Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing
Nigeria election office, INEC don begin declare LGA results afta vote counting for 19 September, 2020 Edo State Governorship Election. 14 Candidates including di current Govnor Obaseki and im main challenger Ize-Iyamu dey battle to lead di state inside southern Nigeria for di next four years.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Helen Oyibo
Dis na how Egor Local Government Area of Edo state result waka
EGOR LGA
Total Registered Voters: 219841
Accredited voters: 39709
Valid votes: 38396
Rejected votes : 955
Total votes cast: 39351
APC: 10202
PDP: 27621
Ballot snatching at Ogidi Ward 3 units 4,5,18 with 1971 voters
Una Welcome again
Una welcome to anoda day of Edo State Governorship election!
Result collation don dey go on for Independent National Electoral Commission (INEC) office for Benin, Edo state capital.
We go dey drop am here as e dey hot.
Polling Clerks dey enta enta results as INEC begin counting of Edo election ballots
Polling units close afta 2:30pm on Saturday across di 18 Local Goment Areas of Edo State for di Governorship Election.
Presently, Polling Clerks dey enta results as INEC begin counting of Edo election ballots.
See some fotos from di vote counting:
Live from Akpakpava Agbado Primary School Benin, Afta INEC Unit Polling officer declare winner for dis polling unit inside di Edo State Governorship Election.
Jubilation as Obaseki win im polling unit
See as Obaseki supporters dey jubilate for Oredo ward 4 afta news say im win di polling unit.
Breaking, Latest result from Edo Election: Obaseki, Ize-Iyamu win polling unit, as INEC begin vote counting
Govnor Godwin Obaseki win im polling unit.
Obaseki vote Saturday afternoon for Ward 4 unit 19 Oredo Obaseki polling unit for Emokpae primary school mission road Benin City.
Di poll Presiding officer na im declare di unit result as INEC begin vote counting for di Edo State Governorship Election wey close afta 2:30pm.
Also, APC Osagia Ize-Iyamu win im polling unit.
Ize-Iyamu vote Saturday morning for unit 26 ward 5 Iguododo Primary school Orhionmwon Local Goment Area.
"Dis election good well-well" - INEC Resident Electoral Commissioner
Wetin we call dis Video, Edo Election 2020: INEC Resident Electoral Commissioner say di election dey peaceful
INEC Resident Electoral Commissioner inside Edo State, Johnson Alabi say di govnorship
election for Edo State na peaceful election.
Alabi tok say for areas wia dem hear informate of pockets of violence,
dem quickly inform di police to step in.
But generally, im tok say di process
dey smooth, im add.
“I feel tell di whole Nigerians say dis election good and
God help, rain no fall”.
For im response to wetin Govnor Obaseki tok, say delay bin
dey for di pulling units as voters wait for too long before dem fit vote, Oga Alabi say voters bin no quick come out.
See as cooking and voting dey happun for dis polling unit
Election kasala no dey for di polling units wey dey for Ugboko 23 and 24 ward 5 as everything dey go on peacefully.
Voting bin start for dis ward around 8:30am.
For one house opposite di units, cooking dey happun as some women dey serve electorates hot meals.
Heavy security presence for obaseki polling unit
Report from BBC Pidgin tori pesin wey dey on ground for Edo Governorship election say heavy security presence na im dey for obaseki polling unit.
Governor Obaseki and im wife don already cast dis vote dis morning afta dem been wait for line for more than one hour.
Wia dis foto come from, bb
Davido don offer prayer for Edo election
Wia dis foto come from, INSTAGRAM: @DAVIDOOFFICIAL
Nigeria musician, Davido don sama small prayers for everybody wey dey participate for di Edo state Governorship election.
Di singer write for im twitter handle say make everybody out dia dey safe and im dey put dem for e prayers.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Deputy Governor to Obaseki, Shuaibu Phillips vote for Auchi
Wetin we call dis Video, Deputy Governor to Obaseki, Shuaibu Phillips votes for Auchi
"I dey expect INEC to prepare wella for dis election"- Governor Godwin Obaseki
Wia dis foto come from, Getty Images
Edo state governor, Godwin Obaseki say im bin dey expect beta election planning from di electoral commission (INEC) and im dey a bit disappointed say card readey dey slow and e come wait for more than one hour before e fit vote.
"I expect say INEC for prepare wella for dis election. I wait for one and half hour for di queue before I fit exercise my franchise, e dey a bit disappointing," Governor Obaseki tok
Adams Oshiomhole don cast im vote
Wetin we call dis Video, Vdeo from TVC as Adams Oshiomhole dey cast im vote
Former national chairman of APC, Adams Oshiomhole don cast im vote for di Edo state governorship election.
E vote for ward 10, Etsako West local government area Iyamho.
Dis na afta di APC candidate, Osagie Ize-Iyamu and di Governor, Godwin Obaseki don cast dia votes.
Election observers commend Governor Obaseki for standing on queue to vote
Election observers done commend di way Edo State Governor, Godwin Obaseki stand for di line wait im turn to vote, say na good example of humility for Edo pipo to follow.
Some of dem wey follow BBC Pidgin tok, say INEC try to observe di Covid-19 protocols but for di two (2) meters physical distancing, pipo no observe am as dem stand for line.
Many voters wear facemask, sanitize dia hands and do temperature checks before dem cast di vote.
Adams Oshiomhole don enta queue to vote
Former national chairman of APC, Adams Oshiomhole don queue up to vote for di Edo state Governorship elction.
Dis na afta di APC candidate, Osagie Ize-Iyamu and di Governor, Godwin Obaseki don cast dia votes.
Plenti voters come out for Eyean primary school Polling Unit
Some polling unit for di Edo state Governorship election receive massive turn out of voters.
For Eyean primary school, Uhunmwode Local Government Area Edo state, plenti pipo na show face to cast dia votes.
Govnor Godwin Obaseki and im wife Betsy cast dia vote
Edo State Govnor, Godwin Obaseki and im wife Betsy don cast dia vote for Emokpae Model Primary School Mission Road, Oredo Local Government Area of di state.
Oga Obaseki wey be di candidate of People's Democratic Party (PDP) togeda with im wife stand for queue ova one hour before dem come finally vote.
Voting for Edo elections go stop around 2:30PM but if pipo still dey for queue afta dis time, INEC go extend di voting time.
Wetin we call dis foto, Governor Godwin Obaseki cast im vote for Emokpae Model Primary School Mission Road, Oredo LGA
Wetin we call dis foto, Betsy Obaseki cast her vote for Emokpae Model Primary School Mission Road, Oredo LGA
Breaking, Obaseki don vote but complain say "I wait 90 minutes for queue, slow card readers for my polling unit"
Govnor Obaseki don vote but complain say "I wait 90 minutes for queue, slow card readers for my polling unit"
“I expect say INEC for prepare better for dis election. I wait for one and half hour for di queue before I fit exercise my franchise, e dey a bit disappointing. Obaseki add as e cast im ballot around 11:45am on Saturday.
“As e be say dis election na sole day election, I bin expect better planning for dis election. Card readers dey very slow and dat na di situation everywia.”
Voters no observe social distancing Immediately Ize-Iyamu vote finish
About 1,000 pipo na queue up all of sudden for di Polling Unit wey Osagie Ize-Iyamu vote immediately di APC candidate vote finish.
E just dey like say di voters dey for oga Ize-Iyamu to first cast im vote before dey crowd demsef.
Our tori pesin report say di moment Ize-Iyamu leave, INEC officials appear not to care so much about health and safety guidelines (like enforcing facemasks, temp checks).
Di spirit of social distancing don really dey distant for di voters inside di polling unit.
'We dey wait for di hot sun to go down before we vote'
Some women wey bin come out to vote say dem get strong dislike for di harsh sunlight wey dey shine wow-wow for dia.
Di women tell BBC Pigin tori pesin say dem dey wait patiently for di sun to move or cool down before dem go vote.