Nigeria 1-0 Egypt reactions: Iheanacho goal see Super Eagles defeat Pharaohs

Host of di 2021 Africa Cup of Nations, Afcon, Cameroon beat Burkina Faso to win di opening game of di tournament.

Live Coverage

Helen Oyibo and Moseph Ekine

  1. Fans of Nigeria celebrate outside Garoua stadium

    Fans of Super Eagles don begin celebrate outside di Roumdé Adjia Stadium.

    Nigeria dey lead 1-0 afta 88mins but di game never finish

  2. 83' Corner kick to Egypt

    Egypt win corner kick afta Aina head Abdelmonem cross out of corner kick.

    From di corner wey Zizo take, Hegazy looping shot bin dey too high to dey on target as Okoye watch di ball go out for goal kick.

  3. 78' Omeruo injured

    Di medical team don carry Omeruo comot from field as im no fit continue di game. E no dey clear wetin happun to di Leganes defender but Ajayi don come ON to replace am.

    Coach Austin Eguavoen also send on Kelechi Nwakali to replace di goalscorer Iheanacho.

  4. 76' Ejuke test El Shanawy

    Chidera Ejuke wey just come on for Nigeria don test di palms of El Shanawy.

    Di moscow-based midfielder receive pass froom deep inside di box, im control am come shoot shot but El Shanawy bin dey dia to save am.

  5. 72' Nigeria make subsitutions

    Super eagles don make two substitutions as Sadiq Umar don come ON for Taiwo Awoniyi.

    Chidera Ejuke don also replace Samuel Chukwueze.

  6. 71' Salah Chance!

    Mohammed Salah beat di Nigeria offside trap as im run wit di ball towards Maduka Okoye, di Liverpool man poor shot dey tame as Zaidu Sanusi clear di ball from going in.

  7. 67' Zizo shot dey bloacked

    Egupt substitute Zizo find himself beyond Nigeria last defender, but di referee stop di game afta di linesman signal for offside.

    Later on Aina use body block Zizo volley as Egypt don begin to press Nigeria.

  8. 65' Nigeria come close to score second

    Iheanacho almost score im second of di game from Wilfred Ndidi pass.

    Di 25-year-old strong left shot go wide as Egypt defence look troubled.

  9. 63' Aina try im luck from outside

    Aina look to double Nigeria lead as im decide to take matters into im hands.

    But im ambitious shot from 20-yards fly well ova di bar.

  10. 58' Substitutions for Egypt

    Egypt make dia third and fourth substitution.

    Trezeguet OFF, Zizo ON

    Mostafa Mohammed OFF, Ramadan Sobhi ON

  11. 57' Iheanacho miss control deny Nigeria chance of second goal

    Nigeria rightback Ola Aina make good run into di box as di egypt defenders no fit stop am but im push di ball too much as Hegazy block am finally.

    But di ball land for Iheancho wey im first touch let am down as im bin get good chance to increase Nigeria lead.

  12. 52' Awoniyi head corner wide

    Awoniyi jump high to connect wit Moses Simon cross but im header go wide.

  13. 48' Nigeria hit di bar!

    Nigeria striker Taiwo Awoniyi near post header hit cross bar afta save from Taiwo Awoniyi.

    Awoniyi celebrate as im tink say di ball don cross di line after El Shenawy save im header on di line.

    But di ref no agree..

  14. Second half don start

    Egypt make half-time substitution as coach Queiroz bring ON Ayman Ashraf for Ahmed El Fotouh.

    Nigeria pass di ball as di second half don start.

  15. Quiet Salah

    So far di Super Eagles defence of Kenneth Omeruo and William Troost-Ekong don succeed to keep Liverpool forward Mohammed Salah quiet as im don dey starved of service.

    Salah
  16. First half statistics

    Ball possesion: Nigeria 46% - Egypt 54%

    Goal attampts: Nigeria 5 - 1 Egypt

    Shot on goal: Nigeria 2 - 1 Egypt

    Corner kicks: Nigeria 1 - 0 Egypt

  17. Half time: Nigeria 1-0 Egypt

    Referee Bakary Gassama blow di whistle to end di first half.

    So far Nigeria dey lead 1-0 thanks to 30th minute goal from Kelechi Iheanacho

    Iheanacho give Nigeria lead
  18. Moses Simon dey worry Egypt

    Abdelmonem dey experience tough time as Nantes mdfileder Moses Simon dey cause am problems for right-back.

    Referee add three minutes added time before di first half go end.

  19. El Shanawy save!

    Egypt goalkeeper El Shenawy save end sweeping move for Nigeria as im save di shot from Taiwo Awoniyi.

  20. 39' Ndidi try im luck from distance

    Samuel chukwueze make dancing run into Egypt half wia im come fine Wilfred Ndidi wit pass.

    Di midfielder left foot attempt from outside di box drift wide as El Shenaawy fit only watch di ball go ova.

    Nigeria still dey press egypt so far.