Nollywood actress, Caroline Hutchins Danjuma don announce say she be di African Action Congress (AAC) deputy govnorship candidate for Akwa Ibom State.
Caroline Danjuma na di third actress to run for a pollical office for di 2023 elections.
Dis dey come few weeks afta actors, Funke Akindele and Tonto Dikeh announce say dem be deputy governorship candidates of different political parties.
Funke Akindele come out as deputy govnorship candidate for di Peoples Democratic Party, PDP for Lagos State for di 2023 general elections.
While Tonto Dikeh come out as di deputy govnorship candidate of di African Democratic Congress (ADC) for di 2023 general election for Rivers State.
Caroline Hutchins Danjuma write for her official Instagram page as she share di news with her followers;
"To serve and to honour in loyalty and in truth to Akwa Ibom and Nigeria. So help me God."
Also, Omoyele Sowore wey be AAC presidential candidate post photo of Caroline as e announce di party deputy govnorship candidate for Akwa Ibom state and write say;
"Women no need to request for a particular percentage in governance, our party AAC believe in equal rights between women & men. Wetin man fit do, a woman fit do am beta..."
Di Govnorship candidate for AAC inside Akwa Ibonm state na Iboro Otu.
Iboro Otu also make di announcement of im running mate for im facebook page.
"Today I introduce my running mate and deputy govnorship candidate to Akwa Ibom state and indeed di world... I found dis candidate in Chief Mrs. Caroline Uduak Danjuma wey be Eket business woman and philanthropist wey don win di world over through her line of endeavour," Iboro Otu tok.