You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

America president elect Joe Biden don promise to unify di kontri afta im win Donald Trump for election

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. How to know who dey win tonight

    Di number of postal ballots dis year go make am hard to see who dey lead early on.

    Different states get different rules for how - and when - to count postal ballots, meaning large gaps go dey between dem in terms of reporting results.

    Some states, like Florida and Arizona, begin pre-processing ballots weeks before 3 November. Odas, like Wisconsin and Pennsylvania, no touch votes until election day, meaning e dey likely say e go dey slower to count.

    To add to di confusion, states get different deadlines for wen to accept postal ballots. Some, like Georgia, go only count ballots wey dem receive on or before 3 November, while odas, like Ohio, go count late ballots as long as dem postmark dem by 3 November.

    We sabi for sure say for some states e go take weeks to complete result, meaning e fit dey impossible to predict wen we fit officially name di president.

    Dis no be di case for past elections wen you fit set your watch to di 23:00 EST (04:00 GMT) wen West Coast polls go close. For 2008, results come right on di hour and for 2012 dem just dey 15 minutes after dat.

    Di last time around, no be until Donald Trump gbab Pennsylvania for election night - 01:35 EST (06:35 GMT) – na im dem see im victory ova Hillary.

  2. See how Trump and Biden dey spend election day

    President Trump hold five campaign rallies in four states on Monday, im return to Washington around 02:35 local time dis morning. He dey expected to spend most of Tuesday for di White House.

    Im opponent Joe Biden dey scheduled to spend election day for Scranton, Pennsylvania, im childhood home, and for di Democratic stronghold of Philadelphia.

  3. Still on di mata...

    Tori pipo dey ground for us to give us live updates as to wetin dey happun for America.

    Early on our tori pesin for Madisson Square, for New-York take us through di process.

  4. How pipo turn up

    See some fotos our tori pipo gada around New-York and Los Angeles of how pipo turn up on election day.

  5. What to know about di US election 2020

    Di Republicans na di conservative political party for US and dia candidate dis year na President Donald Trump, wey dey hope to get anoda four years for office.

    Di Democrats na di liberal political for US and dia candidate na Joe Biden, im get plenty experience for politics and serve as Barak Obama vice president for eight years.

    Di two men wey dey face each oda dey for dia 70s -Oga trump go dey 74 years by di time im start second term (if e win), while Oga Biden go be di oldest first-term president for history at 78.

  6. We throway salute!, Una welcome.

    Di time na 19:29 for Lagos, Nigeria and 13:29 for New York United States of America wia millions of Americans dey vote for who dia next president go be.

    Dis na BBC Pidgin live coverage of di election wia we go bring una live tori and informate as to how every dey go ontop di mata of who go become di next president of di United States of America.

    Una welcome!

  7. See di world leaders wey never congratulate Joe Biden

  8. Good morning!

    Na here we go march break ontop our live coverage of di first of di 2020 US presidential debates.

    No forget to scroll down for all di updates and key moments as we follow dem live.

    Bye bye!

  9. Poll: Biden (barely) win. America lose.

    Snap viewer poll by CBS News, BBC News' US partner, name Joe Biden winner of DI first, gbas-gbos 90-minute debate between di candidates.

    Of those wey vote, 48% say Biden win, while 41% say make di title go to Trump and 10%saw di night na tie.

    Commentators say di real loser na di kontri.

    Tonight' debate make 69%of voters feel annoyed, and1 9% feel pessimistic. while :31% say dem dey entertained and 17% say dem dey informed.

    • In case you miss am...

      See some of di key moments from tonight.

      • Pipo say na one of di most disorderly presidential debates for modern history, we see clashes not only between di candidates but between di president and di moderator. Chris Wallace bin get to beg for dem to stop to dey interrupt each oda and scold di president say e ignore di rules .
      • Between Biden and Trump, di biggest battles na over Covid-19, di economy, election integrity and race.
      • Biden criticise Trump pandemic response while Trump hail im economic effort and promise say e go bounce back. Biden call for Trump to release im returns while Trump say Biden dey responsible for di tax credits he use in di past.
      • Trump claim say most unrest "we dey see na from di left-wing, not the right-wing" and say e no come all out to condemn white supremacy don cause anger for social media.
      • And at di end, wen di moderator ask dem if both of dem go accept defeat concede and cal for calm, Biden saiy e go wait until di count don dey independently verified. Di president again cast doubt on mail-in voting and tell im supporters to "go into di polls and watch very carefully".
    • Who win di first debate?

        • Author, Anthony Zurcher
        • Role, BBC North America reporter

      Predictions wey come be tok say Donald Trump plan for di debate na to make Joe Biden lose im temper - and na small time after dem start, e become clear say di way im go do am na to di interrupt di former vice-president.

      Dis one cause plenty gbas-gbos to happen between di two debaters, even as Trump question if Biden dey intelligent and Biden yab Trump say im na clown, so tay e ask am to "shut up".

      To moderate dis kain debate fit be di worst job for pesin for America.

      Coronavirus questions give di president tough time - but im way out na to suggest say Biden for don make am worse.

      But Biden use 'hidden tax' to gain victory over am? E no be like so. Wen Biden accuse Trump say federal tax wey im pay no reach schoolteachers own - wey suppose be powerful attack against di president - di message no carry weight as di two turn am to shouting match.

    • More reactions from social media on di debate

      See some reactions from across Africa to di debate.

    • How pipo rate di debate? - 'Hot mess'

      Di first presidential debate don end and commentators don dey rate am.

      Words like “shit show", "train wreck" na some words wey pipo dey use.

      CNN anchor Jake Tapper say. “Dat na di worst debate I don ever see. No be even a debate. Na disgrace. And na mostly because of President Trump.”

      See some oda reactions from pipo from social media.

    • Final question...

      Di final portion of di debate tok about di election and Biden focus im answer on encouraging Americans to vote.

      “Show up and vote. You gol determine di outcome of dis election. Vote, vote, vote,” Biden said.

      Biden tok about Trump attack on voting by mail, wey di president claim say e go encourage fraud.

      Trump tok again say di widespread voting by mail for dis year elections go represent “fraud,” even though no evidence for dat.

      Di president claim say Americans fit no know di results of di election for “months,”

      Biden respond say, “He just dey afraid of counting di votes.”

    • Why Nigeria leader Buhari no show for 2019 debate

      If e dey totori you as di US presidential debate dey go between President Trump and Oga Joe Biden, you fit wonder why di same no happun for Nigeria for 2019.

      As di presidential election for di West African bin dey build for February last year, dem invite presidential candidates, including Muhammadu Buhari and im main challenger Atiku Abubakar to come do presidential debate.

      Di two of dem no do di debate.

      Buhari aide explain say na because di president just return from function overseas.

      Whereas Atiku show for di venue, but im no climb stage sake of say Buhari sef no show.

    • Ontop climate change...

      Trump blame recent fires on poor forest management, even though climate experts say di fires dey primarily driven by record levels of drought and heat, wey dem point to climate change.

      Trump also attack Biden for im climate policies, with claim say im proposals go cause economic catastrophe.

      Wen dem ask am whether he supported di Green New Deal, Biden say no because he get im own climate plan.

      “I support di Biden plan wey I put forward, wey dey different dan wetin he call di radical Green New Deal,” Biden tok.

    • Trump attack Biden son

      Trump bin accuse Biden son say dem dismiss am from di military for im abuse of cocaine and dem also accuse say e collect over 3 million dollars from Russia.

      Biden say no be true. Im son wey bin get issue with drug don clean now and dey live like ogbonge citizen.

    • Ontop violent protests

      Chris Wallace ask Biden about di protest wey happun all over US dis summer, especially di 100 days of protests for Portland, Oregon - wey some turn violent.

      "As di Democratic nominee, you don ever call di Democratic mayor of Portland or di Democratic governor of Oregon and tell dem 'hey, you no suppose stop dis tin so?'"

      Biden response dey simple: "I no dey hold public office now."

      But, he continue, "violence suppose dey prosecuted".

    • Next question: Di economy

      Moderator Chris Wallace ask di candidates about di US economy and dia plans for recovery after coronavirus lockdowns.

      "Di economy dey recover faster than expected since di shutdown," Wallace tok in order to ginger Trump.

      Trump first reply E say: "I build di greatest economy in history".

    • 'E blow di economy', and oda gbas-gbos

      See clip of one of di gbas-gbos...