You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing

Nigeria election office, INEC don begin declare LGA results afta vote counting for 19 September, 2020 Edo State Governorship Election. 14 Candidates including di current Govnor Obaseki and im main challenger Ize-Iyamu dey battle to lead di state inside southern Nigeria for di next four years.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Helen Oyibo

  1. Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing

  2. Wike land for Benin to show Govnor Godwin Obaseki support

    Fotos of Rivers State govnor Nyesom Wike for di PDP governorship election rally wey happun for Benin, Edo state on Tuesday.

  3. Edo Govnorship candidates sign peace accord

    Member of di National Peace Committee Bishop Matthew Kukah say signing of peace accord no be ordinary ceremony.

    E be like exchange of vows, as na trust dem dey take upon demsefss and na commitment dem dey make to di pipo of Nigeria.

    Bishop Kukah come pray say di election for Edo State go dey credible, free, fair, peaceful and successful.

    Head of Nigeria election office and INEC National Chairman Prof Mahmood Yakubu Yakubu say di National Peace Committee don prove say Nigeria don achieve many tins and no gain for violence during elections

    Im give assurance say di elections go dey credible and Edo pipo naim go choose who go be dia governor as di Commission no dey favour any side.

    Prof Yakubu come advise di candidates to abide by di peace accord dem sign

  4. More pipo go vote in 2020 than 2016, Edo South Senatorial district get highest PVCs, Edo Governorship election informate show 14% increase in voters since 2016

    Informate alias data from Independent National Electoral Commission INEC show 14% increase in registered voters between di election for 2016 and 2020.

    Di data show say for 2016, Edo bin get 1,900,223 total registered voters but by 2020, dem get 2,210,534 total registered voters.

    From di 2020 data, di total number of men wey register na 1,159,325 wey represent 52%, while di number of female voters wey register na 1,051,209 and e represent 48% of di total registered voters.

    INEC say di pvc collection rate for Edo State na 78% as 1,726,738 voters don collect dia voters card so 483,796 uncollected voters card still dey wit dem.

    Edo South senatorial district get di highest PVC collection rate as 1,281,414 pipo don collect dia voter cards, followed by Edo North wia564,122 don take dia PVC but only 364,998 collect dia PVC for Edo Central senatoria district.

  5. Edo elections go open 8:30am and close 2:30pm sake of Covid-19

    Sake of Covid-19 pandemic, INEC don receive personal protective equipment PPEs sake of Covid-19 wey dem go give staff and support workers ery dem go use conduct di 19 September election.

    Dis na even as dem don agree wit National Union of Road Transport Workers, Transport owners and Maritime union wey go supply motors and boats for dia operations on election day.

    INEC Chairman Prof. Mahmood Yakubu tok say polling units go open 8:30am and close 2:30pm sake of Covid-19 pandemic and dem no go do anytin wey go favour one party over anoda.

  6. 'INEC dey ready to conduct Edo govnorship election' - Edo REC

    Nigeria election office, INEC Resident Electoral Commissioner for Edo State say di election referee dey ready to conduct di governorship election as evritin dey ground though dem dey wait for di sensitive materials to land within di week.

    Johnson Alalibo Sinikiem say dem monitor di primaries of 15 political parties out of which 14 submit di names of candidates to di Independent National Elctoral Commission by di time deadline to submit names expire.

    Dr. Sinikiem confam say INEC don receive all non- sensitive materials and dem don train all di different categories of staff wey go conduct di election.

    E say dem don give out di voters' register to di 14 political parties to obey wetin law tok for section 20 of di Electoral Act as amended and also don configure di smart card readers and send dem to di Electoral Officers so dem din ready to conduct di election.

  7. INEC do meeting wit stakeholders on how di election go shele

    Di INEC stakeholders meeting for di Edo Governorship Election gada di Chairman of INEC, Prof Mahmood Yakubu, IGP Adamu, governoship candidates and leaders of di political parties wey dey contest for election and odas to discuss how di election go hold peacefully on Saturday, 19 September 2020.

    Dem go address any concern wey any stakeholder get as e concern di election si dat di process go dey credible and acceptable to evribodi.

  8. Oba of Benin call for peace for Edo elections

    Di Oba of Benin Eheneden Erediauwa, Ewuare II don ask evri bodi to make sure say di elections go well and dey peaceful, free, fair, credible and successful.

    Oba Ewuare II also ask di two major political parties and all di oda political parties wey dey participate for di election say, ‘we no want problems for Edo State."

    "Make una proof una sef well so di election go dey peaceful, credible and successful."

    Di throne (referring Oba of Benin) no dey partial and make all of una take di peace accord una do for di palace.Ewuare II add.

  9. Obaseki and Ize-Iyamu sign agreement for peaceful election

    Candidates wey dey contest di 2020 Edo Governorship election don sign peace accord to ensure peaceful and safe elections come Saturday 19 September, 2020.

    Edo State Governor, Godwin Obaseki wey be di candidate for di People’s Democratic Party PDP and Pastor Ize-Iyamu di Candidate for di All Progressives Congress APC sign di Peace accord and give assurance say dem and dia supporters go abide by di peace accord so di election go dey peaceful.

    But Governor Obaseki ask di National Peace Committee NPC wey initiate di peace accord say make dem no end dia work wit di signing di peace accord as oda factors and interests get influence for di election so make dem also reach out to dem and persuade dem to also respect dis accord di governorship candidates don sign.

    Pastor Ize-Iyamu di candidate of di APC observe say wetin happen na di Oba of Benin first start am wen im invite dem come di Benin palace to sign peace accord, im say through out di campaigns and election, peace go dey.

    “Make I assure Edo pipo and Nigerians say we go do all our best to make sure say di election dey peaceful as na di only way we fit secure our democracy.” Im tok.

    Chairman of di National Peace Accord, Gen. Abdulsalam Abubakar come advise Edo pipo not to sell dia votes, im add say make dem “Use dis election for Edo as a test for future election. Let evri Nigerian dey respected to cast dia votes without any fear or intimidation.

    Member of di National Peace Committee Bishop Matthew Kukah say signing of peace accord no be mere ceremony. E be like exchange of vows as na trust dem dey take upon demselves and na commitment dem dey make to di pipo of Nigeria.

  10. "Obaseki na dictator, no vote am"- Tinubu

  11. Stakeholders do tok-tok on how to make Edo election 'violence free'

    Di Independent National Electoral Commission INEC stakeholders meeting for di Edo Governorship Election wey happun for Benin on Monday gada di Chairman of INEC, Prof Mahmood Yakubu, IGP Adamu, governoship candidates and leaders of di, political parties wey dey contest for di election and odas to discuss how di election go hold peacefully on Saturday 19 September 2020.

    Edo Resident Electoral Commissioner, Dr. Johnson Alalibo Sinikiem say INEC dey ready to conduct di governorship election as evritin dey ground though dem dey wait for di sensitive materials to land within di week.

    Im confam say INEC don receive all non-sensitive materials and dem dey train all di different categories of staff wey go conduct di election.

    INEC chairman Prof. Mahmood Yakubu say polling units go open 8:30 and close 2:30pm sake of Covid-19 pandemic and dem no go do anytin wey go favour one party over anoda.

    Meanwhile di Oba of Benin dey ask evri bodi to make sure say di elections go well and dey peaceful, free, fair, credible and successful. Im also ask di two major political parties and all di oda political parties wey dey particulate to avoid problems for Edo State.

    "Di throne no dey partial and make all of una take di peace accord una do for di palace.” E tok.

    On e own part, di DG of NYSC brig Gen Shuaibu Ibrahim wey Omotade Benjamin Ayodele represent say e dey traumatic for dem to carry di deadibody of Corp members go give dia parents sake of election violence or say dem die during dis service year, e beg political parties, security agencies and Edo pipo to protect Corp members so none of dem go loose dia life for di election.

  12. Wetin you suppose know about 19 September Edo Governorship Election 2020

  13. Meet Abraham di corporate fruitman of Benin City.

    For di past 18 years, come rain come sun, Abraham di fruit man dey duty dey sell im fruits around Benin City.

    Edo pipo, you don buy fruit from Abraham di fruitman before?

    Enta BBC News Pidgin Facebook Page to ansa dis kwesion.

  14. See who go supervise general security arrangement for 19 September Edo Gov. Election, Nigeria police oga don send DIG Adeleye Olusola Oyebade, AIG, eight CPs for Edo election

    Deputy Inspector General of Police in charge of Research and Planning, Adeleye Olusola Oyebade, na im go supervise general security arrangement for di 19 September, 2020 governorship election inside Edo State.

    Force Public Relations Officer, DCP Frank Mba for statement e release on Friday say di Inspector General of Nigerian Police Mohammed Adamu don send alias deploy DIG, AIG, eight CPs to coordinate security operations’.

    Di statement note say Oyebade go dey assisted by one Assistant Inspector-General of Police, Karma Hosea Hassan, wey dey in charge of Federal Operations for di Force Headquarters, Abuja, and eight Commissioners of Police.

    EFCC don tell Edo bankers to report suspicious transactions ahead of 19 Sept. Governorship Election

    As di Edo State Governorship Election dey draw near, Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission, (EFCC) Benin zonal office, don advise Compliance officers of banks to report suspicious transactions to di Commission.

    Benin Zonal head of the EFCC, Muhtar Bello cut di warrning during one meeting wit compliance officers of various banks inside Benin City, Edo State.

    Bello wey tok to di bankers on behalf of EFCC oga patapata alias acting Executive Chairman, Umar Abba Mohammed, charge dem to be alert as politicians may want to use banks for magomago transactions before, during and afta the elections.

    "Once di transaction dey above di approved limit, you get duty to report. So be alert " im tok.

  15. INEC don deploy 5 RECs, 2 National Commissioners to Edo State

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Di Independent National Electoral Commission INEC don redeploy five Resident Electoral Commissioners RECs and two National Commissioners to Edo State for di Governorship election wey go hold on 19 September, 2020.

    Tok-tok pesin for INEC Edo State Mrs. Obamogie tell BBC Pidgin say na normal tin for INEC to deploy more Resident Electoral Commissioners to come support di Resident Electoral Commissioner for States wey get Stand alone elections like Edo and Ondo State get.

    “Di five RECs dey come supervise and give support to di Resident Electoral Commissioner Johnson Alalibo to conduct di election.

    Even di National Electoral Commissioner wey dey in charge of Rivers, Bayelsa amd Edo State, May Agbamuche-Mbu go also get support from oda National Commissioners to to make sure di election go smooth and peaceful.

    So two oda National Commissioners go also come give support for di conduct of di elections.” Im tok.

  16. NYSC DG ask police to protect Corp members

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Di Director General of di National Youth Service Corp NYSC, Brig. Gen. Shuaibu Ibrahim don ask di Nigerian Police to protect di 1260 Youth Corp members wey go help di Independent National Electoral Commission (INEC) to conduct di 2020 Edo Governorship election wey go hold on Saturday 19 September, 2020.

    Brig. Gen Ibrahim tok dis one wen im visit di Commissioner of Police Edo State for Benin City come add say Youth Corp Members don help to conduct many successful elections for di kontri because dem dey patriotic, neutral and no get any political side dem dey support and get correct training.

    Di DG NYSC wey don also visit di Oba of Benin, also ask di pipo of Edo State to also protect evri Youth Corp Member wey dey dia area because dem be dia pikin, e come add say dem no go send any Corp member to di riverine communities.

    Commissioner of Police Edo State, Johnson Babatunde Kokumo assure di DG NYSC say dem dey committed to protect di life of evri Nigerian, and more especially di Youth Corp Members wey dem see as dia pikins and for di important role dem dey play for di elections.

    Im add say dem dey join body wit Nigerian Police Marine, di Nigerian Army Marine, di Nigerian Navy and oda security agencies for di kontri to make sure say evri wia dey safe and secure for Edo pipo to come out come cast dia votes peacefully on di Election Day.

  17. Edo Commissioner for Mineral resign from Obaseki camp just 10 days to 19 Sept. Governorship election

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Edo State Commissioner for Minerals, Oil, and Gas Joseph Ikpea don resign.

    Oga Ikpea resignation dey come 10 days to di Edo state governorship election, according to local tori..

    For inside letter wey im write give di govnor on 9 September, he explain say reason why im wan resign dey based on trust, respect and say im no fit leave di APC as im don help build di party from scratch.

    He say “politics na all about interest, trust and respect for one another but I neva get any of dis things till dis date and I no sure say I go get am even if I dey there till tomorrow.”

    “Na me bring di party wey dem sabi as APC today come Esan South East and more than 90 percent of my supporters still be members of APC.”

    “E dey hard for me o live di house wey I build and even di current administration no notice my leadership role.”

    Di former commissioner don promise to support di candidate of di All Progressives Congress, Pastor Osagie Ize-Iyamu.

    Ikpea go make am di third commissioner for govnor Godwin Obaseki cabinet to resign dia position go support Ize-Iyamu.

  18. Edo Assembly don ask INEC, Buhari for free fair elections

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Di House of Assembly for Edo State southern Nigeria don ask President Muhammadu Buhari and di kontri election office INEC make dem make sure say di 19 September governorship elections for di state dey free and fair.

    Di Speaker of di House, Francis Okiye tok dis one for plenary on Wednesday say make Buhari police and oda stakeholders do dia part for di elections,

    Dem tok say di will of di pipo must stand durng di election.

    Governor Godwin Obaseki dey find second term for office for dis election.

  19. How to avoid void votes

    Void votes na votes wey don waste and dem no count am because di voter no press hand di proper way e suppose press am for di ballot paper.

    To avoid void votes, na one important tin di Independent National Electoral Commission, INEC and oda advocacy groups dey teach voters for di governorship election.

    INEC don advice pipo make dem press dia finger inside di box beside di political party logo wey dem wan vote for, for di ballot paper so dia vote go dey valid and dem go count am.

  20. Obaseki supporters shun rain to continue campaign, Rain or no rain, campaign dey go on

    Heavy rain wey fall for Benin City no fit stop di campaign train of di Peoples Democratic Party candidate Govnor Godwin Obaseki.

    Fans and supporters come out for di heavy rain on Wednesday to continue campaigns for di Saturday 19 September, 2020 election.

    See pictures from di campaign.