Chairmo of di Independent National Electoral Commission( INEC) Professor Mahmood Yakubu tell tori pipo on Sunday afternoon say :
1. Di commission dey happy wit how di exercise go generally for di kontri.
2. Di commission still dey committed to make sure say noting do di ballot.
3. E don look di challenges of di exercise last night come change di voting period for di areas wey dey affected.
4. E accept say di card reader bin get some technical wahala for some states, upon say dem try make sure say di machine work well well.
5. Note am down say INEC officials and materials late come some oda states.
6. Voting no happen at all for some places because of card reader wahala and katakata. Dem be: Abia, Bayelsa, Benue, Zamfara, Plateau, Sokoto, FCT Abuja, Rivers, Imo and Lagos. Dem don submit report about Rivers.
7. Dem kill some Adhoc staff by shooting for Rivers state and Osun state.
8. National Collation Centre go open by 6pm local time, collation of results from states go start wen di state returning officers reach Abuja.
9. Only INEC fit declare results – even tho plenti results dey spread for social media.
10. Di commission go try dia best to make sure say di collation of result and declaration of di election happen sharp-sharp.