You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Obaseki collect INEC Certificate of Return, Ize-Iyamu dey study di election result ahead of tribunal hearing

Nigeria election office, INEC don begin declare LGA results afta vote counting for 19 September, 2020 Edo State Governorship Election. 14 Candidates including di current Govnor Obaseki and im main challenger Ize-Iyamu dey battle to lead di state inside southern Nigeria for di next four years.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Helen Oyibo

  1. Ize-Iyamu explain why im wear 'Air Doctor' for im chest

    Osagie Ize-Iyamu wey be di main challenger to di current Govnor Godwin Obaseki don explain why im wear 'Air Doctor' alias Air Sanitizer go vote today.

    Di candidate of Nigeria ruling All Progressives Conress (APC) tell BBC Pidgin say dis Air Doctor na air sanitizers wey be additional protection to facemask as part of protection against coronavirus sake of di number of pipo dey go come across with today.

    E say di air doctor dey sanitizer di air just like hand sanitizer dey protect di hand.

    Oga Ize-Iyamu don carry waka now go Benin afta e don cast im vote finish.

    Meanwhile you fit watch us Live ontop we facebook page.

  2. Edo state Governor, Godwin Obaseki dey queue to vote

    Di Governor of Edo state, Godwin Obaseki don stand for queue to cast im vote for Emokpae Model Primary School Mission Road, Oredo LGA.

    Oga Obaseki na di candidate of di People's Democratic Party (PDP) and im dey contest for second term in office.

  3. Drama as one man try to disrupt Governor Obaseki voting

    Small drama happun for di polling unit of Edo State Govnor, Gownin Obaseki afta one man try to disrupt im vote for e polling unit.

    Our tori pesin report say dis dey happun wen Oga Obaseki arrive Emokpae Model Prinary School Mission Road, Oredo LGA wia im wan cast e vote.

    Report say di man wan bin scata di polling unit before oda thugs wey dey around carry am comot dia.

    See fotos of how di kasala waka

  4. How visually impaired pipo take cast dia vote

    Visually impaired pipo for Oredo Local government area dey able to cast dia vote during di Edo governorship election.

    INEC officials give dem preference to vote according to di rules for dem to assist physically challenged peisin to vote first or as soon as dem arrive.

    Yakubu Mohammed, wey be 60 year old and dey Visually impaired carI waka go cast im vote along wit some oda physically challenged pesin for Oredo Local Gorment Area.

  5. INEC official do temperature check for voters sake of coronavirus

    INEC officials don first of all do temperature check for each oda before dem begin do for voters.

    To follow di standard covid-19 measures, before INEC officials go allow pipo to vote, dem go check dia temperature, give dem hand sanitizers and scrub dia hands wit methylated spirit before dem go touch di card card for finger print verification.

    May Agbamuche- Mbu wey be INEC National Commissioner for Edo State emphasis di need for physical distancing to voters wey dey queues inside one polling unit for Western Bous High School Ikpoba Ohka.

  6. Osagie Ize-Iyamu of APC don vote

    Osagie Ize-Iyamu wey be di candidate of Nigeria ruling All Progressives Conress (APC) for Edo Governorship election don cast im vote.

    Ize-Iyamu wey be di main challenger to di current Govnor Godwin Obaseki arrive polling station for Iguododo village inside Orhionmwon LGA, Edo State at about 9:21am.

    Di APC Candidate vote minutes afta.

  7. Nine rules voters must obey during 19 Sept. Edo election - IGP

  8. See as voting dey go on for Unit 19 ward 2 western boys college

    Voting don start for Unit 19 ward 2 western boys college. See fotos of how di voting dey go

  9. "I no want pipo to use facemask as excuse not to vote"

    Bright Iyamu wey claim to be Ize-Iyamu distant cousin tell BBC Pidgin say im feel di need to use im personal money to buy face masks so dat no one, be it PDP or APC supporter go use facemask as reason not to come out and vote.

    Bright don distribute di facemasks freely to pipo wey stretch out dia hands to collect.

    Meanwhile, long-long queues don dey build up for different polling unit on to di Edo election wey don start

    Some polling unit don arrange tins like; methylated spirit, wool, digital thermometer and gloves wey dem wan use for di vote.

  10. Some voters don dey ready!

    Some early voters don dey ready to vote for nearby polling units wey don set up and dia expectations dey very high for peaceful election.

    Our reporter on ground say where pipo go tanda vote alias polling unit almost dey ready to wait for di voting time wey be 8:30am wen voting go officially begin

  11. Distribution of election material don start

    Distribution of election materials don dey go on for one of di RAC centres inside Ikpoba Okha LGA, for Western Boys High School.

  12. Dis na where Osagie Ize-Iyamu go cast im vote

    Osagie Ize-Iyamu wey be di APC candidate for Edo Governorship election and di main challenger to di current Govnor Godwin Obaseki go cast im vote for Iguododo village wey dey di heart of Orhionmwon, Edo State.

    According to our tori pesin wey dey on ground, di weather dey lovely but wet small sake of di rain wey fall in di morning but dem no dey expect dis to cause any trouble for voters as dia houses no too far from di polling center.

  13. Edo Bus drivers do last minute hussle before election

    As Edo pipo dey prepare to cast dia vote, bus drivers dey try make last minute hustle before election go start.

    Pipo go begin cast dia vote from 8:30am to decide who dem want to be dia next Governor.

  14. Edo 2020: ‘Avoid election offences’ - INEC

    As di pipo of Edo State dey go cast dia vote today, di election umpire Independent National Electoral Commission INEC don warn voters to avoid any election offence.

    Some of di Election offences and penalties wey dey di Electoral Act 2010 as amended wey pipo suppose avoid na:

    • Unlawful possession or selling or buying of voters card. Section 23(a)&(b). Di penalty na 2 year jail term or N500,000 fine (Sect. 23c)
    • Impersonation Secrion 59(1). Di penalty na say dem go prosecute you for court according to di law wey dey applicable for di State. Sect 59(4).
    • Bribery of INEC Officials or security officers to rig election. Section 124(1). Di pesin go go jail for one year or pay fine of N500,000 or both.
    • Spying to know who go voter vote for. Section 125. Di pesin go go jail for six months or pay fine of N100,000.
    • To vote or try to vote for place wia pesin no register for. Section 127. Dat pesin go go jail for six months or pay fine of N100,000
    • To act to ginger odas to act in a disorderly manner (Section 128). Day pesin go go jail for one year or pay fine of N500,000.
    • To campaign and blare siren within 300 meters of fi polling unit on election day (Section 129). Dat pesin go go jail for six months or pay fine of N100,000.
    • To destroy or snatch any election materials (Section 129(1)). Di pesin go dey jailed for one year.
    • Under age voting (Section 122(1) e or Multiple voting. Di pesin go dey jailed for one year or pay fine of N500,000 or both.
  15. Rivers state goment claim say police block Governor Nyesom Wike hotel for Edo state

    Rivers State Goment don raise alarm say di life of Governor Nyesom Wike dey for danger on top claim say policemen don go barricade di hotel wey im lodge for Benin, Edo State capital.

    For one tweet, di goment claim say na ova 300 Police men block di hotel wey Governor Nyesome Wike dey

    Meanwhile Nigeria police neva comment or tok anything concerning dis allegation.

  16. Una welcome

    Una welcome for di live report on Edo governorship election as pipo inside di state go begin vote from 8:30 am to elect dia governor for di next four years.

    Everi-everi as e dey happun for Edo state go dey here.

  17. INEC guideline on how to vote safely during di coronavirus pandemic

    Di Independent National Electoral Commission, INEC, don bring out voters code of conduct to guide voters on how to vote safely during di Covid-19 pandemic.

    Dis code of conduct go guide how voters go conduct demsefs for di 2020 Edo governorship election on Saturday 19 September, 2020.

    See di rules:

    • Evri voter must wear facemask as dem dey come di polling unit come vote, though dem fit ask di voter to lower im facemask for identification purposes afta which e go wear am back properly.
    • Voting go start from 8:30am to 2:30pm. Two lines go dey way voters go form and dem must maintain physical distance of 2meters in between dem. Di first line go dey outside di polling area from wia dem go call pipo to join di second line wey go dey inside di voting area. By 2:30pm di line for di outside area go close but dem go still allow pipo wey already dey di line before di time reach to cast dia vote.
    • Any voter wey show any sign or symptom of Covid-19 like high temperature, coughing or sneezing go leave di line but officials go attend to dem. Officials go dey ground to attend to any report of health emergency for di polling unit.
    • No touch any surface area for di polling unit and dem go provide hand sanitizers if pipo ask and e dey available
    • Election official go ask di voter to clean dia hand wit antiseptic before im fit place im hand for di smart card reader to read di fingerprint
    • Show your voters card to di election officials anytime dem ask you.
    • As soon as you cast your vote, move away from di voting area but pipo fit observe di counting of votes and announcement of results from a designated area.
    • Carry any of your used protective materials like face mask and hand glove, no dirty di polling unit
    • No phones or any oda device go dey allowed to snap picture for di voting cubicles.
    • Obey all di directives wey di election officials and security pipo give so evritin go go well and orderly. INEC fit prosecute any pesin wey assault any election official.
  18. Edo 2020: INEC don begin distribute sensitive materials to local goment areas

    Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) don begin distribute sensitive materials like ballot papers and results sheets to di different local goment areas for Edo State, two days to di 19 September, 2020 Governorship election.

    Di distribution dey happen from di domot of Central Bank of Nigeria (CBN( head office for Benin City wia dem bin keep so sensitive materials for di CBN strong room.

    Di exercise dey happun under di watchful eyes of top security operatives and political party agents wey bin don inspect di materials and say dem dey satisfied wit dem.

    Di materials dey go di LGAs for special vehicles wey get tracker to monitor di movement from CBN Benin City to di LGAs and top security team dey also follow am as e dey go to guarantee di security of di materials.

    Di distribution begin wit local goment dem wey de very far from Benin City like Akoko Edo, Owan West and Owan East for Edo North senatorial district.

  19. Heavy security presence for Benin City

    Heavy security take over Central Bank, Benin city, Edo state.

  20. We dey satisfied wit di election materials - IPAC EDO

    Political parties wey dey participate for di 2020 governorship election say dem dey satisfied wit all di election materials wey INEC go use for di election.

    Chairman of di Edo State Inter Party Advisory Council IPAC and chairman of Labour Party Kelly Ogbaloi tok dis one after political party agents go inspect di sensitive materials wey dey di strongroom for Central Bank of Nigeria CBN, Benin City.

    Head Voter Education and Enlightenment INEC Edo State Timidi Wariowei add say by 7:30am on Thursday, 17 September, dem go begin distribute di sensitive materials to all di local goment areas for di State.