You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. , Former presido Goodluck Jonathan don show to vote

  2. , INEC officials as dem show for polling units

  3. If we no win, dat na wetin Nigerians want - Peter Obi

    Di vice-presidential candidate of di People's Democratic Party, oga Peter Obi don vote for im ward for Agulu village for Anambra State, southeast Nigeria.

    For short speech wey im make afta im vote, im say if im party no win, dat na wetin Nigerians want.

  4. , Voting neva start for Adams Oshiomole polling unit

    Dem still dey range things ast at 8:52am for di polling unit of di chairmo of di All Progressives Congress oga Adams Oshiomole.

  5. , Pikin dem wey no fit vote for Kano State, get dia own thing wey no concern voting

  6. Voting neva start for many polling units for southern Nigeria states

    BBC tori pipo wey dey ground for southern Nigeria states dey report say voting neva begin by 8am.

    As at 8:25am, BBC tori pipo see INEC staff wey just dey arrive or still dey set up.

    For Cross Rivers, Rivers, Edo, Akwa Ibom, Bayelsa and Delta, different polling units neva begin vote even though voters dey ground.

  7. Buhari don vote for im village Daura

    Nigeria presido Muhammadu Buhari and im Aisha don vote for dia polling station for Daura.

    Im vote for im ward wey be Sarkin Yara.

    Im tell tori pipo say im go congratulate imsef, becos im know say im go win.

  8. How payment of allowee, transport and security delay early start of vote for Makurdi

    Election for Makurdi, Benue State capital for north central Nigeria start late for Walamayu ward as some adhoc staff say dem no go go dia polling unit go work except INEC pay dem dia N4,500 allowee.

    Di INEC staff bin suppose deploy to Wallamayu area and e get about 40 polling unit under am. Some oda group complain say dem no go fit go dia polling unit because no security official dey to join dem to di polling unit. Even transport to cari di material go do polling unit no dey.

    INEC official say na since 6: 30 am na im dem distribute material but motor neva dey to transport am. She also explain give say dem don pay a few adhoc staff but gatz suspend am because di tin dey take time. Dem don beg di adhoc staff make dem dem go dia polling unit as dem go go dia go pay dem dia moni.

  9. Voting don begin for some parts of Nigeria

    As clock nack 8 sharp, many polling units open for different parts of Nigeria.

  10. Voters don begin line up for Abuja

    Many voters don begin show for Dutse Alhaji, inside Abuja. Many of di voters say dem show early dis morning for di polling station wey dey one primary school before 6am to make sure say na dem first vote.

  11. , Election bodi INEC full ground to hear from you. If you see anything you go wan report, see dia numbers.

  12. , Election officials don arrive

    Members of di National Youth Service Corps wey be polling officers wey dey run things on election day don tanda for different areas for Nigeria.

  13. No allow your PVC waste - RMD

    Nollywood oga Richard Mofe-Damijo aka RMD cari scope enta inside BBC Pidgin studio. Im dey ginger young pipo make dem remember di power wey dey dia hand.

  14. Na hia PDP candidate Atiku go vote

    Dis na di polling unit wia presidential candidate of di People's Democratic Party Atiku Abubakar go vote for Adamawa State. Pipo don begin gada to wait for voting to begin.

  15. One kontri, different cities.

    Market don open around di area wia PDP vice-presidential candidate Peter Obi dey live for Anambra State, southeast Nigeria. Di kweshun na weda dis pipo no go vote?

  16. Bomb blasts for Maiduguri, gunshots for Yobe

    Pipo for Maiduguri, di Borno State capital for northeast Nigeria wake up wit sound of plenti bomb blasts on elecrtion day.

    Tori be say e reach seven explosions wey nack di city. Borno State don get plenti wahala from Boko Haram ova di years even as goment don claim "technical defeat" against di militant sect.

    As da one dey happun, pipo for Yobe State also for northeast, hear gunshots wey make dem run comot for di Geidem area wia pipo bin don dey line up for voting.

  17. First time voter

    Pipo don begin line up for Shagari Clinic polling unit for Yobe State, northeast Nigeria and one of dem na Ahmad Abubakar wey be first time voter.

  18. , Voters don begin line up for Taraba State

  19. , Di positions Nigerians go vote for on Saturday.

  20. 5.30 am, Edo State south-south Nigeria

    Dis early mor-mor, staff of election bodi INEC for Benin, di Edo state capital don begin range voting things to begin waka. Na from 8am voting proper go start, but pipo go begin line up before then.