Thugs don block road for INEC officials for Kogi State
Thugs don block road and no dey allow election officials transport results to state INEC office for Kogi State.
Dem don call police and army to protect di senatorial collation Centre for kogi West.
Kogi state electoral commissioner James Apam say no single result of di 21 local goment areas don enta di commission hand, for state wey tension already dey ground.