Winners, losers and full details of governorship election for Kogi, Imo, Bayelsa
Pipo of Imo, Kogi and Bayelsa state don decide who go govern dem for di next four years.
Live Coverage
Victor Ezeama and Helen Oyibo
'We hear gunshot' - Sam Anyanwu tok as e cast im vote
Di Imo state PDP govnorship candidate Samuel Anyanwu don cast im vote for Amaimo Central School polling unit for Ikeduru Local Government Area.
Wen e address tori pipo, Anyanwu say dem hear gunshot for im polling unit.
E tok say any wia wey violence dey for di election, make Inec ensure say di votes no count.
In fotos: How pipo take cast dia votes for Imo elelction
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
Election still dey go on for Imo State wey dey among di states where pipo dey currently elect who go lead dem for di next four years.
Some polling units wey BBC News Pidgin visit experience low voter turnout.
“Make una come for accreditation oh,” one of di officials of di Independent National Electoral Commission (Inec) tok as pipo no dey around to vote.
Dis na fotos of how pipo cast dia votes for di state.
INEC respond say dem dey investigate di ‘forged election results’ for Kogi state
Wia dis foto come from, Yiaga Africa
Di Independent National Electoral
Commission INEC say dia senior officials don begin investigate one alleged
electoral magomago for Ogori/Mangogo area of Kogi state.
Di kontri electoral body for inside
statement tok dis one afta reports allege say dia staff dey present result
sheets wey dem don already fill.
“Our attention de drawn to report say
dem discover filled result sheets for some polling units for Kogi state.” INEC
tok.
Di govnorship candidate of di Peoples
Democratic Party for Kogi state, Dino Melaye bin raise alarm and allege say voting
no dey go on for Ogori Magogo area of di state sake of say electoral officers
for di area don dey compromised.
Dis na afta one
civil society organisation for Nigeria bin ask di electoral body to investigate di forged election results from some polling unit wey
dey circulate for Kogi state.
YIAGA Africa say dem receive report of results
sheets wey dem don fill for PU 004, Eni Ward of Ogori/magongo area for di north
central state.
YIAGA sharpely tell di election office to address
di mata so dat mago- mago no go dey for di election process.
Dem post photo of di result sheet wey show say di
ruling All Progressive congress party get 200 votes out of di 207 valid votes
for dat unit.
Di commission for dia response say dem dey view di
situation seriously and dem go communicate dia decision soonest.
18 candidates dey contest for di govnorship election, di top three candidates for di race na PDP Dino Melaye, APC Ahmed Usman-Ododo and SDP Murtala Ajaka.
Breaking, We gatz stop off-season Elections for Nigeria – Ex President Jonathan
Wia dis foto come from, Goodluck Jonathan/Facebook
Former President Goodluck Jonathan
don call on di National Assembly to stop off-season elections for Nigeria.
Jonathan tok dis one after e cast im
vote for di ongoing governorship election for Otuoke, Ogba LGA Bayelsa State.
E say off-season election no be best
global practice amd di National Assembly must do something about am so dat evri
State for Nigeria go do election at do same time.
"If we continue wit dis trend
of off-season election based on di interpretation of our laws by di Judicial
officers, e go come to a time Na so e tok wen even di Presidential election
maybe season."
Di former Nigerian leader urge
citizens for states wia govnorship elections dey hold to dey lawful as dem dey
carry out dia civic duties.
Dino Melaye allege election magomago for Ogori/Mangogo
Wia dis foto come from, Senator Dino Melaye/Twitter
Govnorship candidate of di Peoples
Democratic Party for Kogi state, Dino Melaye don allege say voting no dey go on
for Ogori Mangogo area of di state sake of say electoral officers for di area
don dey compromised.
Oga Dino for one video e post on
Twitter account allege say INEC staff no gree show agents result sheet and di results
sheet don dey tampered wit as dem don already feel am.
E claim say protest dey go on for di
area and pipo no gree do accreditation and vote sake of di magomago.
E say make all im agents across di
state no vote and accredit if dem no see clean result sheet before di accreditation
start.
To support im claim, Yiaga Africa,
one ogbonge Non-Government Organization wey dey shook body for election mata,
say dem don receive report of pre-filled result sheet fpr Polling Unit 004, Eni
Ward for Ogori/Mangogo for Kogi state.
Dem ask di kontri electoral body,
INEC to torchlight di mata.
Sam Anyanwu, Athan Achonu, odas dey drag power from Hope Uzodinma
Election observer tok why pipo no too come out to vote for Owerri
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
Wetin we call dis foto, Faith Nwadishi tok say di state capital dey peaceful as election dey go on
One of di election observers for di Imo State govnorship election Faith Nwadishi tok say wetin dem don observe so far na voter apathy and peaceful atmosphere.
Di observer wey come from Transparency Advocacy say dem observe say pipo no too come out to vote sake of some reasons.
Wetin we call dis foto, Pipo no too come out to cast dia votes for Ikenegbu Girls Secondary School I for Owerri, Imo State
Nwadishi tok say one of di polling units for Ikenegbu Girls Secondary School na di third polling units wey dem don visit and wetin dem observe be say na few pipo dey come out to vote.
"Dis na sake of di kain speeches, violence before di election," she tok.
According to Nwadishi, security officials dey go about dia duties for di election and evri wia dey peaceful.
Bayelsa State govnor Duoye Diri don cast im vote
Wetin we call dis foto, Bayelsa state govnor, Duoye Diri don cast im vote
Bayelsa state govnor, Douye Diri don cast im vote for im polling
unit for Kolokuma Opokuma local goment area of di state.
E cast im vote around 8.30 am on Saturday, 11 Nivember.
Govnor Diri na di first govnor wey go cast im vote for di
govnorship election wey dey hold for Bayelsa, Imo and Kogi states.
64-year-old Sen Douye Diri of di Peoples
Democratic Party PDP na di Governor of Bayelsa State wey dey seek a second term
in office.
Diri hail di Independent National Electoral
Commission, INEC say im di exercise for im polling unit dey smooth.
“Dis na improvement for all elections I don do. E
dey very smooth and very fast. INEC don improve on dia processes and training
of dia staff,” di govnor tok.
Di govnor however tok say e too early
for am to comment on wetin dey happun for oda parts of di state wey di exercise
dey gpo on.
E also raise alarm say dem no dey
allow members of im party, di Peoples Democratic Party PDP to go dia polling
units go vote for Nembe Basambiri area.
E say dem must allow PDP members vote
for Nembe Basambiri wit BIVAS during dielection
process.
Govnor Diri say im don already
informate electoral body chairmo of di situtation for Nembe Basambri.
Who go take over from Yahaya Bello for tight Kogi 2023 election
INEC say dem no remove password to upload result for Imo state
Independent National Electoral Commission don deny tori wey
dey fly up and down say dem remove di password from some local goment supervisors
for Imo state to upload result.
Inec tok say dem no withdraw
di passwords for di supervisors for APO1s.
Dem say according to law na di presiding offers dey responsible to upload results
for IReV, no be APO1s.
INEC add say dem don release all di password to di right
officials.
Residents for Imo, Kogi and Bayelsa dem vote on Saturday
November 11 to elect govnors wey go rule dem for di next four years.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Light no dey, pipo dey vex - Imo voter tok
Article Information
Author, Tunde Ososanya
Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
Low voter turn out dey for Ikenegbu Girls Secondary I, Polling unit 001 and one of di voters wey follow BBC News Pidgin tok say na sake of say pipo dey vex.
Wetin we call dis foto, Ifeanyichukwu Iwu bin cast im vote for Ikenegbu Girls Secondary School I polling unit 001.
Ifeanyichukwu Iwu say pipo of di state dey vex say light and water no dey for di state and na why some of dem no come out to vote.
Iwu also tok say di heavy security presence dey fear di pipo instead of giving dem confidence to come out to vote.
E say for di last govnorship election for di state, na ova 300 pipo dey queue to vote.
Heavy security as election open for Kogi state
Article Information
Author, Tamara Ebiwei
Role, BBC News Pidgin
Wetin we call dis foto, Heavy security for Kogi state
Heavy security presence dey for Lokoja di Kogi state capital, as residents dey go dia polling units.
Even though the streets dey calm, BBC perceive tension and hostility for di capital.
No movement dey eefective for Bayelsa state
Major roads
and streets of Yenagoa di Bayelsa State capital dey free as pipo dey observe di
no movement order wey Inspector General of Police Kayode Egbetokun give for di
three States wia di off-cycle elections dey hold.
Security
agencies dey strategically located for most streets and junctions to enforce di
no movement order and na only those on essential and election duty wey dey duly
accredited dem dey allow pass.
Distribution
of election materials from Registration Areas to di polling units suppose dey
go on now
Bayelsa Governorship Election: INEC confam kidbap of SPO, boat capsize
Governorship
election go hold for Bayelsa State dis morning for all di 2244 polling units
for di off-cycle governorship election wey Independent National Electoral
Commission go conduct for three states.
But Inec don
confam di abduction of a Supervisory Presiding Officer (SPO) assigned to
Registration Area – 06 (Ossioma) for Sagbama local goment area of di State late
Friday 10 November 2023 as dem dey distribute sensitive materials to
Registration Areas for di eight LGAs of di State.
For
statement wey di Inec head of voter education and publicity, Wilfred Ifogah
sign, say dem kidnap di SPO, wey dem no give im name as e dey wait to board a
boat to im area of assignment for Amassoma Jetty.
Ifogah add
say anoda boat wey dey carry electoral personnel to Registration Area 17
(Koluama) for Sagbama local goment areaalso capsized, but no life loss as dem rescue all di 12 personnel and di
boat operator.
“We,
however, lost our result sheets, power banks and luggage wey contain personal
effects of staff," e tok.
Di total
number of registered voters for di affected Registration Areas na 5,368 and di
number of PVCs wey dey collected na 5,311.
Di statement
add say Inec dey make efforts to ensure say dem conductelection for di affected area even as den don
notify security agencies.
Una welcome!
Dis na di live election coverage of di off-cycle election for Imo, Kogi and Bayelsa states.
BBC News Pidgin correspondents dey all di states wey di election dey happun and we go dey bring una live updates of events as e dey happun.
Make una tanda wit us for dis live page from now till wen dem begin call results.