How Trump dey prepare?
E dey normal for candidates to arrange mock debates for preparation, as one of di staff go act like say im na di candidate opponent.
But Trump no use dis method and instead im go make im staff show am tins dem don write for paper to use memorise during presidential trips, according to CBS News.
Trump campaign manager Tim Murtaugh tok say im oga don dey prepare “regularly when im face hostile news media” and say im work as president don already prepare am well-well to face Biden.
"You know, wetin I dey do na debate prep. Every day, I dey take questions from you people over time," Trump bin tell tori pipo on Sunday.
According to di New York Times, e tell im staff say im dey consider to attack Biden ontop im son controversial job for one Ukrainian energy company and di accusation of sexual assault from Biden former staff Tara Reade.