See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

America president elect Joe Biden don promise to unify di kontri afta im win Donald Trump for election

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Meet di Nigerians wey win US elections to become lawmakers

  2. Breakdown of wetin di candidates need to win

    Di race dey tight.

    Even as e dey look more like everything dey blue for Democrat candidate Joe Biden, Republican, Donald Trump still get chance to make tins red if e win some of di key states wey remain.

    See di breakdown of wetin each candidate go need.

    Graphics of how di candidates fit win
  3. Trump still fit win di White House race? - See di mathematics here

  4. In case you just dey join us...

    Wetin be di latest ontop di US presidential election?

    • Republican President Donald Trump don again make unverified claims of electoral fraud as im lead for di battleground states of Georgia and Pennsylvania continue to dey reduce during di counting of postal votes.
    • Im democratic rival Joe Biden don appeal for calm and again express confidence say dem go declare am di winner.
    • Counting still dey go on for di five key states of Pennsylvania, Nevada, Arizona, Georgia and North Carolina wia winner never still come out.
    • Win for just Pennsylvania or two of di oda four remaining states suppose dey enough to confam Mr Biden president-elect.
    • Mr Trump need to win Pennsylvania and three of di remaining four states.
  5. Facebook don remove one group wey dey call for 'civil war' on top di election

    Stop di steal group foto

    Wia dis foto come from, Facebook

    Facebook don remove one big viral group wey dey spread tori witout prove, dey claim say di Democratic Party dey try "steal" di election.

    Among di comments inside di group na di one wey dey threaten violence plus call for civil war and revolution.

    Facebook tok tok pesin say, dem take di action becos di gorup "call for violence dey worry" and "fit create real world events."

    Na yesterday dem set up di "Stop di Steal" group wit more dan 330,000 members before dem remove am.

  6. Michigan judge don dismiss Trump request to stop counting

    One judge for Michigan don dismiss Trump campaign court case to stop counting postal ballots for di state.

    Judge Cynthia Stephens of di state first district appeals court say, di campaign no cari dia case come court on time - dem come just some hours before di counting end - and dem cari di wrong pesin (di secretary of state) go court.

    Di secretary no get any control ova di local counting process, na so di judge tok.

    Di presidential campaign bin dey argue make dem stop counting until Republican election observers fit observe di counting process.

  7. Wisconsin don turn blue again

    Our election map don change to reflect di BBC projection say Biden go take Wisconsin.

    Dis one give Biden 253 electoral vote against oga Trump 214.

    Im need to reach 270 votes to become di next US president.

    Election projection map
  8. How to read BBC results

    BBC don dey show now say Joe Biden fit take Wisconsin according to wetin out sister network CBS dey report.

    Wit 99% of di vote count, Bden dey currently lead wit just ova 20,000 votes against Trump.

    Di counting wey we just post now include di state 10 electoral college votes. Our results maps sha no show Wisconsin for Biden.

    Dis na becos di informate on data wey Reuters dey supply us na from Edison Research, wey dey do field work for exit polls and work for US networks.

    Edison Research neva tok wetin di Wisconsin result be becos di margin between Trump and Bden dey less dan 1% point. Dis mean say di candidate fit to request make dem count am again.

    You fit don notice say some news sites dey also project say Biden go win Arizona, dat go give am extral 11 electoral college votes.

    Di BBC, again, according to wetin CBS dey report, feel say e dey early to project.

    Wit 86% of di vote for Arizona wey dem don already count, Biden dey lead wit 68,000 votes ova Trump.

  9. Biden fit win Wisconsin

    Biden fit win Wisconsin

    Democrat Joe Biden fit win Wisconsin.

    Di state give di former vice-president 10 electoral votes and extend im lead over President Trump.

  10. Ballot paper ‘wey dem burn’na just samples

    Sample ballot wey dem burn

    President Trump and im supporters don continue to dey raise suspicion say magu magu done enta di vote counting.

    One viral video wey oga Trump pikin, Eric, bin share show wia dem pack around 80 ballot put inside bag, pour am kerosine abi na fuel, burn am.

    But officials for di city of Virginia Beach – for di state of Virginia – wey im mayor na member of di Republican Party, release statement on election day to explain say di ballot wey dem show for di video na just samples.

    Di city say fire investigators dey look into di mata as “illegal burning.”

    Even wit di statement wey di officials release, Eric Trump share di video on Twitter, wia pipo like am, share am and comment almost 100,000 times.

    Di account wey dem use do di post, Twitter don suspend am. Im don post am for imYouTube page but YouTube neva do anytin.

  11. Trump tweet ‘stop di count’ as result counting don almost reach end

    As we dey almost reach di end of di election result counting, President Donald Trump don post for Twitter make dem “STOP DI COUNT.”

    For im speech on Wednesday, Trump describe di election as “fraud on di American public” though no evidence dey to show say di election system na fraud.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  12. Republicans go cari Nevada go court on top claim of 'voter fraud'

    Di Republican Party wey dey Nevada, don confam plan to cari Nevada go court on top claim say around 10,000 pipo wey no dey live for di state again cast vote.

    Nevada na one of di many states wey send postal ballot give every adult wey register to vote.

    Trump bin protest against di decision to use di “universal mail-in ballot” system during im campaign, claiming say e go lead to fraud.

    Even though Trump don continue to claim say fraud dey, e neva get any evidence of any big voter fraud for any major US election.

    Dis na di number four state wey di Republicans dey go court to challenge dia vote.

    Dem dey also ask for di number five state Wisconsin, to recount dia vote.

  13. Philadelphia go soon release update of vote count

    In some minutes we dey expect di Philadelphia City Commissioners to give us update for di vote count wey still dey happun for di state.

    Trump lead for di swing state of Philadelphia,wia im win for 2016 dey drop as dem dey count postal votes.

    Trump dey currently lead wit around 160,000 votes, but Philadelphia election officials say, im vote dey drop as Biden dey gain more votes.

  14. 'Angels from Africa dey come to help Trump win'- presidential spiritual adviser, Paula White

  15. Why different news sites dey report different figures?

    If you dey see different top of the live coverage from various news sites, you fit dey confused.

    Dis na because some news sites dey project wins for Arizona (meaning extra 11 electoral college votes) and Wisconsin (10 electoral college votes) for Biden.

    BBC still consider say e dey too early to project.

    Dis year, BBC get dia data through Reuters, from polling firm Edison Research, wey do di field work for di exit polls and work with US networks for di National Election Pool.

    For Wisconsin, 99% of di votes na im dem don count, and di candidates dey bumper too bumper.

    For Arizona, 85% of votes na im dem don count, and Biden dey lead with 51% of di votes, while Trump dey on 48%.

  16. Wetin don happun so far?

    Biden and Trump graphics

    Donald Trump and Joe Biden dey claim say dem dey lead for di US presidential election, even as di final outcome never clear and both sides dey ready for legal action.

    Trump campaign dey challenge vote counts for di key states of Wisconsin, Georgia, Pennsylvania and Michigan.

    BBC dey project say Mr Biden win Michigan. US media forecast say e take Wisconsin. No result don come out from Pennsylvania.

    Democratic candidate Mr Biden say e dey confident say e dey on track to defeat Republican Mr Trump.

    Overall di turnout for Tuesday election dey projected to be di highest in 120 years at 66.9%, according to di US Election Project.

    Mr Biden get di support of 70.5 million voters, di most wey any presidential candidate ever win. Mr Trump don pull in 67.2 million votes, four million more dan e gain for 2016.

  17. Una good morning!

    In case you just dey join us, dis na still BBC Pidgin live coverage of di US Elections 2020.

  18. What to know about di electoral college wey dey decide who become US president

  19. Pennsylvania “find 13 ballot boxes” afta court order make dem search post office dem

    Seucrity agent stand wit ballot box

    Wia dis foto come from, Reuters

    Pennsylvania election officials say dem find 13 ballot boxes for di processing facility wen dem dey do last minute search of di post offices for di state.

    Yesterday, Federal judge Emmet Sullivan bin give order to do inspection for about 12 states.

    Im decision dey come afta US Post Office say dem receive about 300,000 mail ballot but dem no fit trace wia dem go for di election office.

    Dis dey come afta civil right groups sue di post office say dem deliberately delaying shipment to sabotage di postal voting to help republicans.

    Postal inspectors bin get till yesterday to complete di search for 12 postal districts wey dey for Arizona, Florida, Georgia, Texas and Wisconsin.

    Post office officials tok yesterday say dem no go fit complete di search by di end of today becos e go interfere wit normal election activities.

    Judge Sullivan don set anoda court hearing for Wednesday, to “discuss lack of compliance.

  20. Trump campaign wan request make Winconsin recount votes

    Di Trump campaign say dem go make request make dem count di vote for di battleground of Winconsin again.

    For statement wey di campaign manager, Bill Stepien, release, dem say: "Winconsin na razor thin race.

    "Reports dey of irregular votes for many Winconsin counties and dis raise serious doubt about how valid di result dey.

    "Di President dey within di law to request make dem recount am if di winning margin dey 1% or less.

    Earlier, Winconsin election officials say counting dey go very well.

    If dem count di votes again, e go drag tins down small, but dis no be di first time wey recounting dey happun. According to Winconsin law, dem must to finish recounting within 13 days of di request.