You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. PDP member oga Ben Murray-Bruce say im mouth dey pim for now

  2. Atiku don win Anambra State

  3. LIVE: Anambra State result

  4. Buhari don win Kaduna State

  5. Bukola Saraki dey wish winners of Kwara State elections all di best

  6. LIVE: Kaduna State result as INEC dey announce am

  7. Buhari don win Jigawa State

  8. Buhari don win Niger State

  9. LIVE: Niger State presidential election result

  10. Breaking, INEC collation centre don open to begin call results

    Afta dem go break on Monday, di INEC collation centre for Nigeria presidential results don open on Tuesday for Abuja

    Na Niger state result dem wan begin call.

  11. Dele Momodu message for Atiku

  12. E no pain me say I lose for my polling unit - Donald Duke

      • Author, Fiona Equere
      • Role, BBC Pidgin

    Presidential candidate of di Social Democratic Party, Donald Duke say im no dey worry afta People's Democratic Party win all 18 local goment areas for Cross Rivers State for di presidential election for Nigeria.

    PDP presidential candidate Atiku Abubakar dust oga Duke inside di unit wia im vote for AME Zion School unit 005 for Calabar, wit 291 votes while oga Duke get only six votes and presido Muhammadu Buhari get 98 votes.

    Di former govnor say im no campaign for dis election because of di kasala wey dey im party and many pipo no know say im dey contest.

    "My party need to go back to drawing board. Na we cause our problem, our constitution no support collabo at all at all wey di party national working committee do. So we need back to drawing board and ask ourself wetin we really want." Na wetin im add put.

  13. Newspaper stand. Wia all naija wahala get solution.

  14. Kwankwaso say make im supporters no fight over presidential result

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    Former Kano State govnor and PDP strongman Rabiu Kwankwaso say make im supporters no fight over presidential result.

    Im bin dey react afta presidential collation of result end for Kano State. Oga Kwankwaso yan say im party go follow di process laid down by law to challenge INEC but make im supporters, wey mostly dey for di Kwankwasiya movement, no fight.

    Im also add say make dem dey prepare for di gubernatorial election wey dey come.

  15. Three LGAs for Rivers State no get result

    Three local goment areas for Rivers State no get results for di presidential and national assembly elections wey hold dia.

    Di local goments na Ikwerre, Okrika and Ahoada West.

    Electoral officers for dis local goment dem - Efeturi Emabwoyam for Ikwerre, Leo Okon for Okrika and Nicky Cleopas Emotimi for Ahoada West, say di plenti violence and military invasion wey hapun dia make dem no fit collate di results.

    But State Collation Officer Presidential Elections SCOPE, Prof Aniefiok Essien no accept di results from Emohua local goment because di returning officer Dr. Kpang Meelebari and di Electoral Officer Kenneth Etta no agree for di results.

    Even afta di SCOPE tell dem to go organise dia report, political party agents no gree for di magomago wey full di results so di INEC oga patapata for di state come say di results no dey accepted unless di returning officer go provide all di polling unit results sheet wey im take get di results.

    So far, 17 local goment don present results for di presidential and national Assembly elections and PDP dey win except for Asari Toru and Opobo/Nkoro wia APC get higher votes.

  16. Police dey warn PDP and APC senate candidates for Akwa Ibom State

      • Author, Moseph Ekine
      • Role, Broadcast Journalist Pidgin

    Akwa Ibom state commissioner of police oga Ibrahim Kaoje don warn party candidates for di North West senatorial district of di state; Senator Godswil Akpabio of APC and Dr Chris Ekpenyong of PDP make dem dey careful not to declare demselves winner of di district as dis go mean say dem don break law.

    Until now, INEC neva declare anybody as winner of di district election despite tori wey full for social media and for Internet. Both candidates begin celebrate last night say na dem win di senatorial election for di district.

    State INEC oga, Mike Igini say di reason why dem neva announce di result for di area na because of insecurity for Ikot Ekpene wey be di headquarters of di district.

  17. Benue INEC dey beg politicians

    INEC state collation officer for Benue State, Sebastian Maimako don begin beg politicians dem and di collation officer for Vandeikya local goment dem make dem allow election result reach di centre so dat e go quick finish im work.

    E say weda politicians like di election go must finish. Although dem start di collation on Sunday, most local goment officers dem still dey struggle wit dia result sheet.

  18. Abba Moro dey go Nigeria Senate

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, Benue, Nigeria

    Dem don declare Abba Patrick Moro of di People’s Democratic Party as di winner of di Benue South senatorial election.

    Di PDP Candidate get 85,162 votes to beat im closest rival, Ochagwu Steven Lawani of APC wey score 47,721. Mike Okibe Onoja of SDP come third with 29,901.

    Oga Moro, na former minister under former presido Goodluck Jonathan and na under am im ministry bin wan employ pipo wey lead to 20 pipo death for 2014. Im mata dey court now say im hand follow kill di pipo for how dem take do di application, but im say im dey innocent.

  19. INEC no go conduct anoda election for some parts of Rivers State

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    INEC say dem no go conduct anoda Presidential and National Assembly election for Akuku Toru and Bonny local goment for Rivers State.

    Di state collation officer Prof. Eniefiok Essien tok dis one for di result collation centre for Port Harcourt. Plenti gbege bin happun for dis two local goments on Saturday wey make officials no deploy materials so election no hold at all at all.

    For Akuku Toru, di gbege wey happun lead to di death of six boys and one lieutenant for Nigerian Army.