See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

America president elect Joe Biden don promise to unify di kontri afta im win Donald Trump for election

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Report say Biden dey step up transition plans

    Biden

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Report say Joe Biden team dey step up dia plans for transition to di presidency as e draw closer to victory.

    According to New York Times report, dem fit name am next week.

    Debates don dey take place inside Washington and Wilmington, Delaware (where Biden dey stay) ova who go fill di senior roles.

    Biden fit assemble di most diverse cabinet for US history, di paper reports. "Men, women, gay, straight, center, across di board, Black, white, Asian," Biden tok wen iim dey tok about im future cabinet early dis year.

    "E really matter say you look like d kontri, because everyone brings slightly different perspective."

  2. 'Di struggle 'just begun'- Bernie Sanders

    Sanders

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Former presidential hopeful Bernie Sanders don record one message to hail Joe Biden as im dey lead for di race to di White House.

    For di video wey e post for Twitter, Sanders tok say di election na about weda "we end pathological lying inside di White House" or "retain democracy and di rule of law inside our kontri - and thank God, say be like say we don do am".

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    "Tonight, as we celebrate Joe Biden as e dey lead for di election, we understand say our struggle neva dey over," e tok . "E just begin."

    According to BBC tally, Biden don reach 253 of the 270 electoral college votes wey im need to win. While dem neva announce any final result, e also appears to dey ahead of di remaining swing states.

  3. We still no know who be di next US president

    Trump and Biden

    You fit dey surprise to see say we all still dey wait to get confam winner from di US presidential election wey dem do November 3rd.

    Vote counting continue to dey slowly but di trend show say Democratic candidate Joe Biden na im dey do better than President Donald Trump.

    Na just 17 electoral college votes dey separate Biden from di 270 wey e need to win di White House.

    For one speech on Friday night, Biden tok say im dey set to win di election "with clear majority, with di nation behind us".

    E advise pipo for di kontri to "put anger and demonisation behind us. We fit be opponents, but we no be enemies"

    Biden dey ahead of Trump for di remaining battleground states, wey be key to victory:

    Pennsylvania, wia Biden currently dey lead by 28,883 ballots, get di largest number of electoral college votes of any of di remaining states and winning there alone go push Biden above 270.

    Na similar gap dey also for Arizona, wia Biden dey ahead of Trump by 29,861 votes. E also dey lead for Nevada, with 22,657 votes.

    While Biden dey also in front for Georgia, di margin dey thin - with just ova 4,395 votes separating di two candidates. Officials dia don tok say dem go recount.

    President Donald Trump no appear for public on Friday but e warn Biden for Twitter not to claim victory, e say legal proceedings don begin.

  4. Who be King Von, American rapper wey die for shooting - See wetin happun

  5. Joe Biden say im go win di US presidential election

    Democratic challenger Joe Biden

    Wia dis foto come from, Reuters

    Democratic challenger Joe Biden say millions of Americans don vote for change and him go win di US presidential election.

    For one brief speech for im campaign headquarters inside Delaware,oga Biden tok say im get clear and convincing lead for key swing states where dem dey count di final ballots.

    Im stand alongside im running mate, Kamala Harris, di Democratic Party candidate say dem don brief am on di coronavirus pandemic.

    E say im go put plan into action on day one to control di virus.

  6. US election 2020: Wetin dey delay di results?

  7. President Donald Trump don release statement

    Donald Trump speak to reporters on Thursday

    Wia dis foto come from, Reuters

    President Donald Trump team don put out a statement, say “di American people deserve to get full transparency into all vote counting and election certification".

    "Dis no dey about any single election. Dis na about di integrity of our entire election process," di statement tok.

    Di statement accuse Democrats say dem dey resist "basic principle" wey say "all legal ballots must be counted and say make dem no count all illegal ballots", and e tok say Trump go "pursue dis process through every aspect of di law".

    "I no go ever give up fighting for you and our nation," e tok for di statement

    Trump don suggest say counting postal votes wey arrive afta election "no follow law".

  8. Breaking, Georgia go recount US presidential election votes

    Georgia Secretary of State Brad Raffensberger just announce say dem go recount di presidential votes for di state.

    Im say dem neva count 4,169 vote, and say some 8,000 military absentee ballots still dey for mail and dem go only count dem if dem arrive by di end of di day.

    "Right now Georgia remain too close to call," he tok say: "With a margin wey small like dat we go recount for Georgia."

    "Interest in our election go far pass Georgia's borders. Di final tally for Georgia at this point get huge implications for di entire country."

    "We dey look at a margin less dan a large high school," Raffensberger aide Gabriel Sterling add am afta di Republican official comot without taking questions.

    Sterling, wey dey oversee voting for di state, add am say di reason for di recount na due to how close di race be, and say dem neva see "any widespread irregularities" wey fit indicate foul play.

  9. Biden don dey lead for Pennsylvania- see why e dey important

    Trump and Biden supporters for  Philadelphia

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Latest tori be say Democrats president candidate, Joe Biden don dey lead di polls for Pennsylvania.

    If Biden take di state im go get 273 votes, wey fit hand am di presidency.

    We don hear say e dey lead wit some 98% percent of di votes wey dem don count.

    Di Trump campaign don try to shut down vote counting for dia but di federal judge block di move.

    With 20 Electoral College votes, Pennsylvania don always be di major political background. Di state bin don dey vote di Democrats for six presidential election in di past but change to vote for Trump for 2016.

  10. Trump election fraud claims- See di real truth behind am

  11. Who dey lead for states wia dem still dey count?

  12. Pipo vex as Former US official say Trump dey behave like Mugabe

    President Donald Trump

    Wia dis foto come from, AFP

    Some pipo for Twitter don para ontop one tweet from one former US official wia she dey compare President Donald Trump to Zimbabwe's late leader Robert Mugabe, afta im comment about fraud, without evidence, for di US election.

    Samantha Power, wey serve as di UN ambassador under President Barack Obama, tweet say Oga Trump dey "go full Robert Mugabe".

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Ms Power send her tweet minutes afta Oga Trump hold one press brief on Thursday, wia e blame im chances for re-election on votes wey dem cast illegally.

    But some Africans on Twitter say di comparison na one way of Americans pointing fingers at odas instead make dem focus on di problem for dia own kontri.

    See some of di Tweets

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Skip X post, 3
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 3

    Skip X post, 4
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 4

  13. Joe Biden na winner of US presidential election 2020

  14. Who dey lead for states wia dem still dey count?

    Dem still dey count votes for four key states and dat na Georgia, Arizona, Nevada and Pennsylvania.

    Dis states get 53 electoral votes between dem.

    Georgia - 16 electoral votesJoe biden don tip di scales for Georgia as e don dey lead with 917 votes as dem don count 99% of votes for di state.

    Pennsylvania - 20 electoral votes

    Trump lead against Biden don reduce from 500,000 votes to 23,000 votes with about 200,000 votes wey dem neva count.

    Graphics for Pensylvania

    Arizona - 11 electoral votes

    While Biden dey lead for dis state, Trump don dey near am small-small through out di day, although e neva clear how many votes remain to count.

    Arizona election graphics

    Nevada - 6 electoral votes

    Biden dey lead for di state of Nevada by 12, 000 votes and di numbers don rise on Thursday as new counting dey enta.

    Howeva, officials say about 190,000 ballots remain to count.

    Nevada election graphics
  15. Earlier on Thursday night for New York...

    Protesters for New York wear facemasks of black lives matter and police brutality even as dem dey protest about di US election.

  16. Breaking, Joe Biden dey lead for Georgia

    For Georgia, one of di remaining key states wia dem still dey count votes, election monitors and US broadcaster CNN dey say Democrat Joe Biden don dey lead dia for di first time.

    Decision Desk say Biden dey ahead with small tin and dem say na about 99% of estimated votes dem don count dia already.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  17. Donald Trump call out Twitter as dem censor four of im tweets

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    American Presido Donald Trump don call out di social media app Twitter on top di way dem dey censor im tweet ova di election.

    Today, Twitter don censor four of di presido tweet say e dey misleading about di elections.

    Wetin e mean be say dem hide di tweet with misleading message but you go fit view am if you click view, however, you no go fit share am or comment.

    See summary of wetin e tok for di ones dem hide:

    • Wia e tok say dem no let observers do dia work
    • Video wia im accuse Democrats say dem go court to ban observers
    • Anoda video news report wia im say im no go allow corruption to steal di election
    • Wia im tok say with legal votes, im win but illegal votes dey try to steal di election.
  18. Protesters enta street for New York as vote counting still dey on for some states

    Even as counting of votes still dey go on for some key states for US, small-small protests dey happun for different parts of di kontri.

    For New York, some protesters enta streets.

    Dem call on voters for Georgia to check dia votes on top tori say dem don cancel about 40,000 mail-in ballots for Georgia.

    See pictures from di protest on Thursday night.

    NY Protest

    Wia dis foto come from, BBC Pidgin

    NY Protest

    Wia dis foto come from, BBC Pidgin

    NY Protest

    Wia dis foto come from, BBC Pidgin

    NY Protest

    Wia dis foto come from, BBC Pidgin

  19. 'Security go dey stepped up' for Biden

    Joe Biden

    Wia dis foto come from, Getty Images

    US secret service go boost protection for Joe Biden from Friday as dem anticipate say e fit soon claim victory for di election, according to Washington Post.

    Extra agents go dey for im place afta im campaign team tell Secret Service say e fit make major speech as early as Friday, dem report.

    Secret Service spokeswoman Catherine Milhoan no gree comment, she say di agency no discuss security arrangements for senior figures. Biden aides too never comment.

    Biden and im campaign team dey based for one convention centre for Wilmington, Delaware.

  20. Dr Stella Immanuel don release 'warrior angels' to help Trump win