You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Nigerians, world leaders celebrate Buhari
INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.
Live Coverage
Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo
Breaking, Main opposition PDP dey address tori pipo ontop di election as dem see am
Main opposition PDP dey address tori pipo for Abuja now.
Di national chairman Uche Secondus dey tell tori pipo wetin dey worry di party ontop di election as dem see am.
Breaking, Senator Nwaoboshi Peter win for Delta North Senatorial districts
Senator Nwaoboshi Peter from PDP na im win for Delta North Senatorial districts.
Delta North Senatorial districts get 9 LGA:
Aniocha North, Aniocha South, Oshimili North, Oshimili South, Ika North East, Ika South, Ndokwa East Ndokwa West and Ukwuani.
Registered Voters : 850,967
Accredited Voters: 239,737
APC: 36,350
PDP-186,423
#NigeriaDecides2019result Collation Center for Abuja don resume
INEC Chairmo Prof. Yakukubu Mahmood say dem go resume wit Ondo state and Kogi
Breaking, Why PDP agent no gree allow INEC to announce result of Godswill Akpabio Senatorial district
PDP party agent no agree make dem announce di result of di Akwa Ibom North West senatorial district wey concern Senator Godswill Akpabio as im argue say e no align with wetin constitution tok as dem suppose announce di result for di District wey di election happun.
Dis one mean say di Returning Officer go return to di place wia im run from on Sunday to come announce am for INEC headquarters for Uyo sake of say jaguda pipo threaten im life.
Breaking, Bari Mpiggi win Rivers South East Senate seat
Barinaadaa Mpigi of di PDP don win Rivers South East senatorial district.
INEC Returning Officer, Prof. Bisi Mmom declare am winner with total of 247,180 votes.
PDP no agree wit di Presidential election results results from Kano
"We dey note down all di problems with di figures wey INEC dey announce and after dem finish we go challenge dem because e get many wards wey issues dey.”
Dis na quote from PDP chairmo for Kano State nort west Nigeria Engr Rabiu Bichi.
Jimi Agbaje say PDP no go accept some of di presidential results from Lagos
PDP Govnorship candidate for Lagos State, Jimi Agbaje say dem no go accept some of di presidential results from Lagos
Agbaje say violence and intimidation from di ruling party plenti for areas wia PDP get strong leg like Oshodi and Ojo.
Breaking, Cross River South Senatorial Election Result
Southern Senatorial District
PDP - 77478
APC - 63250
ADC - 420
Returning office Prof James Ekpoke Former VC UNICAL
Senator Gershom Bassey na im win as Senator for Cross River South
#NigeriaDecides2019result Collation Center for Abujadon go break
INEC ok say dem go for 30 minutes break to resume results announcement by 5pm
Kasala don burst for INEC Benue office?
E be like say kasala wan burst for INEC office for Makurdi as youths wey di support di ruling APC pack demselves for car di shout 4 plus4 come block di INEC gate.
But military and police pesin quickly block di entry to di INEC office and begin to pushure di bad boys.
Because of di kata-kata security pipo no allow BBC journalist to take pishure or video
Nasarawa State
APC don take Kwara State
, Atiku don win FCT
Army armored tanks don block road for Bayelsa protesters
Article Information - Author, Gift Andrew
- Role, BBC Pidgin Reporter, Bayelsa State
Armored tanks of Nigerian army don block road for Yenegoa, Bayelsa state capital for south-south Nigeria wia members of opposition People’s Democratic Party dey do protest.
Dem say dem dey vex unto say Nigeria election bodi INEC no follow due protest to announce results for some parts of di state.
Dem accuse members of di ruling All Progressive Congress APC say dem pursue some PDP members from polling booths during Saturday election come go thumbprint ballot papers.
Di protesters match from di peace park wey dey front of Bayelsa state goment house to INEC headquarters but army no gree make di protesters pass.
For di two local goment results wey INEC don announce for presidential elections for Bayelsa state, na PDP dey lead wit high margin.
Watch as INEC dey announce live result of FTC presidential election
INEC neva announce Godswill Akpabio result
INEC oga for Akwa Ibom state, Mike Igini say dem neva announce complete results for Akwa Ibom north west senatorial district (Ikot Ekpene) as dem never use eye see di returning officer for dat district since Sunday night.
Tori be say di man take off afta e be like say trouble wan start as im dey announce di result for Sunday night. Sake of dat, oga Mike Igini don ask am to come present im result for INEC headquarters.
Di collation centre for Uyo don go on break wit only one LGA wey remain wey dem neva announce. Di LGA na Essien Udim, hometown of Sen Godswil Akpabio.
Jimi Agbaje say PDP no go accept results "dem dey don tamper wit"
Govnorship candidate of di PDP for Lagos State, oga Jimi Agbaje say dem no go accept results dem dey don tamper wit.
Im say violence and intimidation from di ruling party plenti for areas wia PDP get strong leg like Oshodi and Ojo.
Im say card readers no even work for some and say na strategy to do magomago.
Dem don begin drag cloth for INEC collation centre for Rivers State
Article Information - Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Lagos
Plenti drama follow di collation of results for di presidential elections for Rivers State.
Many party agents greedie for di results from some local goment areas like Asari Toru and Emohua wia di Returning Officers and di Electoral Officers no agree for di results.
Di State Collation Officer for di Presidential Election SCOPE for Rivers State, Prof. Enefiok Essien SAN, come say make dem step down results from Emohua because of too many irregularities wey full am.
Oda results wey dem submit on Monday include:
LGA: Ogu/Bolo
Returning officer: Sonari Otobo
Electoral officer: Ezenwa Alozie
Total No. Reg. voters: 52, 965
Total Accredited:11,150
Valid votes: 10, 561
Rejected votes: 446
APC: 2148
PDP: 8221
Total votes cast: 11,007
Note: Di returning Officer say dem no cancel any Ward Presidential results.
_____________________________________________________________________________________
LGA: Opobo/Nkoro
Returning officer: Prof. Clifford Ofurum
Electoral officer: Samuel Udezi
Total No. Reg. voters:52,069
Total Accredited: 8070
Valid votes:7443
Rejected votes:218
APC: 3706
PDP: 3571
Total votes cast:7661
Notes: Di returning officer say dem cancel 3 wards. For ward 3, im receive result come see say unit overvote as di number of accredited voters according to di card reader no match wen im mention am, dem go manufacture number and na similar tin of overvoting wey happen for di oda ward 9 and 11.
_____________________________________________________________________________________
LGA: Khana
Returning officer: Okechukwu Francis
Electoral officer: Okechukwu Obiozo
Total No. Reg. voters:167,958
Total Accredited:100,289
Valid votes:97,400 (computer calculate 97,287)
Rejected votes:1087
APC: 5329
PDP: 89843
Total votes cast: 98,487
Notes: Of di 19 wards for Khana, election happun for only 17 wards and election no take place for ward 6 wey get 15 units and anoda ward sake of security palava. APC party agent say di turnout dey questionable as e dey too massive, so e dey cooked. PDP agent say di heavy military presence for PH and Obio Akpor fit make pipo not to come out.
______________________________________________________________________________________
LGA: Asari Toru
Total No. Reg. voters:41,278
Total ccredited: 26,642
Valid votes:26,742 (computer calculate 26,349)
Rejected votes:300
APC: 18,180
PDP: 3175
Total votes cast:?
Notes: Party agents observe say many of di figures wey di Returning Officer give change from di one im give on Sunday. PDP Party agent Austin Opara also observe say all di parties get figures so im dey suspect say di figures na fake and dem just allocate figures give all di political parties. Dem don take small break to resume by 5pm Monday.
______________________________________________________________________________________
Buhari 2 Atiku 0