Nigeria 1-0 Egypt reactions: Iheanacho goal see Super Eagles defeat Pharaohs

Host of di 2021 Africa Cup of Nations, Afcon, Cameroon beat Burkina Faso to win di opening game of di tournament.

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Play on

    80' - Burkina captain Betrand Traore complain of Handball, referee check am say make dem play on.

    Game kontinue

  2. Aboubakar miss

    77' - Aboubakar don miss chance to score hat trick for Cameroon.

    Im right foot shot from outside di box miss di target as di ball go over

  3. 15 minutes to go

    74 - Anguissa dey close to score from di edge of box 18 wit im low shot. Di shot dey close but na corner for Cameroon.

    Burkina Faso change formation to 4-3-3 as na only 15 minutes remain for dis match

  4. Substitution

    68' - Cameroon dey change two players.

    Abdoul Tapsoba and Cyrille Bayala don comot

    Eric Maxim-Choupo Moting and Clinton N' Jie don enta for Cameroon.

  5. Referee say play on...

    65' - Burkina Faso hold di ball.

    Dem play am go outside.

    Cameroon fall for Burkina area, ref say play on.

  6. VAR confam no goal

    Referee wait for di decision from VAR to confam weda na truly offiside.

    61' VAR say 'no goal' e remain as e bi Cameroon 2 - 1 Burkina Faso.

  7. Offside goal

    58' Cameroon don score again but lines man cancel am say na off side. Na Abubakar di Captain wey don score two goals already cari ball run from midfield bifor im give pass to Ngamaleu. Burkina Faso goalie - Koffi block am but di ball hit Abubakar enta net. But di mata dey for VAR now as dem dey check weda na offside.

  8. Corner kick to Burkina Faso

    54' - Burkina Faso near Cameroon goal post but defender clear di ball.

    Di Stallions dey push for equaliser and nearly score but Cameroon defend di ball again.

  9. Close one...

    50' - Cameroon bin wan score but dem play ball enta Burkina Faso goalkeeper Koffi hand.

    Di first five minutes of di second half so far don see Burkina Faso get di uppergand but dem still dey behind, 2-1.

  10. Game start!

    46' - Na Cameroon restart di second half.

    But soon lose di ball to Burkina Faso wey quickly win freekick near Cameroon 18-yard box afta Ngameleu foul Tapsoba.

    From di resultant free-kick Onana produce good save to deny di Stallions.

  11. Half time!

    We dey half time o - Cameroon 2 - 1 Burkina Faso.

    E sure say second half go sweet pass

  12. Aboubakar perfect second-half penalty

    45 +3' - Na add on time for first half we still dey na im match turn commot Burkina Faso hand - Anoda penalty for Cameroon.

    Na Burkina Faso defender Dayo make bad tackle for box 18.

    Aboubakar step up slide di ball past goalie - dis time e use stop start style again and e put am for di oda side now 2-1.

    Di Indomitable Lions don dey roar - crowd sef dey roar.

  13. Breaking, Cameroon score again!

    Cameroon dey lead 2-1 wit anoda penalty

    Score card
  14. Half time... Soon

    46' - Half time go soon reach - Wit one minute added time for dis half

  15. Cameroon fowl Burkina Faso

    42' - Cameroon defender Jerome Onguene foul Burkina Faso player.

    44' - Match bin stop temporarily as dem cari di Burkina Faso player comot from pitch

  16. Cameroon 1-1 Burkina Faso

    Vincent Aboubakar

    Wia dis foto come from, Getty Images

    40' - Na well taken penalty - Aboubakar use di stop - start style to play am - e send goalie go di opposite side.

    Indomitable Lions don roar back 1-1.

  17. Breaking, Cameroon score!

    Its a goal!

    Cameroon Abubakar score di penalty

    Score Card
  18. Penalty for Cameroon

    40' Cameroon don win penalty afta Dayo no 14 for Burkina Faso tackle two Cameroon players for near 18 yard box

  19. Afcon group stage go experience VAR

    Di 2021 edition of Afcon go witness di use of Video assistant referees (VAR) for all 52 matches for di first time.

    Caf use di technology from di quarter-finals for di 2019 edition of di tournament wey Egypt host.

    Di African football bodi don select 24 referees, 31 assistant referees and eight video assistant referees from 36 kontris for di tournament in Cameroon, Rwandan referee Salima Mukansanga dey among four female officials.

    Two officials from North and Central American and Caribbean football confederation Concacaf, Guatemalan referee Mario Escobar and Mexican VAR official Fernando Guerrero go also dey included as part of inter-confederation skills exchange program.

  20. Yellow card for Burkina Faso

    Patrick Malo of Burkina Faso collect Yellow Card for foul.

    Na di second Burkinabe to receive yellow afta Steve Yago for di opening minute of di match.

    Di free-kick result to nothing as Bertrand Traore block di cross.