You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

America president elect Joe Biden don promise to unify di kontri afta im win Donald Trump for election

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Na di voters go declare di winner of dis election - Biden

    Democratic candidate Joe Biden say na di voters go declare di winner of US election.

    E say no be im place or Donald Trump to declare di winner of di election, even as authorities don begin announce di election results.

    "We feel good about wia we dey. We believe say we dey on track to win dis election" na wetin Biden tok

    So far dem don announce 40 out of 50 states results and na Biden dey lead wit 220 votes while Trump get 213.

  2. Trump go speak from di white house

    Any minute now, Donald Trump go address voters from di White House.

    E no clear wetin e go tok though e already don declare a "big WIN" for twitter.

  3. Trump don predict big win for US election

    President Donald Trump don predict big win for di ongoing US election even as dem still dey count votes for some states for di kontri.

    I go make statement tonight. Big Win! Na wetin im tweet for im official account.

    So far di him and Joe Biden still follow each oda bumper to bumper although di Democratic candidate dey ahead.

  4. Trump aide dey pray for divine intervention to secure victory

    One of President Donald Trump aide dey ask for divine intervention to secure victory for Republicans for US election.

    Kayleigh McEnany, wey be President Trump tok-tok pesin, tweet lyrics of ‘Way Maker ’, song by Sinach, ogbonge Nigerian gospel artist for her official twitter account.

    Sabi pipo for elections mata say di race to become di next president of America go dey very tight.

    Dem don declare results from 36 states out of di 50 for di kontri. And as tins stand Biden get 205 and Trump get 171.

  5. Breaking, Biden dey projected to win Minnesota

    Di Midwestern state na historically blue stronghold.

    Democrats don secure am for every presidential election in di last 60 years, except for 1972, wen Minnesotans back incumbent President Richard Nixon.

    • Breaking, Trump dey projected to win majority for Nebraska

      Trump dey projected to win di majority of di electoral votes for Nebraska, but surprise, surprise, Biden too also dey projected to pick up one of di five votes.

      Nebraska na one of two states wey split dia electoral college count, and di Democrat dey projected to seize di vote for Nebraska 2nd congressional district.

      Dis na di first flip from 2016 ontop di map. Last election, all five of Nebraska electoral votes go to Trump.

    • See as tins stand now...

    • Breaking, Trump dey projected to win Montana

      Di Treasure State don bin stronghold of di Grand Old Party since 1968, except for one single victory for Bill Clinton for 1992.

    • Breaking, Trump dey projected to win Texas

      Texas dey projected to vote for Donald Trump. Na di second largest prize for di electoral college with 38 votes.

      Republicans don hold down dis state for di last 10 elections.Trump win di state comfortably for 2016.

    • 'We dey on track to win dis election' - Biden

      "We know say dis one go go long, but who know say we go go into maybe tomorrow morning, maybe even longer!" Biden tok, as e speak from Delaware.

      "But we feel good about wia we dey. I dey here to tell you tonight we believe we dey on track to win dis election."

      E add SAY: "E no dey over until every vote, every ballot don dey counted."

      • Breaking, Trump dey projected to win Florida

        Trump dey projected to win Florida.

        Na place wey all eyes don dey all as e be large battleground state.

        Im 29 electoral votes don determine previous presidential elections.

        For 2000, just 537 votes for Florida deliver di White House to Republican George W Bush. Di state chose Donald Trump four years ago, but vote two times for Obama.

        • Latest update...

          Dem don declare 34 out of 50 states for US.

          See how Biden and Trump dey perform.

        • Kanye West vote for di first time

          American rapper, Kanye West don say e don vote for di first time in im life for di pesin wey im truly trust.

          Who you tink say e be? Na imself!

          Di 43 year old presidential aspirant announce dis one for im social media handle.

          Currently, e get 0.3% of di votes for dis election.

        • How di candidates dey perform?

          See US election result card wey show how di candidates dey perform right now.

          Trump and Biden need 270 electoral college votes to win.

        • Good morning, In case you just dey join...

          In case you just dey join us, dis na BBC Pidgin live coverage of di US election 2020.

          US dey on course for dia highest turnout in more dan a century and counting in some states no go finish on election night.

          See di summary of everi-everi wey don happun in di night till dis morning.

          • Results suggest say di race dey tight for key states including Florida, di candidates need 270 electoral college votes to win di presidency
          • Di magic number for Trump or Biden to win na 270.

          See how di candidates dey look:

          • Joe Biden dey projected to win 14 states, plus Washington DC. Di states na Vermont, Delaware, Maryland, Massachusetts, New Jersey, New York, Connecticut, Colorado, New Mexico, New Hampshire, Illinois, California, Oregon, Washington state, and Washington DC
          • Donald Trump dey projected to win 17 states. Di states are Indiana, Kentucky, Oklahoma, Tennessee, West Virginia, Arkansas, South Dakota, North Dakota, Alabama, South Carolina, Louisiana, Nebraska and Nebraska 3rd District, Utah, Missouri, Kansas, Wyoming, and Mississippi
        • Three Headlines you fit wake up to see

          National polls dey show say Democratic candidate Joe Biden dey lead but di race dey close for key battleground states.

          We chook eye inside some of di headlines wey fit comot from di election afta Tuesday, 3 November 2020. three things fit happen at the end of di election.

        • How much Trump and Biden spend on campaigns?

          Advertising na always major part of election campaigns for di US and dis year no dey different.

          Democratic nominee Joe Biden campaign don spend more dan $638m (£481m) on adverts, with im campaign wey spend almost di same amount on TV adverts alone as President Donald Trump total advertising budget of $472m (£356m).

          Dat na according to figures from Kantar/CMAG for advertising spending up until di morning of di election.

          Trump fit don dedicate $43m more to digital advertising dan im rival, but Biden outspend Trump on Facebook adverts as im encourage pipo to vote in di last week of di campaign.

          Biden don also focus im spending on di key battleground states, im outspend Trump by more dan two-to-one in Pennsylvania, Arizona and Michigan. Di figures dey even higher for Pennsylvania.

          Find out more about campaign spending for US here:

        • We bin dey live from Los Angeles...

          Our tori pesin for Los Angeles give us live updates and also take us through di election process for Los Angeles.

          He also tok to some officials and pipo.

        • Which states go decide dis election?

          As Mrs Clinton discover for 2016, di number of votes you win dey less important dan wia you win dem.

          Most states nearly always vote di same way, meaning say in reality na just small number of states wia both candidates stand di chance of winning.

          These na di places wia di election go dey won and lost and dem dey known as di battleground states.

        • 'No be who win popular vote dey must win US president election'

          Americans dey decide who go be dia new president.

          But no be American voters dey directly elect di president of di United States, but na by members of wetin dem dey call di electoral college.

          See how di system dey work.