Winners, losers and full details of governorship election for Kogi, Imo, Bayelsa

Pipo of Imo, Kogi and Bayelsa state don decide who go govern dem for di next four years.

Live Coverage

Victor Ezeama and Helen Oyibo

  1. Breaking, Inec confam say some pipo don hold dia officials hostage for Brass

    Inec Chairman, Prof. Mahmud Yakubu

    Wia dis foto come from, INEC/FACEBOOK

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don raise alarm say armed men hold dia officials hostage for Brass local goment area of Bayelsa state.

    Dis na as collation of govnorship election results dey go on for di state.

    Di commission say di situation dey detrimental to credible elections for di state.

    Inec call on security agencies to immediately facilitate di release of di officials.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  2. Lagos govnor Sanwo-Olu congratulate Hope Uzodinma

    Lagos state govnor congratulate newly re-elected govnor od Imo state

    Wia dis foto come from, Facebook/BabajideSanwoOlu

    Wetin we call dis foto, Babajide Sanwo-Olu of Lagos state wit Hope Uzodinma

    Di govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu wey all be di chairman of di Progressives Governors Forum (PGF) don send congratulatory message give di newly re-elected govnor of Imo, Hope Uzodinma.

    Sanwo-Olu for im statement on Sunday say di pipo of Imo state na di real winners sake of say dem believe in Uzodinma to be re-elected for second term.

    “Na assurance to us say di APC goment for di state and national levels dey do do sometin right.,” Sanwo-Olu say for im statement.

    Di govnor say im party go work on areas of improvement and dem go ‘give Nigerians di best of wetin dem deserve.’

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. Breaking, Protest dey build up for Yenagoa over declaration of result

  4. SERAP send strong message to Inec chairman ova election malpractice

    INEC Chairman

    Wia dis foto come from, Facebook/Inec

    Wetin we call dis foto, Professor Mahmood Yakubu

    Di Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) don send strong message give Professor Mahmood Yakubu, wey be di Chairman of Inec.

    SERAP say make Inec identify and arrest anybody wey dey sponsor electoral bribery and violence for di off-cycle governorship elections for Kogi, Imo and Bayelsa state.

    Di group also challenge Inec make dem disclose di whole spending wey don follow dis off-cycle governorship elections for di three states go.

    Dem lament di cases of bribery and violence wey don happun so far for diz elections and how e dey dangerous to Nigeria democracy.

    For dia statement as di election dey go on, SERAP say Inec and politicians neva learn any lesson from previous elections.

  5. Breaking, APC condemn plan by Inec to move collation of two LGA results go Yenagoa

    Di All Progressives Congress (APC) don condemn di alleged plan of Inec to go collate votes of Nembe and Southern Ijaw for Yenagoa.

    APC tok say dem confam say di commission wan move collation of votes wey happun for diz two places wey be dia stronghold go di state capital.

    According to di National Publicity Secretary Felix Morka, di plan dey ‘unacceptable’ and suspicious as e go affect di credibility of di Bayelsa election.

    APC call on Inec make dem collate di votes for di respective local goment wey di voting happun bifor dem go carry am go di state collation center.

    “We dey call on Inec to reverse dia unlawful move, make dem collate results for di local goment wey e happun,” Morka add.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Breaking, PDP dey early lead for Bayelsa governorship election

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Di Peoples Democratic Party dey for early lead as dem begin announce results for di Bayelsa State governorship election for di State Collation Centre for INEC headquarters, Yenagoa.

    Di local goments dem announce na Kolokuma/ Opokuma, Ogbia and Yenagoa LGAs.

    Di State Collation Officer, Prof Farouk Kuta, Vice Chancellor, Federal University of Technology Minna, adjourn di collation of results to reconvene by 3pm.

    Hopefully by dat time results from di remaining local goment areas go don ready.

    Local goments wey remain include Brass, Nembe, Sagbama, Ekeremor and Southern Ijaw LGAs.

    Bayelsa State get 8 LGAs wia di election hold.

    INEC Officials
    Wetin we call dis foto, Results from three out of di eight LGAS for Bayelsa State dey announced
    INEC Officers
    Wetin we call dis foto, Collation Officer for Kolokuma/ Opokuma LGA as e dey present di results
    INEC officers
    Wetin we call dis foto, Collation Officer for Ogbia LGA as e present di election results
    INEC Officers
    Wetin we call dis foto, Collation Officer for Yenagoa LGA present im results
  7. Yiaga maintain say Inec gatz clarify places wia election no hold

    Civil society group Yiaga Africa don call on Inec to clarify places wia election and location wia upload of results from polling units no hold.

    Di group through dia chair Dr Hussain Abdu tok say dia observers from nine polling units document how election no take place for some places for Imo state but dem upload dia results for Irev.

    Yiaga dey also call on Inec to investigate reports of election malpractices for places wey accreditation and voting no take place.

    Di group also include say transparency and integrity dey important for dis election and dem go expose any area wey mago-mago dey.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  8. Collation of election result don start for Kogi state

    Kogi decides 2023

    Collation of results for di 2023 Kogi state govnorship election don start.

    Deputy Vice-Chancellor of di University of Nigeria, Nsukka, Enugu state Professor Johnson Urama na di state returning officer for di Independent National Electoral Commission (Inec).

    Kogi state get 21 local goment areas.

    Inec bin suspend election for nine wards for Ogori/Magongo sake of electoral malpractices.

    Kogi state

    LGA: Idah

    Registered Voters: 64339

    Accredited voters: 230044

    APC : 2033

    LP: 10

    PDP: 271

    SDP: 20059

    Total valid votes: 22742

    Rejected votes: 280

    Total votes cast: 23022

    No incidents no cancellations

    LGA: Ogorimagongo LGA

    Registered Voters: 17688

    Accredited voters: 665

    APC : 362

    LP: 1

    PDP: 86

    SDP: 195

    Total valid votes: 658

    Rejected votes: 7

    Total votes cast: 665

    LGA: Yagba West

    Registered Voters: 51234

    Accredited voters: 17152

    APC : 7969

    LP: 3

    PDP: 3010

    SDP: 1002

    Total valid votes: 16738

    Rejected votes: 363

    Total votes cast: 17101

    No cancellation no incidence of any form

    LGA: Okehi

    Registered Voters: 94456

    Accredited voters: 57243

    APC : 53062

    LP: 69

    PDP: 2722

    SDP: 153

    Total valid votes: 57002

    Rejected votes: 174

    Total votes cast: 57176

    No cancellation No incidence everything went smoothly.

    LGA: Yagba East

    Registered Voters: 53436

    Accredited voters: 18001

    APC : 7096

    PDP: 2615

    SDP: 312

    Total valid votes: 17649

    Rejected votes: 344

    Total votes cast: 17993

    Cancellation dey for one polling unit for Itodo RA 9 sake of over voting.

    LGA: Ijumu

    Registered Voters: 66482

    Accredited voters: 20405

    APC : 10524

    PDP: 6909

    SDP: 356

    Total valid votes: 19991

    Rejected votes: 384

    Total votes cast: 20375

    LGA: Mopamuro

    Registered Voters: 26827

    Accredited voters: 9193

    APC : 5077

    PDP: 1562

    SDP: 253

    Total valid votes: 9049

    Rejected votes: 136

    Total votes cast: 9185

    LGA: Adavi

    Registered Voters: 114663

    Accredited voters: 103251

    APC : 101156

    PDP: 1005

    SDP: 268

    Total valid votes: 103105

    Rejected votes: 67

    Total votes cast: 103172

    LGA: Ofu

    Registered Voters: 101964

    Accredited voters: 36087

    APC : 5245

    PDP: 293

    SDP: 28768

    Total valid votes: 35180

    Rejected votes: 587

    Total votes cast: 35767

    LGA: Kotonkarfe

    Registered Voters: 63342

    Accredited voters: 27184

    APC : 14769

    PDP: 2974

    SDP: 8441

    Total valid votes: 26541

    Rejected votes: 308

    Total votes cast: 26849

    Inec cancel results for three polling unit for Kotonkarfe South-east wey get 2216 registered voters.

    Dem cancel di results sake of over voting.

    LGA: Bassa

    Registered Voters: 69376

    Accredited voters: 22276

    APC : 9515

    PDP: 3605

    SDP: 7543

    Total valid votes: 21554

    Rejected votes: 718

    Total votes cast: 22272

    Inec cancel election for 4 Polling Units sake of over voting.

    LGA: Omala

    Registered Voters: 74537

    Accredited voters: 22538

    APC : 2902

    PDP: 832

    SDP: 18160

    Total valid votes: 22317

    Rejected votes: 196

    Total votes cast: 22513

    LGA: Olamaboro

    Registered Voters: 105864

    Accredited voters: 30287

    APC : 5572

    PDP: 1376

    SDP: 22173

    Total valid votes: 29731

    Rejected votes: 495

    Total votes cast: 30226

    LGA: Ankpa

    Registered Voters: 180095

    Accredited voters: 57650

    APC : 8707

    PDP: 3654

    SDP: 43258

    Total valid votes: 56395

    Rejected votes: 873

    Total votes cast: 57268

    LGA: Okene

    Registered Voters: 151243

    Accredited voters: 141898

    APC : 138416

    PDP: 1463

    SDP: 271

    Total valid votes: 141404

    Rejected votes: 134

    Total votes cast: 141538

    LGA: Dekina

    Registered Voters: 187881

    Accredited voters: 60588

    APC : 9174

    PDP: 499

    SDP: 47480

    Total valid votes: 59151

    Rejected votes: 1168

    Total votes cast:60319

    Inec cancel results for two polling units sake of over voting.

    LGA: Ajaokuta

    Registered Voters: 96504

    Accredited voters: 33806

    APC : 23211

    PDP: 483

    SDP: 8869

    Total valid votes: 33173

    Rejected votes: 580

    Total votes cast: 33753

  9. Party supporters carry protest go Inec collation office for Bayelsa

    Protest rock Bayelsa state

    Many supporters of di Peoples Democratic Party carry protest go Inec headquarters for Yenagoa di Bayelsa State capital.

    Dem dey protest di one wey some alleged supporters of di All Progressives Congress no allow dem participate for di elections for Nembe- Bassambiri.

    Di protesters wear black on black and block di road but di security pipo on duty for Inec no allow dem come near di headquarters.

    Dis affect movement to di Swali axis of Yenagoa as di protest make dem no allow vehicles to pass and e make dem increase security vigilance for di area.

    Dey protest say dem no allow dem vote for Nembe- Bassambiri.

    Wia dis foto come from, X

    Wetin we call dis foto, Supporters of di Peoples Democratic Party carry protest go Inec headquarters
    Protest rock Bayelsa state
  10. Collation of results don begin for Bayelsa

  11. Nigerians react to govnorship election results for Imo

    Govnor Hope Uzodimma

    Wia dis foto come from, Hope Uzodimma

    Di ruling All Progressives Congress Party for Imo state win all di 27 local goment areas for di Govnorship election wey take place for 11 November.

    APC party candidate, Govnor Hope Uzodinma defeat 17 oda candidates according to INEC.

    See wetin Nigerians dey tok about di election for social media.

    @agbani22444810 say ‘’Na mumu dey believe INEC’’.

    For @Max1Brownie e say ''hold INEC responsible for all di lapses''

    And for @XrisDwhyner e say ''More like INEC win for all di 27 LGA''.

    Dis na wetin adekola damilola tok e say ''Dis INEC worse pass Maurice Iwu own''.

    Generally pipo no really come out to vote for di different states wey election bin take place dis weekend

    And INEC bin address di mata of forged election result for Kogi state and oda issues for Imo state too.

  12. Inec don suspend election for some locations for Kogi state

    INEC suspend election for some polling units for Kogi state

    Wia dis foto come from, INEC/TWITTER

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don suspend election for di nine wards wey dey Ogiri/Magongo local goment area of Kogi state.

    Di wards include Eni, Okibo, Okesi, Ileteju, Aiyeromi, Ugugu, Obinoyin, Obatgben and Oturu.

    Di electoral body say dem take dis action afta dem receive reports of electoral malpractices, especially cases of result sheet before voting from dia officials for Kogi state.

    “Reports show say incidents occur for Adavi, Ajaokuta, Ogori/Magongo, Okehi and Okene local goment areas. Di most serious incidents occur for Ogori/Magongo, wey arrect nine of 10 registration areas.”

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Inec say dem dey investigate cases of electoral fraud for oda local goment areas.

    Dem add say dem get record of all officials dem deploy go di state and di election materials dem give dem and appropriate sanctions go dey applied wia necessary.

    Di commission assure voters for Kogi state say dia votes go dey protected and dia wishes go dey respected.

  13. Breaking, Inec declare APC Hope Uzodinma winner, re-elected Imo govnor

    INEC declare Hope Uzodinma winner of di 2023 Imo govnorship election

    Wia dis foto come from, HOPE UZODINMA/FACEBOOK

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Govnor Hope Uzodinma of di All Progressives Congress (APC) winner of di 11 November, 2023 govnorship election for Imo state.

    Di Vice Chancellor of di Federal University Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina wey be di state Returning Officer declare Uzodimma re-elected on Sunday morning at about 10:am afta ova eight hours of collation of local goment results.

    “Say you Hope Uzodimma of APC having satisfied di law is hereby returned elected,” Prof Fashina declare.

    Di Supreme Court for January 2020 bin first declare Hope Uzodinma as Imo state govnor afta dem cancel di election of Emeka Ihedioha of di Peoples Democratic Party (PDP), one situation wey make am attract more political enemies for di state wey dey suffer from security issues of “unknown gunmen”, kidnapping and endless Monday sit-at-home wey one separatist group for South-eastern group for Nigeria, di Indigenous People of Biafra (Ipob) dey order.

    Uzodimma, 64, bin seek re-election for Saturday poll and e clear all di 27 local goment areas for di state.

    Uzodimma beat PDP Samuel Anyanwu, Labour Party (LP)’s Nneji Achonu, Jack Ogunewe of di Action Alliance (AA), plus 14 oda opponents.

    Di APC candidate gada 540, 308 votes to defeat im closest rivals, PDP Anyanwu, wey get 71,503 votes and LP’s Achonu wey get 64,081.

  14. Di moment dem beat Labour Party agent for challenging Imo election result

    Dis na di moment some men beat and bundle out di state agent of Labour Party inside di collation centre for Owerri.

    Di gbege start early mor-mor today wen di LP agent begin protest di declaration of di result for di Imo state governorship election.

    Di incident happun before di di state Returning Officer of Inec for di election, Vice Chancellor of di Federal University, Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina, Police oga and oda ogbonge pipo wey dey part of di election for Imo state

  15. EFCC arrest 14 suspected vote buyers for Imo, Bayelsa, Kogi States

    EFCC arrest suspected vote buyers for Imo, Bayelsa and Kogi states

    Wia dis foto come from, EFCC/TWITTER

    Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest 14 suspected vote buyers for Otueke, Adawari playgrounds for Bayelsa state and for various polling units for Imo and Kogi states.

    Di kontri financial corruption police tok say dem recover in total N11,040,000 from di suspected vote buyers and sellers plus electoral fraud suspects across Imo state.

    EFCC say dem arrest dem on Saturday for statement say dem collect two vehicles from di suspects and dem go charge dem go court as sonn as dem finish investigations.

  16. Collation of results for Kogi go start dis morning

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    Kogi election
    Wetin we call dis foto, Lokoja Local Goment Secretariat

    Di Independent National Electoral Commission office for Kogi state go officially open today for collation of results.

    According to officials, di collation of results from Local Goment Areas go begin around 10am on Sunday 12 November, 2023.

    Di pipo of Kogi state bin come out on Saturdy 11 November, 2023 to elect di next govnor.

    Kogi get 21 Local Goment Areas and e dey expected say by late Monday or Tuesday morning all di results go don land for declaration.

  17. Breaking, Imo governorship election result live

      • Author, Tunde Ososanya
      • Role, Senior Journalist, BBC News Pidgin
  18. Collation of results start for Imo

    Imo collation centre

    Collation of results don start for di off-cycle election for Imo state Southeast Nigeria.

    Di State collation centre start around 02:30am for early mor-mor of today for Owerri, di state capital.

    Na di Vice Chancellor of di Federal University, Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina be di state Returning Officer of di Independent National Electoral Commission (Inec) for di election.

    Di main candidates for di election na govnor Hope Uzodimma wey dey seek re-election, Samuel Anyanwu of di Peoples Democratic Party (PDP) and Labour Party Achonu Nneji.

  19. INEC dey investigate cases of election mago-mago for Kogi

    Head of Voter Education for Inec, Kogi State Haliru Sule say dem dey investigate all di allegations wey showface for di Kogi election.

    Allegations of vote buying, violence, di arrest of one Local goment Chairman wey carry money and ammunitions plus di result sheet wey Dino allege say dem don already fill.

    Im tell BBC Pidgin say na hear dem hear di mata too but dem need to do investigation to confam weda na true or na lie.

  20. Wetin don happun so far

    Di election start slowly for di three states yesterday but tins begin pick-up as di day progress.

    Eye dey on top di three states as per who go win di election

    Dis na some highlights from yesterday;

    • Kogi govnorship election end wit impressive turnout of women voters
    • Bayelsa govnorship election dey relatively peaceful
    • Owerri experience low voter turnout for Imo govnorship election
    • Inec SPO dem kidnap don regain im freedom for Bayelsa
    • Sound of gunshots for a part of Imo state during election
    • ‘Election fit no hold for Ossioma Ward 06’ - Agbamuche-Mbu