Queen Elizabeth II funeral service for Westminster Abbey dey attended by 2,000 pipo, wey include foreign royals, world leaders and UK public figures.
Live Coverage
Jelilat Olawale and Helen Oyibo
Di first funeral event don start
Di time na 10:44 BST - di precise time wey slow-moving procession start to dey take di Queen coffin from Westminster Hall to nearby Westminster Abbey for di state funeral service.
Garrison Sergeant Major Andrew Strokes dey call di procession to attention.
Queen close family follow her coffin
Wetin we call dis foto, Queen close family follow her coffin
King Charles III, im sister Princess Anne, and im brothers, Princes
Andrew and Edward.
Also following di Queen coffin na Princes William and Harry, and Peter
Phillips, wey be di son of Princess Anne and one of di Queen other grandsons.
Following behind them na oda senior male royals: di Queen cousin di Duke
of Gloucester, her nephew di Earl of Snowdon and Anne husband Sir Tim Laurence.
Camilla, di Queen Consort and Catherine, Princess of Wales arrive for abbey
Wetin we call dis foto, Camilla, di Queen Consort
Now di members of di Royal Family wey no dey walk behind di Queen coffin dey arrive for di abbey.
Camilla, di Queen Consort and Catherine, di Princess of Wales dey walk into di abbey.
Prince George and Princess Charlotte dey wit dem.
Also, dem dey drive Sophie, Countess of Wessex: di wife of Prince Edward to di abbey
Queen coffin don dey inside di gun carriage for journey to Westminster Abbey
Wetin we call dis foto, Di gun carriage don carry di Queen body
Dem don move di Di Queen go di State Gun Carriage wey dey outside di
building North Door.
E go be short route to di abbey, e go cross New Palace Yard and
Parliament Square, then negotiate Broad Sanctuary and di Sanctuary.
Di journey go take around eight minutes, wit 142 Royal Navy sailors and
six officers go draw di carriage.
Guard of honour go dey di square and a Royal Marine band.
Leading di procession na di Massed Pipes and Drums of di Scottish and
Irish Regiments, di Brigade of Gurkhas, and di Royal Air Force - numbering some
200 musicians.
Wetin we call dis foto, Canadian President Justin Trudeau
Some Commonwealth leaders don begin arrive now - we fit see Canadian
President Justin Trudeau among them.
E bin don tok about im memories of di Queen.
Also here na New Zealand Prime Minister Jacinda Ardern – she tell BBC on
Sunday say she no get problem, "no fuss" about taking di bus today.
Wetin we call dis foto, New Zealand Prime Minister Jacinda Ardern
King, Prince of Wales and Duke of Sussex don arrive Westminster Hall
King Charles III, Prince William and Prince Harry dey enta Westminster Hall ahead di procession wey go start in di next 10 minutes.
Wia dis foto come from, b
Wetin we call dis foto, Queen family don begin land Westminister
Former PMs don arrive for di abbey
Di Queen get 15 Prime Ministers during her long reign – from Winston
Churchill, wey dey office when she ascend di throne - through to Liz Truss, wey
she appoint for Balmoral just two days before she die.
Some of those who survive her don dey arrive.
We don see John Major, Tony Blair, Gordon Brown, David Cameron, Theresa
May and Boris Johnson, wit dia spouses.
Wetin we call dis foto, Former prime minister Boris Johnson and im wife Carrie arrive
Wetin we call dis foto, A procession of prime ministers wey serve during di Queen's reign walk up di Abbey
Wia dis foto come from, b
Wetin we call dis foto, Prime Ministers wey serve during di Queen reign
PM Liz Truss don land
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, PM Lizz Truss wit di Queen
Di current Prime Minister Liz Truss just dey land now, wit her husband,
Hugh O’Leary.
She be one of di last pipo in public life to see di Queen – foto show
her in front of a fireplace wit di Queen, on di Tuesday before Elizabeth II die.
Bell continue to ring in Queen honour
Di bell for Westminster Abbey go ring for 96 times, e go count
out di years of di Queen long life.
Inside di abbey dey full
of pipo wit uniforms, famous faces and clusters of dignitaries dey ushered into
pews below di statues and memorials.
Today politicians dey look
stone monuments of yesterday leaders.
One organ dey play as pipo
wey wear black clothes and hats plenty like sea, seats dey occupied under di
high gothic arches.
We go lead di state
funeral at 11:00 BST, wey include include hymns, religious music, prayers and
readings from di Bible.
Di choices - traditional,
classic and without any gimmickry - go reflect di Queen character and her deep
religious faith.
Chinese delegation don land
Representatives from China just enta and dey wear white face masks wey
cari di Chinese flag.
Vice-President Wang Qishan na di senior representative wey Beijing come
di funeral.
US President Joe Biden arrive wit im wife
Wia dis foto come from, Reuters
US President Joe Biden and im wife Jill don land di abbey. Dem fly in on Saturday.
Dem meet di Queen in June last year for Windsor Castle where dem take afternoon tea with di monarch at di end of a trip to di UK for di G7 summit of world leaders in Cornwall.
She meet her first serving president Harry S Truman when she be Princess Elizabeth in 1951 and she meet 13 of di last 14 US leaders.
All except Lyndon B. Johnson.
France President Macron and oda world leaders take dia seats
Wia dis foto come from, Getty Images
About 500 leaders and dignitaries from di UK and around di world dey join di congregation for Westminster Abbey.
Di first heads of state and di spouses don dey arrive - we just see French President Emmanuel Macron and im wife.
Di gun carriage wey go carry di Queen
Wia dis foto come from, PA Media
Di gun carriage wey go carry di Queen coffin to Westminster Abbey at 10:44 BST, get rich history.
E dey different to di one wey dem used for di procession from Buckingham Palace on Wednesday.
Dis one don dey looked after by di Royal Navy since 1901. Dem take am out of active service dat year for di funeral of Queen Victoria, who be Queen Elizabeth II great-great-grandmother.
Dem don use di carriage at di funerals of oda monarchs, too - including di Queen father George VI - and of Elizabeth II first prime minister, Winston Churchill.
E go dey drawn by 142 sailors. Naval personnel na dem dem first used during Queen Victoria funeral, after horses wey suppose pull di gun carriage dey spooked - prompting fears of di carriage toppling.
Sailors bin use improvised ropes to pull di 2.5-tonne (3,000kg) carriage through Windsor.
One team for di front go pull di carriage; another for di rear go act as a brake.
In pictures: More guests arrive
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, More guests don dey arrive and take dia seats at Westminster Abbey
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, One of them na Chancellor of di Duchy of Lancaster and Equalities Minister Nadhim Zahawi
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Another na Business Secretary Jacob Rees-Mogg
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, More guests make dia way into di abbey
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Each guest go get order of service dem get inside
Politicians dey among guests wey dey take seats at abbey
Wetin we call dis foto, Former deputy prime minister, Nick Clegg (centre)
Politicians don dey arrive from anoda bus now - we fit see Foreign Secretary James Cleverley and Chancellor Kwasi Kwarteng among dem as dem head into Westminster Abbey.
Former First Minister of Northern Ireland Arlene Foster, former deputy prime minister Nick Clegg and Lib Dem leader Sir Ed Davey dey wit dem.
We also don see say Business Secretary Jacob Rees-Mogg, former leader of di Conservative Party William Hague, and Home Secretary Suella Braverman don arrive.
'We go tell our future children say we come here'
Wetin we call dis foto, Rona (right) and Rheanna (second right) dey here wit oda family members
Some regret dey for Rona Gedall, 40, wey travel down from Luton wit her teenage daughter Rheanna.
“E go dey nice to see di Queen and e don late now."
Na why she come here for her last goodbye.
Rheanna, 13, dey expect moment she go always remember.
“She dey alive since dem born me.
“Di Queen make history and we go tell our children for future say we dey involved for history making today.”
Queen Consort family don arrive
Tom Parker Bowles, di son of Camilla, di Queen Consort, don gone in now, wit oda members of dia family.
Who dey come di abbey?
Wia dis foto come from, Reuters
Some 2,000 pipo dey expected to attend di Queen state funeral later, and dis go be di biggest gatherings of royalty and politicians hosted in di UK for decades.
No official guest list don dey published, but dis na wetin we know about who go attend and who no go attend at 11am service for Westminster Abbey.
Foreign royals
Members of royal families from across Europe go attend di funeral. Dis include di kings and queens of Belgium, di Netherlands and Spain.
Japan's Emperor Naruhito and Empress Masako dey attend di funeral too.
World leaders
US President Joe Biden and First Lady Jill Biden don travel to London for di funeral. Oda world leaders wey we expect to see dis morning na French President Emmanuel Macron, Australian Prime Minister Anthony Albanese and Canadian Prime Minister Justin Trudeau.
Leaders from many oda Commonwealth nations go also attend. South Africa and Kenya Presidents Cyril Ramaphosa and William Ruto don arrive
Dem no invite Russia, Belarus and Syria.
UK politicians and officials
Many familiar faces from British public life go dey dia.
Prime Minister Liz Truss, wey di Queen appoint just two days before she die, don dey go di abbey wit oda goment figures. Opposition politicians, leaders of di UK goments and many oda public officials.
Charities, sport, arts and science
We also expect to see representatives from charities wey di Queen bin support. Recipients of di Victoria Cross and George Cross go also attend.
First guests come in through di west and north doors
We don see di first guests dey go in now - pipo wey dey go through di north door of Westminster Abbey dey too far away to identify - although we fit see members of di clergy and officers in uniform among them.
See also: Who get invite - and who no get to attend Queen Elizabeth burial?
Through di west door na di first group of guests wey dey arrive here - we tink say we fit spot politicians among dem.
Dem step out just as di stewards put di finishing touches to di sand outside where di gun carriage go stop.
Crowds dey compete for prime spots and coffee
Wia dis foto come from, Bet
At Horse Guards Parade - on di procession route between Westminster Abbey and Buckingham Palace - di crowd dey 10 pipo deep already.
Di stewards dey remind pipo to stay hydrated. Dis one fit explain di longest queue for coffee wey I don see.
Despite say e go take hours before di procession happun, e dey clear say some pipo no go see wetin dem hope to see.
Liz and Jonathan Read, from Reigate for Surrey get spot wey dey overlook di parade.
"We bin get plan of where we dey go but we no fit do as we just gaz follow di crowds," Jonathan tok. "You no know how far you go dey for back, but e dey fortunate say we get dis close."