Get Involved
Four more years for presido Muhammadu Buhari, so na which areas you go want am to focus on?
Tok to us, for our social media page dem.
BBCNewsPidgin for Facebook, Twitter and Instagram.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.
Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo
Four more years for presido Muhammadu Buhari, so na which areas you go want am to focus on?
Tok to us, for our social media page dem.
BBCNewsPidgin for Facebook, Twitter and Instagram.
Presidents of some African kontris don begin send congratulobia to presido Muhammadu Buhari, wey don win election to lead Nigeria for four more years.
Statement wey Femi Adesina wey be di president special adviser release, say President Nana Koffi-Addo of Ghana, Mahamadou issoufou of Niger, and Macky Sall of Senegal, don congratulate Buhari.
According to oga Adesina statement, di oda West African presido dem say oga Buhari re-election show say Nigerians get confidence in am and dem wish am well.
President Muhammadu Buhari wey INEC don officially declare winner for di 2019 presidential elections, don ready to address di kontri for di APC Presidential Campaign Council Office.
Dis na according to wetin di president special assistant on new media, Bashir Ahmak tok ontop im page.
INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.
Earlier, Special Adviser on Media and Publicity to President Muhammadu Buhari, Femi Adeshina post dis video for social media wey show oga Buhari and Ibikunle Amosun in front of television dey wait final result from INEC.
Afta dem don announce result of Presidential election for all di states of di Federation, Nigeria's President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, dey lead im opponent, Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, PDP.
But im supporters no go mind say INEC never declare Buhari winner, dia own party don already start.
Candidate of di All Progressives Congress, Muhammadu Buhari dey lead for result table.
From total results, Buhari gbab 15,191,847 votes.
Im closest rival Atiku Abubakar of PDP score 11,262,978 votes.
Wetin remain na for party agents to sign di final results.
And afta dat INEC Chairman Prof. Yakubu Mahmood wey be di Chief Returning Officer for dis election go make declaration of di winner.
For now Prof. Yakubu say dem go close work to resume by 3am on Monday.
Candidate of di African Action Congress, Omoyele Sowore tell BBC News Pidgin say di February 23 Presidential election no be proper election sake of say sojas bin dey intimidate voters, especially for im village.
Sowore still add say as im party don get di third highest vote so far, e show say Nigeria want new force.
One returning office (RO) Professor Ibeawuchi Izuchukwu for Nigeria electoral commission wey dey run elections, INEC, tok say dem force am to declare fake result.
Im tell BBC say na di Govnor of Imo State Rochas Okorocha do am dis strong tin.
Delta State Presidential result Final.
PDP: 594068
APC: 221292
AAC: 1676
ACPN:134
ANN: 320
SDP: 1745
YPP: 497
Registered voters: 2719313
Accredited Voters: 891647
Total number of valid vote: 829,762
Rejected Votes: 52492
Total Vote cast: 882,254
Govnor Nyesom Wike on Tuesday evening sharperly deny Nigeria Army accuse say im try to rig 23 Feb. general election across Rivers State.
Tori be say Nigeria Army say on Tuesday afternoon do National TV broadcast wia Col. Aminu Illiyasu, di tok tok pesin for 6 division Nigerian Army clain say dem get recording of Gov. Nyesom Wike wen e try to bribe dem to rig election.
Wike tell BBC News Pidgin say Nigeria Army accuse say im bride dem to rig presidential election for Rivers na lie.
Di Rivers State Govnor claim say di army plan to use dis accuse cause trouble for 9 March, Govnorship electiion.
Rivers State goment don report to ICC
Rivers State goment say dem don write to di International Criminal Court to prosecute di General Officer Commanding (GOC) 6 Division Nigerian Army, Major General Jamil Sarham for crime against humanity.
Govnor Nyesom Wike tok dis one as im respond to allegation wey Six Division of Nigerian Army sama for im head say im try to bribe dem for dis election.
Di Govnor say, “we dey send petition to di International Criminal Court. We dey demand justice for all di pipo wey di GOC and im lieutenant kill."
"We dey also send petition to all di major embassies wey dey di kontri for di bad bad tins dem don commit against Rivers pipo. We also ready to send petition to di Chief of Army Staff for di criminal action of di GOC.”
Di Guvnor come ask di six division to answer di accuse wey INEC Electoral Officers for Ikwerre, Okrika, Ahoada West and Emohua get against dem say dem abduct dem, carry election materials comot come manufacture fake results.
Im come deny say im no ever offer anybodi bribe but explain say wen I’m hear say dem arrest one of im commissioners Dr. Reason Onya, im ask to speak wit di officer so dem for release am because im be one of di approved PDP party agents wey suppose escort election materials so na legal electoral work for PDP im be dey do.
Nyesom Wike come add say im tok to over 10 officers dem wen Dr. Onya call am. Guvnor Wike come say di Action wey di Six Division take to broadcast di parade of di pipo wey dem arrest na violate evri law and na coup against constituted authority.
Di value of shares dem of companies for Nigeria don lose 85 billion naira within 6 hours wey dem use trade today for di Nigerian stock exchange.
Financial sabi pipo tok say dis one na because plenti sharp investors dey comot dia profit from di market.
Di trading market bin open at N12.19 trillion but e close at N12.109 trillion.
Nigeria main opposition PDP on Tuesday evening demand say make di kontri election office INEC stop di announcement of di 23 February Presidential and National Assembly election results.
Registered Voters - 3,215,373
Accredited voters - 677,743
Total Valid vote - 642,165
Rejected Votes - 24,420
Total Votes Cast - 666,585
PDP - 473,971
APC- 150,710
SDP - 1,244
ANN - 365
YPP - 415
Dem no collate results for Okrika and Ahoda west unto violence and disruption of the process.
Even for Boni and Akuku-Toru Local Goment Area dem no do collation becos some jaguda pipo disrupt di process so dem no move materials go di area.
For Inside Emuoha, ward collation officers write say dem no fit collate any result.
Di electoral officer also write say dem no do collation and inside Ikwere too dem no do any collation for dia.