Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing
Nigeria election office, INEC don begin declare LGA results afta vote counting for 19 September, 2020 Edo State Governorship Election. 14 Candidates including di current Govnor Obaseki and im main challenger Ize-Iyamu dey battle to lead di state inside southern Nigeria for di next four years.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Helen Oyibo
Ize Iyamu na my broda, make e join me to build Edo state - Obaseki
Goodnight!, ...and thank you
Na here we go march break ontop our coverage of di Edo state Governorship Election 2020.
We thank una say una join us from start to finish.
No forget to follow us ontop our social media page dem for Facebook @BBCNewsPidgin on Instagram @BBCNewsPidgin on Twitter @bbcnewspidgin.
You fit also get all di latest tori from Naija, Africa and from around di world ontop our website for www.bbc.com/pidgin.
Thank you again and bye bye.
I dey study di election results - Ize-Iyamu
Di APC govnorship candidate for di 2020 Edo governorship election Pastor Ize-Iyamu say e dey study di results wey INEC announce and go announce e next move soon.
Ize-Iyamu wey thank and appreciate im supporters, say dem endure many evils including say dem no fit vote freely.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Buhari congratulate Obaseki, ask am to dey humble in victory

Wia dis foto come from, Godwin Obaseki and President Muhammadu Buhari
President Muhammadu Buhari don hail di election process for Edo State wey lead to di victory of Governor Godwin Obaseki wey di Independent National Electoral Commission (INEC) declare.
Di President congratulate di winner and ask am to show grace and humility in victory.
For im reaction to di outcome of di election wey INEC announce, President Buhari say: "My commitment to free and fair elections dey gidigba, because without free and fair elections, di foundation of our political and moral authority go dey weak." Di President add: "I don consistently advocate for free and fair elections for di kontri because na di bedrock of true democratic order.
"Democracy go mean nothing if di votes of di pipo no count or if wuru-wuru enta dia mandate."
He commend di pipo of Edo State, di parties, candidates and security agencies say dem conduct demsefs responsibly.
See how pipo dey celebrate Obaseki win for Benin City
Pipo for Edo State capital, Benin city, enta street to celebrate afta INEC announce Godwin Obaseki as di winner of Edo 2020 govnorship election.
Obaseki win im re-election under di People's Democratic Party to become Edo govnor for di second time.
Atiku, Okowa, Makinde hail Obaseki victory
Congratulations don dey come in for Govnor Godwin Obaseki and im Deputy Phillip Shaibu for dia victory for di Edo Govnorship election 2020.
Former Vice-President of Nigeria and presidential candiadte Atiku Abubakar congratulate di Peoples Democratic Party, who im say stand shoulder to shoulder, with di pipo of Edo and dia Government, in good times and bad.
Skip X post, 1Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Govnor Ifeanyi Okowa of Delta state also di pipo of Edo State use dia voice send strong message.
Skip X post, 2Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Govnor of Oyo state, Seyi Makinde also send congratulatory message to Govnor Obaseki and im Deputy Govnor Phillip Shaibu for a well-deserved victory.
Skip X post, 3Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Fotos: See di mood for APC candidate Osagie Ize-Iyamu house





Breaking, Obaseki don give im victory speech
Govnor Godwin Obaseki don thank di pipo of Edo for dia votes afta INEC return am as Govnor of di state.
"Di great pipo of Edo don speak and dem don speak loud and clear" Obaseki tok.
Obaseki also thank President Muhammadu Buhari for defending democracy and allowing INEC and security agencies for performing dia functions without interference.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Breaking, Godwin Obaseki don win Edo state Governorship election

Governor Godwin Obaseki don win Edo state Governorship election.
Di returning officer, Prof. Akpofure Rim-Rukeh na im give dis announce afta dem don gada all di result from di 18 Local Government areas wey dey inside Edo state.
"Dat Godwin Obaseki of PDP, having satisfied di requirement of di law, in meeting di twenty five percent (25%) for two third of di local government area inside di state and having a margin of lead higher than di cancelled vote is hereby declare di winner and return elected." e tok
Prof Prof. Akpofure Rim-Rukeh say di election dey truly contested.
Obaseki get 307,955 to win Osagie Ize-Iyamu wey get 223,619.
INEC National Commissioner for EDO Sate, May Agbamuche Mbu go give Certificate of return to Governor Godwin Obaseki within 7 days.
Reactions as Godwin Obaseki win re-election to become Edo State govnor
Some Nigerians don take to social media to react to di news say Gowin Obaseki win im re-election to become di govnor of Edo State for di second time.
Skip X post, 1Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Skip X post, 2Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Skip X post, 3Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Skip X post, 4Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Skip X post, 5Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Skip X post, 6Allow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 6
Breaking, Obaseki beat Ize-Iyamu to win Edo govnorship election 2020
INEC go announce final result in 20mins time!
Di returning Officer for Edo Governorship election, Prof. Akpofure Rim-Rukeh say dem go announce di final result of who win Edo state Governorship election in 20 minutes time.
E tok dis one afta Party Agents don finish to sign di final result sheet.
We go update una immediately oga Rim-Rukeh announce who win.
Summary of di entire vote by Returning Officer Prof. Rim-Rukeh

Di returning Officer for Edo Governorship election, Prof. Akpofure Rim-Rukeh don give Summary of di entire votes wey dem cast during di election;
Accredited voters: 557,443
Valid votes: 537,407
Rejected votes: 12,835
Total votes cast: 550,242
APC: 223,619
LP: 267
PDP: 307,955
SDP: 323
Breaking, PDP win for Ovia South West Local Government Area- See di result

Di People's Democratic Candidate of Edo state Governorship election, Governor Godwin Obaseki na im win for Ovia South West LGA.
Ovia South West LGA na di last Local government area wey dem call.
Di Collation Officer for Ovia South West na Dr Ibe. Dis na di result;
Ovia South West LGA
Total Registered Voters: 96369
Accredited voters: 24558
Valid votes: 23741
Rejected votes: 743
Total votes cast: 24484
APC: 10636
PDP: 12659
Cancellation dey for Ward 7 for one unit with 992 votes because of election violence.
With dis dem don call all di result of di 18 Local government areas wey dey for Edo state. Remain make di Returning officer, Prof. Akpofure Rim-Rukeh announce di winner of di election.
Governor Wike tok wetin happun to Orhionmwon LGA Collation Officer
Wetin we call dis Video, Governor Wike tok wetin happun to Orhionmwon LGA Collation Officer Rivers State Governor, Nyesom Wike, do sharp-sharp press conference for facebook live to tok wetin cause delay wey make Orhionmwon Local Government collation officer no quick appear to call dia result.
Governor Wike wey bin don tok before say im dey happy with di election process say dem dey surprise say di collation officer disappear.
Di Governor do di facebook live through di handle of Edo state Governor, Godwin Obaseki.
Breaking, Obaseki win for Orhionmwon, Ize-Iyamu Local Government Area- See di result

Governor Godwin Obaseki of Edo state don win for Orhionmwon Local Goment Area, dat na di place wey im main challenger and APC candidate, Osagie Ize-Iyamu from come.
Di collation officers for Orhionmwon wey INEC don bin don dey wait for since na Dr. Engr. Olusegun Samuel of Federal University of Petroleum Resources, Effurun (FUPRE) Delta State.
INEC bin raise concerns about oga Olusegun whereabouts afta dem no see am wen e reach e turn to come call result. E later show face afta almost one hour of waiting.
Dis na di result;
Orhionmwon LGA
Total Registered Voters: 118671
Accredited voters: 24868
Valid votes: 24213
Rejected votes: 614
Total votes cast: 24827
APC: 10458
PDP: 13445
Cancellation idey for di entire Ward 7 with 7600 voters and Ward 8 with 7896 votes because of election violence.
INEC don call for meeting with Party agent

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don call for meeting with party agents.
As INEC officials call for dis meeting, dem don go on break and wen dem come back dem go continue di collation.
Two local government areas na im remain wey dem go call dia result and dem be Orhionmwon and Ovia South-West Local Government area.
INEC dey look for Orhionmwon LGA Collation Officer

Wetin we call dis foto, Returning officer, Prof. Rim-Rukeh Di Independent National Electoral Commission (INEC) don raise concern about di on di whereabouts of di Collation Officer for Orhionmwon.
Report say pipo bin see am earlier before di break but now dem no see e break light again.
Many party agents don dey suspect some foul play.
Dis na di local goment wey Osagie Ize-Iyamu from come, dat na di APC candidate wey be di main challenger to di current Govnor, Godwin Obaseki
Our tori pesin report say Orhionmwon get history of dis kind palava, dia result dey always com last and no so e be for last election.
As e be so, every body plus we for BBC Pidgin Live page dey wait for di bros wey be di collation officer of Orhionmwon LGA.
"Violence happun for Etsako Central"- Collation Officer, Prof. Godswill

Collation Officer for Etsako Central, Prof. Godswill Alaminiokuma tok say violence happun for di Local government during di Edo Governorship election.
Oga Godswill say di kasala strong sotey dem shot one INEC officer and anoda INEC staff dey critically ill for hospital.
Mr Godswill wey be Prof for Federal University of Petroleum Resources, Effurun make dis revelation wen im dey call di result of di local goment for INEC headquarters, Benin, Edo state.
