You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing

Nigeria election office, INEC don begin declare LGA results afta vote counting for 19 September, 2020 Edo State Governorship Election. 14 Candidates including di current Govnor Obaseki and im main challenger Ize-Iyamu dey battle to lead di state inside southern Nigeria for di next four years.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Helen Oyibo

  1. Timeline of di battle to occupy di govnorship seat of Edo state

  2. INEC plan to postpone Edo Governorship Election?, Di INEC tok tok pesin yan win BBC Pidgin about di rumour wey dey normally fly upandan now.

    Independent National Electoral Commission INEC wey be Nigerian election office don deny tori say dem dey plan to postpone di govnorship election for Edo state for southern Nigeria by two weeks.

    Rotimi Oyekanmi tell BBC News Pidgin for interview say na rumour wey dey normally fly upandan.

    Oga Oyekanmi tok say “I wan assure di good pipo of Edo State say di Independent National Electoral Commission no dey plan to postpone di govnorship election wey dey hold on di 19th of September.”

    Di INEC tok tok pesin announce say na even next week dem dey prepare to go Benin City so dat di fourteen political parties wey dey participate for dis election to sign di peace accord.

    And also dem go hold di stake holders meeting for dat same next week.

  3. Watch di BBC Pidgin Edo Governorship Debate here

  4. Exclusive: 'Oshiomhole no be our godfather'

  5. See how President Buhari endorsement of Pastor Ize-Iyamu against im friend Gov. Obaseki go affect Edo election

  6. Gov Obaseki remove Edo Assembly roof make nobodi do sitting afta police clash

  7. Meet di former governors of Edo state and dia biography

  8. Why Edo state never ever get female govnor?

  9. Issues wey candidates tackle during BBC Pidgin Edo Governorship Election Debate

  10. Una welcome Edo State Governorship Election 2020 as e dey hot

    BBC Pidgin don tanda gidigba to report everi everi tori as e concern di 19 September Governorship election for Edo State southern Nigeria.

    You read latest updates here.