Di Queen don dey lowered into di royal vault

Queen Elizabeth II funeral service for Westminster Abbey dey attended by 2,000 pipo, wey include foreign royals, world leaders and UK public figures.

Live Coverage

Jelilat Olawale and Helen Oyibo

  1. In fotos: Police prepare and crowds gada

    Police don dey ginger

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Police don dey ginger
    Police don dey ginger

    Wia dis foto come from, get

    Wetin we call dis foto, Police don dey ginger
    Police don dey ginger

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Police don dey ginger
    Pipo gada

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, Pipo gada
    Pipo gada

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, Pipo gada
  2. Di doors don open and guests dey go inside

    Queen Elizabeth II burial

    At 08:00 di doors to dem open di door to di abbey, and pipo don dey walk in already.

    As far as di eye fit see here down into Parliament Square and up Victoria Street - normal life don dey suspended.

    Monday rush-hour traffic no dey - coaches just dey move pipo, truck dey lift crowd barriers and buses shift police and security staff team to different posts.

    But dem don also komot some of di street furniture - London go put on dia best face today - no traffic lights or wide street security barriers go bring stop dis procession.

    Di State Gun Carriage go grind to a halt here just before di service at 11:00 BST.

    Sniffer dogs do dey busy dey work around di west and north entrances - where some of di 2,000 guests don arrive

    Thousands of members of di armed forces go line di procession route and take part between here, Wellington Arch and to Windsor. And some of dia number dey pass now.

  3. How you fit watch di funeral

    Millions of pipo for UK and around di world dey expected to watch di Queen burial for Westminster Abbey later today.

    Plenty ways dey to follow am:

    • Di BBC go provide full coverage of di state funeral across TV, radio, iPlayer, BBC Sounds, and di BBC News website.
    • For radio audiences, one special programme wey Martha Kearney present go dey relayed on BBC Sounds, BBC Radio 4, BBC Radio 5 Live, BBC Radio Wales and BBC Radio Scotland between 09:00 and 13:30 and 14:30 and 17:00.
    • BBC radio stations, including local stations go broadcast di service.
    • About 125 cinemas around di kontri go screen di funeral
    • Pipo fit also watch di event for Cathedrals and theatres.
    • Dem go set up big screens for locations across diUK, including Edinburgh Holyrood Park, Hyde Park for London, Sheffield Cathedral Square, Belfast City Hall and Castle Square for Caernarfon.
    • One special BBC programme go broadcast live to more dan 200 kontris and territories worldwide via BBC World News and bbc.com.
    • Networks like PBS, CNN and Fox for US and ABC for Australia go also broadcast di day’s events.
  4. In fotos: Spectators don gada ahead of di funeral

    Pipo donbegin gada for London and Windsor to watch di Queen funeral procession wey go happun later today.

    Many pipo camp out overnight to secure correct spot wia dem go fit watch along di route.

    Pipo gada for London and Windsor to watch Queen Elizabeth II funeral procession

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Pipo gada for London and Windsor to watch Queen Elizabeth II funeral procession
    Pipo dey queue to buy hot drinks as di morning dey cold

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, Pipo dey queue to buy hot drinks as di morning dey cold
    Police dey patrol for Whitehall ahead of di funeral

    Wia dis foto come from, ep

    Wetin we call dis foto, Police dey patrol for Whitehall ahead of di funeral
    Some members of di public arrange themselves close to wia dem put barriers on di procession route for Windsor

    Wia dis foto come from, PA Media

    Wetin we call dis foto, Some members of di public arrange themselves close to wia dem put barriers on di procession route for Windsor
    Odas camp for outside di castle - wia dem go cari di Queen coffin go dis afternoon - to secure a good spot

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Odas camp for outside di castle - wia dem go cari di Queen coffin go dis afternoon - to secure a good spot
  5. Lying-in-state don end

    Lying-in-state

    Di Queen lying-in-state for Westminster Hall don end.

    Hundreds of thousands of pipo wey don travel to London from across di UK and di world don get chance to pay dia respects since Wednesday night and throughout di weekend.

    Di Queen four children mount a vigil for her on Friday evening, and her grandchildren do same on Saturday.

    Guards bin keep watch for six hours a shift, switching in and out of roles at 20-minute intervals. But now di doors to di hall don dey closed, as di final preparations for di morning’s state funeral take place.

    • More about di Queen funeral plans dey here.
  6. How di funeral service go go

    Queen Elizabeth coffin

    Wia dis foto come from, Reuters

    Multiple components dey to di Queen funeral, wey go unfold throughout di day in both London and Windsor. Dis na wetin we dey expect:

    • 6:30 BST- Di Queen lying-in-state for Westminster Hall inside di heart of London go come to an end in di early morning. Thousands of pipo don dey queue and file past to see her coffin
    • 8:00- Doors of Westminster Abbey open for di 2,000 guests expected - from world leaders to charity workers and di Japanese emperor
    • 10:44- At dis point, di ceremonial part of di day go begin well-well, as di Queen coffin go dey lifted from di catafalque wia e don dey rest since Wednesday afternoon, and take am to Westminster Abbey, for her funeral service.
    • 11:00- Di state funeral service go begin
    • 11:55- Di Last Post bugle sound, followed by national two minutes silence
    • 12:00- Service end, and at 12:15 one second, larger procession brings her coffin to Wellington Arch
    • 13:00- Her coffin go dey transferred to di state hearse and driven to Windsor along one route expected to be lined by crowds
    • 15:00- Di day third procession go begin, through di grounds of Windsor Castle to St George’s Chapel
    • 16:00- Committal service take place for St George’s Chapel
    • 19:30- Royal Family return to di chapel for private burial service wey go see Elizabeth II interred alongside her late husband, di Duke of Edinburgh
    • Read about Queen Elizabeth II funeral plans.
  7. George and Charlotte to join Westminster Abbey mourners

    Prince George and Princess Charlotte

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Queen Elizabeth di second great grandchildren Prince George and Princess Charlotte go attend her funeral for Westminster Abbey today.

    Nine-year-old George and im seven-year-old sister go form part of one procession wit di Royal Family wey go follow di coffin as e enter di church.

    Di Prince and Princess of Wales go walk ahead of George and seven-year-old Charlotte, wey called di Queen "Gan Gan", followed by their uncle and aunt, di Duke and Duchess of Sussex, and other members of di Royal Family.

    George and Charlotte younger brother Louis, four, no dey expected to attend.

  8. Wetin go happun today?

    Floral tributes for di Queen don dey laid for Green Park

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Afta days of lying-in-state, di body of di late Queen Elizabeth II go begin im final journey on Monday morning as part of a grand state funeral - first to Westminster Abbey, for a religious service in front of a congregation of thousands, and den on to Windsor Castle for a more intimate committal service and, finally, private burial.

    E go be a day of emotion, pomp and ceremony di like of wey dem never see since di last state funeral, of Winston Churchill, almost 60 years ago..

    You fit find all di key details of di day here.

    • Read also about di: Death of Queen Elizabeth II.
  9. Welcome!, Una good morning.

    We dey welcome una to di live coverage of di funeral service of Queen Elizabeth II wey go dey attended by 2,000 pipo, wey include foreign royals, world leaders and UK public figures.