Di Queen don dey lowered into di royal vault

Queen Elizabeth II funeral service for Westminster Abbey dey attended by 2,000 pipo, wey include foreign royals, world leaders and UK public figures.

Live Coverage

Jelilat Olawale and Helen Oyibo

  1. Queen pass Royal Parks for di final time

    Queen Elizabeth II funeral

    Dis large procession for di Queen coffin dey march between two of London's Royal Parks on di route to Wellington Arch.

    To di north: Green Park, one 40-acre green space wey Charles II open for 1668 wey deer bin full.

    E include Canada Memorial, wey di Queen unveil for 1994, wey remember di million Canadians wey serve for di World Wars.

    To di south: St James's Park, di oldest of di Royal Parks, wey dem bin use for fetes di Queen predecessor, Elizabeth I.

    To dis day, na spot wey Londoners and tourists love - but today sad mood dey.

    Oda tori about di funeral wey fit interest you:

    • Queen Elizabeth eight grandchildren stand vigil around her coffin
    • Police drag man to court over Queen coffin incident
  2. Staff gada outside Buckingham Palace as coffin pass

    Queen Elizabeth II funeral

    Members of Buckingham Palace staff don gada for front of di building as Queen Elizabeth II coffin pass di Queen Victoria Memorial.

    Di monument - wey be 25 metres high and wey dey built wit more dan 2,000 tonnes of marble - dey installed for 1901 to mark di death of Elizabeth great-great-grandmother.

    Read oda tori about di funeral:

    • Queen Elizabeth II death: 'Telling di bees' and oda unusual UK royal succession traditions
    • Queen's lying-in-state: Sad procession begin lying-in-state ceremony for Queen Elizabeth II
    • Who get invite - and who no get to Queen Elizabeth burial?
  3. In fotos: Queen Elizabeth II Funeral

  4. Queen coffin pass memorials for her mama and papa

    Queen coffin pass memorials for her mama and papa

    As di procession head along Di Mall, e pass statues wey she (di Queen) unveiled Queen in honour of both her parents.

    A bronze memorial to her father King George VI dey inaugurated early in her reign, in 1955.

    Nearby na another bronze wey dem put up in 2009 to remember di Queen Mama, wey die in 2002 at di age of 101.

    Stories of di Queen wey fit interest you:

    • Di Queen inheritance for King Charles III
    • In Africa, oda views of di Queen legacy
    • Di Queen and her 'great sense of humour'
  5. 'We gaz say goodbye to di boss'

    Queen Elizabeth II funeral

    Veterans Gareth Jones from Swansea and Dave Cartwright from Exeter neva see each oda for 21 years but dem don reunite to pay tribute to di Queen.

    Dem don dey wait for hours near di Cenotaph to watch dia commander-in-chief‘s coffin pass by.

    “When we hear say she don die, we just know say we gaz come here and so we arrange to meet," Gareth tok.

    You fit find more tori about di Queen funeral for here.

    “We no get into Westminster Hall sake of say we miss out by about five minutes, so we gaz come to Whitehall to say goodbye to di boss."

    Both of dem serve for di Royal Army Medical Corps for Afghanistan.

    Dave dey seriously injured by one explosion for 2010 and meet di Queen six years later for Windsor Castle.

    “When she speak to you, e be like say anoda pesin no mata. She dey small for stature - e be like to dey tok to your granny - but she get dis huge presence. We go miss am so much."

  6. Dem neva see funeral arrangements like dis since 1952

    Queen Elizabeth burial

    Di arrangements for dis state funeral na sometin wey dem neva see for Britain for 70 years since di funeral procession for King George Vi for 1952.

    More dan 3,000 military personnel dey take part along wit civilian organisations.

  7. Canadian mounties lead procession as NHS workers follow dem

    Queen Elizabeth II burial

    Wia dis foto come from, bb

    Mounties of di Royal Canadian Mounted Police dey lead di procession and four representatives from di NHS dey follow dem. Dem include May Parsons, wey administer di first Covid-19 vaccine for 2020.

  8. In fotos: London crowds watch and listen to di service

    People outside the abbey have been following the funeral service.

    Dis na di scene on di Mall

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Dis na di scene on di Mall
    Some watch di funeral ontop dia phone...

    Wia dis foto come from, Shutterstock

    Wetin we call dis foto, Some watch di funeral ontop dia phone...
    ...or listen to di service via loudspeakers

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, ...or listen to di service via loudspeakers
    some cry...

    Wia dis foto come from, Press Eye

    Wetin we call dis foto, some cry...
    ...while oda dey reflect on di occasion

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, ...while oda dey reflect on di occasion
  9. Queen coffin comot Westminster Abbey

    Queen coffin comot Westminster Abbey

    Wia dis foto come from, Queen coffin comot Westminster Abbey

    Di bearer party don dey carry di Queen coffin back through Westminster Abbey and out of di Great West Door.

    Dem go place back on to di State Gun Carriage ready for di procession from di abbey to Wellington Arch.

  10. Dem sing National anthem as service dem finish service

    Queen Elizabeth II funeral

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Dem don sing di Reveille - dis na anoda military call wey dem dey us to wake soldiers at sunrise.

    Dem dey sing di national anthem - den lament from di Queen’s piper go bring di service to an end.

    You fit also read more tori about di Queen funeral for here.

  11. Choir sing one anthem of hope

    Queen Elizabeth II funeral

    Wia dis foto come from, Getty Images

    The choir sing "My soul, there is a country" wey Hubert Parry write during World War One but wey dey based on di words of di 17th Century poet Henry Vaughan.

    Dem choose am for di funeral as anthem of great hope.

    See more tori about di Queen funeral for here.

  12. Leaders of loving service dey rare - Welby

    Welby tok about di Biblical call to serve instead of make dem serve you.

    Leaders of loving service dey rare, im tok.

    But pipo wey serve go dey loved and remembered, while pipo wey hold on to power and privilege, go dey forgotten, im tok.

    She bin dey present to so many, as she touch many lives, im tok.

  13. Archbishop of Canterbury give im sermon

    Di Archbishop of Canterbury, Justin Welby, don begin im sermon.

    Di pattern for many leaders na to dey exalted in life and dey forgotten afta death. Di pattern for all wey serve God, famous or not, na say death na di door to glory, im tok.

    Her late majesty bin famously declare on her 21st birthday broadcast say she go dedicate to serve di nation and Commonwealth.

    E dey hard to see pesin wey go keep dat kind promise, im tok.

    Few leaders don receive di kind of love wey we don see, im tok.

    "No be sake of her position and ambition her late Majesty set dis kind example but na sake of pesin wey she follow.

    "I know im majesty share di same faith in Jesus Christ just like im mama."

    See more tori about di Queen funeral here.

    Queen Elizabeth II funeral

    Wia dis foto come from, Getty Images

  14. PM read from scripture

    Queen Elizabeth II funeral

    Wia dis foto come from, PA Media

    Prime Minister Liz Truss give di second reading from scripture, from di Gospel According to John: "Make you no let your heart dey trouble; if you get belief in God, you also get belief in me."

    Di passage na about Christ promise to im followers of a place for heaven.

    Im tell im disciples: "Na me be di way, di truth, and di life: no man fit come to di Fada, but by me."

  15. Dem carri di Queen to abbey where she marry and dey crowned

    Queen Elizabeth II funeral

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Dem don carri di Queen to Westminster Abbey. Na for dia she marry for 1947 and dey crowned for 1953, and where she attend royal weddings and funerals.

    All, including her own funeral today, na part of di seasons of death and renewal wey dey reoccur.

  16. Dean praise Queen 'constant commitment'

    Queen Elizabeth II burial

    Di Dean of Westminster give di bidding, invitation to di congregation to pray.

    Im say for dis church "remembrance and hope na sacred duties".

    And im tok say pipo from all ova di nation, di Commonwealth, and di world dey gathered today for di place where di Queen marry and dey crowned.

    "Wit gratitude we remember her constant commitment to high calling ova so many years as Queen and head of di Commonwealth," im tok.

    "Wit admiration we remember her lifelong sense of duty and dedication to her pipo. Wit thanksgiving we praise God for im constant example of Christian faith and devotion.

    "Wit affection we remember her love for her family and her commitment to di causes she bin hold dear."

  17. Di service don start

    Queen Elizabeth II burial

    Wia dis foto come from, PA Media

    Di Dean of Westminster, David Hoyle, dey lead di funeral.

    But na di Archbishop of Canterbury, Justin Welby, go give di sermon and di commendation - di ceremonial moment wen di Queen dey entrusted to God.

    Prayers go come from di Archbishop of York, di Cardinal Archbishop of Westminster, di Moderator of di General Assembly of di Church of Scotland and di Free Churches Moderator.

    Di Prime Minister Liz Truss and di Secretary General of di Commonwealth Patricia Scotland go deliver lessons - dem go read from scripture.

    And na di Dean of Westminster go pronounce di blessing.

  18. Di procession enter di Abbey

    Queen Elizabeth II funeral

    Di 2,000-strong congregation rises as di procession of di coffin enta di 13th Century church.

    Di choir sing "I be di resurrection and di life" - di first of five lines of scripture, known as di Sentences, wey dem don sing at everi state funeral since di 18th Century.

    For di final two of di Sentences, di choir of di Chapel Royal, St James's Palace go join in, dem go end wit one line from Revelation 14:13: "From henceforth blessed na di dead wey die for di Lord: even naso di Spirit; for dem rest dia labours, Amen."

  19. Wetin dey displayed on top of di Queen coffin?

    Di tins wey dey on top di Queen coffin
    Wetin we call dis foto, Di tins wey dey on top di Queen coffin
  20. Queen coffin don arrive Westminster Abbey

    Queen coffin don land di abbey
    Wetin we call dis foto, Queen coffin don land di abbey

    Di procession don reach di abbey West Gate now.

    Di eyes of di world now dey on di bearer party, wey get di responsibility of delicately lifting di Queen’s coffin from di State Gun Carriage and carry am go inside for di service.

    Once inside di grand building, dem go cari di coffin through di nave and di quire and place am on a platform before di high altar.