Game on
- 2' Corner, Ghana. Conceded by Nayef Aguerd
- 4' Ghana get freekick but dem.play am go corner.
Host of di 2021 Africa Cup of Nations, Afcon, Cameroon beat Burkina Faso to win di opening game of di tournament.
Helen Oyibo and Moseph Ekine
1' - Time don reach o, match don start

Wia dis foto come from, Getty Images
Former captain Asamoah Gyan no go play this Afcon but Andre Ayew go lead new Black Stars players Kamaldeen Sulemana, Fatawu Issahaku, Joseph Paintsil, Mohammed Kudus who don remain for hin club talk say hin get injury.
Ghana don include five players from de Ghana local league na de youngest player Fatawu Issahaku who win best player for de Africa U-20 Championship bi de player wey everybody for Ghana dey talk say e go blow for dis tournament.
Morocco complain say covid dey worry demma players including Soufian Boufal who dem dey expect to replace Hakijm Ziyech but still players like Paris Saint-Germain Achraf Hakimi, Barcelona's Ez Abde and Wolve`s Roman Saiss dey.
See how di Black Stars show for dia game wit Morocco.

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana no fit win de Afcon since 1982.
Dis year, de Black Stars dey for Group C plus Morocco, Guinea den Comoros.
Na de North Africa boys bi de ones wey Ghana go meet for Monday inside de Ahmadou Ahidjo Stadium for Yaounde.
Already Morocco go play di Afcon minus dema star player Hakim Ziyech as coach Vahid Halihordzic talk say de Chelsea player no dey show commitment for hin country side wey Covid don catch plenty of dema players.
Ghana coach go thank God sey na hin no get that problem because after dem do covid test, Ghana go come out clean mean say covid no dey demma camp.
Ghana don attend de Afcon 23 times wey claim de trophy four time inside 1963, 1965, 1978 and 1982 but Morocco attend 18 win only one for inside 1976.
Morocco don win de Afcon once for 1976 and dem take part for de competition 17 times.
Morocco
Formation 3-4-3
Substitutes
Ghana
Formation 4-4-2
Substitutes
Referee:Joshua Bondo

Meanwhile, for di match wey just end between Senegal and Zimbabwe, Senegal win Zimbabwe 1-0 on penalty for dia first game for Afcon 2021.
Sadio Mane score for inside extra time to give im team di lead afta Kelvin Madzongwe (Zimbabwe) concede penalty with hand ball for di penalty area for inside di last minute of extra time.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di match between di Atlas Lions of Morrocco and di Black Stars of Ghana go hapun for di Ahmadou Ahidjo Stadium for Yaounde, Cameroon.
Kick off time na 5:00pm
Welcome to our live coverage today of di game between Morrocco and Ghana for di Afcon 2021 wey dey hapun for Ghana.
We go bring una all di updates, highlights and tori of how di game waka.
Na here we go end our live coverage of Afcon 2021 today.
In case you just dey join us, Cameroon di host kontri waya Burkina Faso 2-1 on penalties to win di opening match.
Di Indomitable Lions Captain Vincent Aboubakar score di two penalties to epp im team win.
Make una join us again tomorrow as we go dey here live with all di updates from 4:00pm of di Black Stars of Ghana Vs di Pharaohs of Egypt game wey go kick off by 5:00pm.
Until den, una bye-bye.
Meanwhile di oda game for group A go see Ethiopia take on Cape Verde for di Olembe stadium.
See how fans of di Indomitable Lions of Cameroon dey celebrate di victory of dia team as dem waya Burkina Faso 2-1 on penalty.

Wia dis foto come from, Getty Images
Star of di match Vincent Aboubakar don react to im kontri win. According to am, “De important tin na for win, pick three point Komot wit head high for de game de see how for progress for dis competition." Aboubakar tok.
Fans of cameroon turn up for Olembe staduim, di venue wia Cameroon beat Burkina Faso 2-1 for di opening match of Afcon 2021.
Di Indomitable Lions now get three points and go next play Ethiopia on Thursday for dia second group game.
Meanwhile Burkina Faso next game na against Cape Verde on di same day.


FT: Cameroon 2-1 Burkina Faso
Host Cameroon beat Burkina Faso 2-1 for Olembe staduim.
Two penalties from Vincent Aboubakar help Cameroon beat Burkina Faso for di opening match of 2021 Afcon.

90+4 - Burkina get trow in for goal area
Na Burkina last chance to equalise o
90' - Referre add five minutes injury time...
87' - Cameroon don comot dia captain and star player for today, Vincent Aboubakar - na im score two goals for dis match and e be di highest goal scorer for di tournament for now.
Coach Conceicao bring ON Yvan Neyou to replace di former Porto striker.
86' - Burkina Faso make subsitution as dem commot Bertrand Traore bring in Hassane Bandé.
82' - Aboubakar get chance to shoot and e shoot but e dey wide - na seven minutes remain.
Cameroon win di ball from Guira but e result to nothing as both sides don dey run out of ideas on use of di ball as di 90th minute don dey reach.