You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
Deaths rise for passenger bus wey crash enta river inside Kenya
Di pipo wey don die inside one bus accident on Sunday night for eastern Kenya don rise to 33.
Authorities don confam say 10 pipo survive di accident.
Di accident happun wen one bus, wey bin dey travel from di eastern town of Meru go Mombasa, comot road enta 40 metres inside di Nithi River.
Dem restart recovery efforts today afta dem suspend am on Sunday night.
Police say di first investigations dey show dem brake failure na im cause di accident.
Di driver bin dey try dodge di area wey dey very popular for deadly road accidents, dem add.
Gunmen kill three policemen for Okpanam, Delta State
Delta State Police Command don confam say some gunmen kill three policemen of Okpanam Division for Oshimili local goment area.
Police PRO Bright Edafe say di ambush happen for di early hours of Sunday wen dia Okpanam Division respond to distress call for di area.
DSP Edafe say dem don arrest one of di suspects wey dey help dem with dia investigation.
Di oda policeman wey survive di attack dey receive treatment for hospital.
How Tobi Amusan break World record for Nigeria
Una Welcome!
We don land today for correct informate from Nigeria, Ghana Africa and di world - Welcome!
Una Good Night
Na hia we go match break for dis week.
We go come back on Monday, 25th of July, 2022 to give all di tori as e dey hot.
Fish out dow wey kill Michael Echefu, Abike Dabiri-Erewa tell South Africa authorities
Chairman of di Nigerians in Diaspora (NIDCOM) Abike Dabiri-Erewa don beg authorities for South Africa to expose di pipo wey dey behind di death of Michael Chima Echefu wey some unknown robbers kill for South Africa.
Di NIDCOM chairman wey tok dis one wen she go tok sorry to di family of oga Michael say she want make di authorities see to di end of di mata and make Michael case no be like oda murder cases of Nigerians wey dem no dey solve.
Secretary-General of di Nigerian Citizens Association for South Africa (NICASA) inside one statement bin announce di killing of Michael Chima Echefu, native of Amaigbo, Imo State, for inside im shop.
Di incident happun on 27 June.
“According to eye witness account, na South African robbery gang wey robbed Michael at gun point for im shop wey dey located at Rissik and Jeppe Street, Johannesburg shoot and kill am," di statement tok.
"During di robbery, dem shoot di deceased two times for head as e dey try escape di robbery scene. Investigation still dey go on but dem neva arrest anybody.”
Late Mr. Echefu get wife, Ugochi Echefu and three children.
French President go visit Cameroon, Benin and Guinea-Bissau
French President Emmanuel Macron go tour sub-Saharan Africa from July 25 to 28 wey go carry am go Cameroon, Benin and Guinea-Bissau, according to di Élysée Palace.
Dis go be di first trip Macron since Macron win im re-election for April, and na to focus on di food kasala wey di war for Ukraine dey cause, agriculture production issues and security issues, according to di presidency.
Macron go visit Cameroon first on Tuesday to follow President Paul Biya tok on top French investments for Cameroon agriculture.
E go enta Benin on Wednesday, before im trip end on Thursday with trip go Guinea-Bissau.
Toni Conceicao: FIFA order Cameroon to pay former coach $1.63m compensation
One FIFA tribunal don order di Cameroon Football Federation (Fecafoot) to pay former coach, Toni Conceicao $1.63m compensation afta dey end im contract early.
Di 60-year-old Portuguese carry im former employers go di world football governing body Fifa afta dem remove am for im job for March.
Dis na weeks afta di Indomitable Lions finish for di third position for di Africa Cup of Nations for Cameroon.
Conceicao bin secure Cameroon place for di Africa World Cup play-offs before dem replace am wit Rigobert Song on di order of di kontri president.
One Fifa tribunal wey former international Samuel Eto'o lead rule say make Fecafoot pay Conceicao for breach of contract without just cause plus more money for outstanding salary and bonuses.
One top official for Fecafoot tell BBC Sport Africa say di body neva decide if are grounds dey to appeal against Fifa decision.
Conceicao na di latest European coach to seek compensation afta e comot di Central African nation.
Ukraine - Russia sign deal to release 20 million tonnes of grain fro Ukraine Ports
Ukraine and Russia don sign agreement for Instanbul on Friday to allow di ova 20 million ton of grain wey hook for di Ukrainian ports to dey exported.
Di goal of di deal na to bring down di rising prices of grain as well as help relief di global hunger crisis.
Dis agreement na sake of months of tok-tok between di two fighting kontris wey United Nations and Turkey help dem do.
Senior UN officials say di first batch of grains go comot from di seaports in di next few weeks and dem dey expect five million metric tons of Ukrainian grain and oda foodstuffs to di world per month.
Di International Committee of di Red Cross say di Ukraine Russia grain deal na life saving for pipo across di world.
USAid give Kenya millions to tackle drought
Di US development agency say dem go give Kenya more than $255m to tackle scarcity wey don leave millions of pipo without any source of food.
Head of USAid, Samantha Power as she dey tok for Nairobi say di war for Ukraine don increase di suffering for Kenya and for di rest of di region.
Di UN World Food Programme (WFP) say across East Africa more than 50 million pipo dey face serious food insecurity.
She say Ethiopia, Kenya, South Sudan and Sudan dey face food crises and some parts of Somalia dey at risk of famine unless humanitarian assistance increase.
Di head of di East African regional group of countries wey dey known as Igad, Workneh Gebeyehu, say di food security situation across di Horn of Africa dey serious and next and hope no dey for di next rainy season.
Federal goment don beg NLC make dem pause dia planned protest
Nigerian Federal goment don beg di Nigeria Labour Congress say make dme cancel di protest dem dey plan on top di long lasting strike wey di Academic Staff Union of Universities (ASUU) and other university-based unions dey do.
Di Minister of Labour and Employment, Chris Ngige tok dis one for meeting with di leadership of NLC for im office on Thursday.
Ngige tell NLC for di meeting about wetin di Federal Goment dey do to solve di kasala.
Di Minister also use di opportunity to tell di labour leaders say di Federal Executive Council (FEC) tell am to tell NLC about di security gbege wey fit enta di protest.
According to him, Department of State Services (DSS) send security report to im against holding di protest wey dem dey plan for July 26 and 27.
Both di Deputy President of NLC, Comrade Najeem Usman Yasin, and General Secretary, Comrade Emmanuel Ugboajah respond say dem go hold peaceful protests and dem no go let jaguda pipo join am.
EFCC arrest ex convict and 32 odas for alleged internet fraud for Ibadan
Di Economic Financial Crimes Commission for don arrest one convicted yahoo-yahoo boy OKhiria Alex Chibueze plus thirty two odas for alleged cyber-fraud.
Dem catch di suspect for Soka area of Ibadan, Oyo state, South-west Nigeria.
Di anti-graft agency recova eight exotic cars, plenty mobile phones, laptops, expensive wristwatches and oda tins.
Dem go carry di suspects go court afta dem finish investigations.
EFCC bin arrest Chibueze for 2021 ontop accuse say e use mago-mago collect $3800 thru one fake lottery scheme.
Court find am guilty and sentence am to six months community service for 16 June, 2022.
Three African restaurants follow for di 2022 World 100 Best Restaurants
Three African restaurants don enta di list of di Best restaurants for di World’s 100 Best Restaurants in 2022.
Dis one comot as di Academy for di award recently release di list and give out awards for dia 2022 Awards show.
According to dia website, di list dey comot from 1,000 members wey get knowledge ova di international restaurant scene.
Dem dem made up of chefs, restaurant, owners, food/ restaurant tori pipo and gourmets wey don travel well.
Dem announce di ranking on Monday for awards show wey Stanley Tucci host for London.
Di three African restaurants include:
- Fyn Restaurant for Cape Town wey come number 37 for list, E win best restaurant for Africa and dem say dem dey serve food of "Japanese inspiration with African flavours"
- Wolfgat for Paternoster for South Africa wey come 50th position with local food wey dem dey use small-small so e go dey "sustainable"
- La Colombe for Cape Town for South Africa come 81 position with dia French Asian menu
Lisa Smith, Ex-soldier wey turn IS member don chop 15 month jail sentence
One former Irish Defence Forces soldier wey dem find guilty of Islamic State (IS) membership don get 15-month prison sentence.
Court say Lisa Smith, wey be 40 years, dey guilty say she be member of di group between 28 October 2015 and 1 December 2019.
Di court find her not guilty say she finance terrorism by sending money to one man to benefit di terrorist group.
Dey sentence am for di Special Criminal Court for Dublin.
Di judge, Oga Justice Hunt, say e dey serious for any Irish citizen and former member of di defence forces to pledge allegiance to foreign terrorist organisation.
E say no doubt say Smith sabi wetin she dey do.
But e tok say im and di court look her former good behaviour and dat she bin get hard time for Syria and suffer domestic violence.
Court send former Accountant-General of Nigeria, odas to Kuje Prison, Ahmed Idris and odas dey face 14 count charges of stealing and breach of trust
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin
Di FCT High court Abuja don order di former Accountant-General of di Federation, Ahmed Idris and odas to stay for di Kuje Prison until Wednesday 27 July, 2022.
Presiding Judge, Justice Ajayi Adeyemi give di order for di trial wey start today inside di Nigeria capital, afta all of dem plead not guilty to 14 count charge of stealing and breach of trust to di tune of over 109 billion naira wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) sama dem.
Di defence counsel, Chris Uche bin pray di court to kontinu wit di Administrative bail wey EFCC give dem since dem neva default dia bail conditons but Justice Ajayi no gree.
Di defence counsel also file bail applications today both orally and formally wey di judge go hear on Wednesday.
EFCC also dey in possession of dia International passports.
- Why di EFCC arrest Nigeria former Accountant-General
Thirty pipo die for fire afta bus accident for Kaduna
Nigerian authorities say at least 30 pipo don die and at dozen odas injure afta fire catch for road accident for di northern state for Kaduna.
Na three passenger busses follow jam each oda on Thursday evening before dem catch fire for di highway wey dey link Zaria and Kano.
Di commander of di Nigeria road safety agency for Kaduna State, Hafiz Muhammad tell BBC say women and pikin dem dey among di victims.
Di accident happun for area wia vehicles suppose divert sake of road construction for di highway.
Officials say dem tink na di drivers "impatience" cause di accident.
Ghana police on manhunt for killers wey shoot 22-year-old student inside en vehicle
Wetin dey cause miscarriage for women and how to prevent am
'Na your bank cause delay in payment' - Police tell officers wey participate for Osun election
Di Nigeria Police Force say dia personnel wey participate for di Osun State govnorship election duty and neva receive payment gass take note say na dia bank cause di delay.
Dem say di officers forward dia account details to di Police Accounts and Budget (PAB) office at di Force Headquarters and dem make payments accordingly.
One statement from di police tok-tok pesin CSP Olumuyiwa Adejobi say dem disburse di funds to di officers account directly and not through any state police command.
"As such, individuals start to dey receive payment alerts even before di commencement of di election. However, one of di new generation banks (name withheld), wey some of di officers accounts dey report delays in disbursement sake of technical issues.
"We follow am up immediately and from all indications, di concerned bank don commence payments," di statement tok.