na wia we dey so far:
- Di contest don gradually dey reduce to just some few states - Pennsylvania, Wisconsin and Michigan - wia di results still dey enta small small.
- Michigan election chief say dem still get about 100,000 votes to count.
- Winconsin say dem don count all di votes and now dem dey triple check dia maths.
- Georgia get around 200,000 more ballot to count.
- Across di kontri, millions of votes still remain to count
- Di two camps say dem dey confident say dem go win.
- Biden dey expect to tok to tori pipo later today about di election. Trump no get any official event.








