Gbas-gbos- 'We no dey hear'!
No be small tin.
Di candidates interruption of each oda dey make am difficult foe=r dem to land and pipo to follow.
After about an hour of debate - with plenti gbas-gbos, insults between candidates - Chris Wallace beg Trump and Biden to stop, as e interrupt as dem dey shout.
"Gentleman! I hate to raise my voice, but why should I be different dan di two of you?"
E go serve di kontri better if we get fewer interruptions, he tok. Wallace tell di president say e be bigger offender dan Biden.