Di Federal Goment don appeal to di Nigeria Labour Congress to cancel dia planned protest sake of di strike by Academic Staff Union of Universities (ASUU) and oda university-based unions.
NLC wan protest sake of di strike by Academic Staff
Union of Universities (ASUU) and oda university-based unions to show solidarity to dem.
ASUU don dey on strike since 14 February sake of say goment fail to meet di agreement wey goment sign wit dem for 2009.
Minister of Labour and Employment Senator Chris Ngige make di appeal on Thursday for one meeting wit di leadership of NLC for im office.
Di Minister of State, Labour and Employment, Festus Keyamo, SAN and di Permanent Secretary of di Ministry, Ms. Kachollom S. Daju also attend di meeting.
Ngige update di labour leaders on di efforts di federal goment don make so far to resolve di issue and assure dem say efforts still dey go on.
Di minister remind di NLC leadership say im incorporated dem into di tripartite conciliation wey dey go on for im ministry, and dem dey aware of efforts of di goment to resolve di issue. E say e no expect dem to embark on protest or rally.
E tell di labour leaders say di Federal Executive Council (FEC) mandate am to notify dem of di serious security implication of dia planned protest.
According to Ngige, one security report wey di Department of State Services (DSS) send to im office strongly warn against holding di protest wey dem plan to hold on July 26 and 27.
Di minister urge NLC National Executive Council (NEC) to reconsider di planned rally as hoodlums, opposition politicians and fifth columnists fit take advantage of am to cause trouble for di kontri.
Both di Deputy President of NLC, Comrade Najeem Usman Yasin, and General Secretary, Comrade Emmanuel Ugboajah assure di goment say di protest go dey peaceful and dem assure say pipo wey wan cause trouble no go dey allowed to participate.