Kasala don burst for Lagos and Rivers states
Nigerian army don show to catch thugs for di Aguda area of Lagos state wey wan scata voting wey dey go on.
Tori be say di thugs break bottle for di area and put fear for di mind of voters wey show face before army come.
For Rivers state, south-south Nigeria, heavy shooting bin happun for Ubima, near di polling unit of Chibuike Amaechi, wey be di kontri Minister of Transport. Nobodi sabi who di gunmen dey work for, but dem use force take carri voting materials comot.