Breaking, APC win Lokoja LGA for Kogi state
LGA: Lokoja
Registered Voters: 157248
Accredited voters: 36526
APC : 19105
PDP: 4028
SDP: 10380
Total valid votes: 34932
Rejected votes: 1208
Total votes cast: 36140
Pipo of Imo, Kogi and Bayelsa state don decide who go govern dem for di next four years.
Victor Ezeama and Helen Oyibo
LGA: Lokoja
Registered Voters: 157248
Accredited voters: 36526
APC : 19105
PDP: 4028
SDP: 10380
Total valid votes: 34932
Rejected votes: 1208
Total votes cast: 36140
Dis na di breakdown in data of how SDP win Igalamela-Odolu LGA for Kogi state and how di oda top two perform.

Wia dis foto come from, BBC News Pidgin
Registered Voters: 77577
Accredited voters: 27365
APC : 2975
PDP: 140
SDP: 23185
Total valid votes: 26665
Rejected votes: 696
Total votes cast: 27361
No cancellation
Collation of results don resume for di Kogi state govnorship election afta dem bin go on break.

Wia dis foto come from, Facebook/biodunoyebanji
Govnor Biodun Oyebanji of Ekiti state don send im own message to Govnor Hope Uzodinma wey Inec just announce as di winner of Imo state election.
According to Govnor Oyebanji, di re-election of Uzodinma for second term na a well-deserved one.
“Dis victory reaffirms di strong standing wey our party get for Imo state and nationwide, e show say di pipo dey satisfied wit wetin Govnor Uzodinma do as first-term achievements,” Oyebanji tok.
Di govnor wey also dey under APC tok say di win na based on di confidence wey di pipo get for Uzodinma and e also ‘show a vote of confidence for di goment of President Bola Ahmed Tinubu'.
Govnor Oyebanji appreciate di pipo of Imo state for di way wey dem vote peacefully for di election on Saturday as im also hail Inec, security agencies and di media for dia role to ensure fair electoral process.

Of di six local goment results wey INEC don announce for Bayelsa State for di governorship election, di All Progressives Congress, APC, don win one local goment area - Nembe while di People’s Democratic Party, PDP, win five LGAs.
Di local goment areas wey dem don announce dia results na Kolokuma/Opokuma, Ogbia, Yenagoa, Sagbama, Nembe and Ekeremor LGA.
Di local goments wia PDP win na Kolokuma/Opokuma, Ogbia, Yenagoa, Sagbama and Ekeremor LGAs.
Results still dey expected from di two remaining LGAs wey be Brass and Southern Ijaw.
Di State Collation Officer, Prof. Farouk Kuta adjourn di announcement of results to 6:00pm.
From di reports from di LGA Collation officers , election for many wards and polling units dey cancelled sake of disruptions, abduction and snatching of election officers and staff as well as obstruction of di deployment process.
By pass of di use of BVAS na anoda reason wey make dem cancel elections for some wards and polling units especially for Nembe, Sagbama and Ekeremor LGASs.
Many of di party agents protest di results wey dey presented but di state collation officer ask dem to make a formal complaint of dis observations to INEC so dem go take necessary actions.
Bayelsa Collation Centre don match break till 6:00pm to continue with di declaration of results.
So far, na only two local government - Brass and Southern Ijaw - remain for dem to announce afta dem call six already.
Na eight local government areas dey Bayelsa.
Dis na di breakdown of how PDP win Ekeremor LGA for Bayelsa state and how di oda top two perform.

LGA: Ekeremor
Registered voters: 146649
Accredited voters: 32066
APC: 8445
LP: 50
PDP: 23172
Total valid votes: 31741
Rejected: 279
Total votes cast: 32020
Inec say dem go resume result declaration for Kogi state govnorship election by 7:00pm.
Inec bin don call results of 18 local government areas and wetin remain na just three.
dem bin go on break around 2:30pm to resume by 4:00 pm before dem dey move am now to 7:00pm

Wia dis foto come from, ICPC/X
Di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) say dem don arrest six pipo wey buy votes for Imo state govnorship election.
Di commission for dia X page (formerly Twitter) tok say dia officials arrest di suspects for seven poling units wey dey for Owerri wit ova four million naira cash.
Di commission tok say one of di suspect carry notebook wey contain di phone numba and information of di voters.
“Di suspects, we arrest dem for seven polling units for Orji Mechanic Village (PU 008), Concord Hotel (PU 009), Rento Hotel (PU 010), Township School (PU 005, 007, 008) and Ojukwu Library, and we recover N4,101,750 from dem,” ICPC tok.
“All di suspects dey custody, and we don collect dia profile and statements.
We don release dem on bail as we dey continue wit investigation.”

Wia dis foto come from, Facebook/HopeUzodinma
Senator Hope Uzodinma wey be di newly re-elected govnor of Imo state don tok afta Inec declare am winner.
Uzodinma tok say na di trust wey di pipo get for am make am win di election and im go continue to dey deliver all di promises wey im make during im campaign.
“As we dey embark on di Next Level of Shared Prosperity, make you dey rest assured say your interests go remain for di forefront of my administration, Uzodinma tok.
Di govnor also extend greetings to im opponents and im ask make dem join hand wit am to build di state.
Uzodinma also commend Inec, dia officials and security sake of say dem ‘ensure fair and neutral electoral process.’
Govnor Uzodinma add say President Bola Tinubu na great leader wey guide am through di period of di election.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Breakdown of how APC win Nembe LGA for Bayelsa and how di oda top two perform.

LGA: Nembe
Registered voters: 99035
Accredited voters: 27404
APC: 22248
LP: 113
PDP: 4556 Total
Valid votes: 27036
Rejected: 264
Total votes cast: 27300
Breakdown of how PDP win Sagbama LGA for Bayelsa state and how di odas do.


Sagbama Registered voters: 138832
Accredited voters: 42879
APC: 6608
LP: 217
PDP: 35504
Total valid votes: 42467
Rejected: 393
Total votes cast:42860
Inec don resume from dia break to continue to call di results for Bayelsa state.

Di collation of di Kogi state govnorship election dey on hold for 1 hour 30 minutes.
Dis na break time, to allow pipo rest small as dem dey wait for results from oda Local goment Areas.
Dem announce say collation go resume around 4pm as dem dey wait for di remaining three Local Goment Areas to bring dia results.
So far, dem don collate and announce results from 18 LGAs out of di 21 LGAs for Kogi state.
Di LGA's wey remain na Lokoja Ibaji, Lokoja and Igalamela-Odolu.
Collation of results bin start on Sunday mornimg 12 November, 2023 around past 11 a.m