You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Court go rule on Abba Kyari bail application on August 30

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Federal High Court for Abuja don adjourn di ruling on Abba Kyari bail application to August 30, 2022.

    Justice Emeka Nwite during hearing of di bail application on Wednesday for Abuja, decline di bail application wey dem file for April 2022.

    Counsel to di defendants move for fresh application for dia bail, dem tok say dem fit dey innocent.

    Di prosecution counsel no agree sake of di gravity of di 'alleged' offences wey dem commit.

    Wen Justice Emeka Nwite hear dia arguments finish, she adjourn ruling on di new bail application to August 30, 2022.

    Meanwhile, hearing of di substantive trial of di seven defendants kontinu, and 3rd prosecution witness, Peter Joshua take di witness stand.

    Abba Kyari dey face charges say e allegedly joinbodi wit oda team members to do traffic drugs, money laundering and tampering wit evidence.

    Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) dey try to secure court order for dia extradition to di United States for trial wey involve alleged links to internet fraudster, Hushpuppi.

  2. ASUU strike latest: Goment clarify tok about 'two weeks ultimatum' to end industrial action

  3. National Electricity grid collapse again

    Major cities for Nigeria go experience blackout sake of di National electricity grid wey don collapse again.

    Electricity distribution companies announce say one system collapse on di national grid around 11am on Wednesday.

    Eko Electricity Distribution company say dem dey follow di Transmission Company of Nigeria tok on wetin cause di collapse and a possible timeline of wen power go dey restored.

  4. Amnesty Nigeria call for probe into deaths of youths

    Amnesty International want make di Nigerian goment torchlight di deaths of a group of young men for di south-east of di kontri as dem describe wetin happun to dem as "horrifying".

    Reports of di number of pipo wey dem kill vary from seven to 14.

    Di youths bin attend one wedding for Imo state and dey on dia way home wen security officers shoot dem, Amnesty tok.

    Di rights body tok say di youths no dey armed.

    "Such killings no dey justified under any circumstances whatsoever,” Osai Ojigho, di director of Amnesty International for Nigeria tok.

    AFP news agency report say di Nigerian state security agency, di Department of State Services (DSS), don claim responsibility, as dem accuse di men say dem be members of di militant arm of separatist group - Ipob.

    Di AFP also quote Nigerian authorities wey say di men dey armed and dem open fire.

  5. Tanzania don appoint new police chiefs

    Tanzanian President Samia Suluhu Hassan don appoint new head of police.

    Dis na as criticism dey ground on top recent human rights violations by di kontri security officers.

    Madam Samia on Tuesday appoint Camillus Wambura, di former director of criminal investigations, as di new inspector-general of police.

    He dey replace Simon Sirro wey don get anoda post as di Tanzania ambassador to Zimbabwe.

    President Samia also appoint Ramadhan Hamisi Kingai as di new director of criminal investigations.

    As she reshuffle di top bosses, President Samia say her goment priority na to get an efficient force wey go observe di rights of di pipo and dia property.

    She add say committee go dey to assess police performance.

    However, human rights activists describe di changes as "delayed".

    Di change dey come one month afta some pipo accuse di Tanzanian police say dem use violence comot Maasai herders from dia ancestral land for di northern Ngorongoro district.

    At least 30 pipo injure during di clashes between protestors and security forces.

  6. Family of woman wey allegedly set husband on fire dey on di run - Police

  7. Netflix lose almost one million subscribers

    After e enjoy long reign as di king of streaming, Netflix dey face tough fight to keep dia crown.

    Dem lost almost one million subscribers between April and July as more pipo decide to comot di service.

    Di streaming giant now don lost members for two quarters inside one row, but di drop small past wetin dem fear.

    For wetin slow di exodus, di company oga Reed Hastings, say: "If one single tin dey, we fit tok 'Stranger Things.'"

    Di new season of di hit drama be real success, and fit don help reduce di japa of Netflix customers.

    Di company bin first report subscriber loss since 2011 for April, news wey dey followed by hundreds of job cuts and one sharp drop for dia share price.

    Rivals dey challenge how dem dominate, while price increase also cause gbege.

  8. APC unveil dia vice presidential candidate

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Di ruling party for Nigeria, di All Progressives Congress (APC) don officially unveil former Borno State Govnor, Senator Kashim Shettima as di vice presidential candidate of di party for di 2023 general elections.

    Di unveiling ceremony happun for di Shehu Mus Yar Adua Centre for Abuja, di Nigeria capital.

    Plenti party pipo, supporters, sitting and former govnors attend di event, plus about 40 pipo wey tell our tori pesin say dem be members of di Nigeria College of Bishops wey come from across di kontri.

    For im acceptance speech, Senator Kashima tok say im stand gidigba wit di Nigeria Project, e tell di pipo wey dey vex sake of di Muslim - Muslim ticket say im go be vice president for all, e tell evribodi to go inside town to tell pipo about unity.

    "I no be vice president for muslims, I no dey seek vice presidential office to protect di Hausa/Fulani /Kanuri tribe, I believe in di Nigeria project" E tok.

    "Make una go to di nooks and cranny of di kontri wit di song of unity and progress, sing di song of unity peace and stability make we unite dis nation"

    Na early dis month di APC presidential candidate Asiwaju Bola Ahmed Tinubu tok say e choose Senator Kashim Shettima as im running mate.

    See some fotos of di event.

  9. Why 'changes' to grave of late Ghana President Atta Mills dey cause fight 10 years after he die 

  10. Apple agree to $50 million to settlement for US ontop dia MacBook keyboards.

    Apple don agree to pay $50 million to settle legal action for US ontop dia MacBook keyboards.

    Customers for seven states claim say Apple bin sell di "butterfly" keyboards for MacBook, MacBook Air and MacBook Pro laptops from 2015 to 2019 even though dem bin sabi say dem get unresponsive and sticky keys wey dust and doti go fit spoil.

    Di tech giant say dem no do anything wrong sha.

    Di settlement fit mean say customers fit get up to:

    • $395, if dem don replace plenti keyboards
    • $125, if dem replace one
    • $50 for pipo wey don replace key caps

    Judge go still need to approve dis preliminary agreement.

  11. Author Chimamanda Adichie back Peter Obi for 2023 election

    Popular Nigerian author Chimamanda Ngozi Adichie don throw her support behind Labour Party presidential candidate, Peter Obi, ahead of di kontri February 2023 elections.

    Di ogbonge writer announce her support for one Facebook message on Tuesday to Oga Obi on im birthday.

    She describe di politician as "my dearest Big Bro" and tok about Oga Obi "hope and belief for wetin Nigeria fit be".

    "Mummy call you her ‘first son,’ my siblings and I call you our 'big bro,' and I no fit wait to call you ‘My President'," she write.

    "I no fit wait for February 25, 2023, wen I, wit personal pride in you and wit hope for wetin Nigeria fit become, go cast my vote for you and your running mate, Senator Yusuf Datti Baba-Ahmed."

    Oga Obi be di former govnor of Anambra state.

  12. Bread bakers don begin one week nationwide strike, Price of bread in increase many times dis year

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

    Association of Bakers and Caterers of Nigeria don begin strike action across di kontri.

    Chairman of di Association for Rivers State Chidi Orlu tell BBC Pidgin say di strike action go last for one week starting from Wednesday 20 July, 2022.

    E say dia aim na to draw di attention of goment to di challenges dem dey face for di bread industry especially with di way materials dem dey work with dey increase any how.

    "We wan draw goment attention to di somtin about di constant increase in cost materials, especially flour.

    We want make dem check di wey flour millers dey increase di price of flour and also look into di tax on importation of flour and oda baking materials because we wey dey di bread industry dey suffer."

    Orlu add say di strike action na also to let bread consumers know di situation of tins so wen dem dey increase price of bread, dem go understand wetin dey go on.

    But many bread sellers for Port Harcourt no know about di strike by Bakers.

    Some of dem wey like Chioma Vincent wey tok with BBC Pidgin say wetin dem know na say for some time now, price of bread don increase and even though customers dey complain, dem still dey buy.

    "I no know of any strike o but bread don increase. Di price don increase more than three times dis year. Customers still dey buy na, especially di ones wey get small children dem dey buy even though dem dey complain." She tok.

    Many big outlets wey dey bake and sell bread for Port Harcourt still dey sell bread.

  13. NCDC put Nigeria on high alert as Marburg virus kill two for Ghana

  14. Raila Odinga: We no go spare any corrupt person

    Kenya opposition leader Raila Odinga say dem no go spare anybody for one anti-corruption campaign wey e promise to implement if dem elect am as president for di next month election.

    Odinga dey make im fifth and final attempt as e contest for di kontri top job.

    Odinga say if im win, e go focus on fighting corruption.

    Kenya president di kontri don loss more than $16m (£13m) a day to corruption.

    “No-one dey indispensable. If I dey find out say I dey corrupt, tmake dem deal with me,” e tok, citing di South Korean example where dem impeach President Park Geun-hye and jailed am for nearly five years for corruption.

    Concerning di economy, Odinga tok say e go introduce austerity measures and look for ways to reschedule foreign debt to make sure say di kontri no default on repayment.

  15. Wetin di new NNPC Limited mean for Nigerians

  16. Robert Lewandowski: Poland striker complete move from Bayern Munich to Barcelona

    Barcelona don sign Poland striker Robert Lewandowski from Bayern Munich on a four-year contract worth 50m euros.

    Di 33-year-old say im dey happi to finally join di Spanish club and e promise to epp dem win many titles.

    "Di last few days bin dey very long, but di deal don done now I fit focus on a new chapter and challenge in my life," di player tok.

    "I bin don always wish to play for La Liga and for di big clubs.

    "I dey here to help Barca get back to di top and win as many titles as possible."

  17. Police caution Osun Govnor-elect, supporters over victory celebration

    Di Osun State Police Command don caution Govnor-elect Senator Ademola Adeleke as e go receive im Certificate of Return today afta winning di July 16 gubernatorial poll for di state.

    Tok-tok pesin for di police command Yemisi Olawoyin say make Senator Adeleke and im supporters celebrate dia victory moderately and avoid wetin fit cause trouble for di state.

    "Dis caution/advice dey pertinent as hoodlums/criminals/thugs fit capitalize on di guise of celebration to hijack and perpetrate dia nefarious acts and jeopardize the Peace of di State," di statement from Olawoyin tok.

    Ademola Adeleke wey be di candidate of di main opposition party for di state emerge winner afta e poll 403,371 votes to beat im closest rival Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress wey poll 375,027 votes.

  18. Togo begin tok-tok on detained Ivorian soldiers

    Togolese Foreign Minister Robert Dussey meet wit Ivorian officials for Abidjan on Tuesday for tok-tok on 49 Ivorian soldiers wey chop arrest for Mali earlier dis month.

    Di soldiers bin chop arrested wen dem arrive for Bamako on suspicion say dem be mercenaries.

    Ivory Coast insist say di troops dey dia to support di UN mission, known as Minusma, under one agreed contract between di two kontris.

    But di junta for Mali say dia foreign ministry no dey informed of di deployment via di official channels.

    On Tuesday, Oga Dussey indicate say di Ivorian president and di Malian junta leaders bin wan preserve peace between dia nations, according to one statement.

    President Alassane Ouattara express im gratitude to di minister for di initiative to find a resolution to di matter, di statement add.

    Ivory Coast don dey call for di immediate release of dia soldiers.

  19. Buhari salute Super Falcons despite loss to Morocco

    Nigerian President Muhammadu Buhari don commend Super Falcons for dia Semi final game against Morocco at di Women Africa Cup of Nations.

    Di host kontri beat Nigeria 5-4 wit penalty afta di match end for 1-1 on Monday.

    Buhari say e believe di team go achieve great tins for future tournaments and e go dey always support dem.

    Di president make di statement through im special adviser on media and publicity Femi Adesina.

    ‘‘Although many go dey disappointed wit di Moroccan victory on penalties, many positive outcomes dey for di Nigerian team to take home and prepare better for di next tournament,’’ Buhari tok for one statement Adesina release yesterday.

  20. Sri Lanka don elect Ranil Wickremesinghe as president

    Sri Lankan MPs don elect prime minister Ranil Wickremesinghe as di kontri new president.

    Oga Wickremesinghe face di task of leading di kontri out of dia economic crisis and restore public order afta months of mass protests.

    E defeat im main rival for di job, Dullus Alahapperuma, wit 134 votes to 82 for di parliamentary vote.

    Sri Lanka's ex-president Gotabaya Rajapaksa frun comot di country last week.

    E japa to di Maldives and den Singapore afta thousands of protesters enta im presidential residences and oda government buildings, calling for im resignation.

    Dem don also call for di resignation of Mr Wickremesinghe, wey dem appoint as prime minister in May.

    Protesters burnt down im private home and also enta im prime ministerial office for Colombo in demonstrations against im leadership.

    But protesters also want make im komot afta President Gotabaya Rajapaksa resign

    Di PM face a serious challenge from Dullas Alahapperuma, one ruling party MP wey di main opposition dey back.

    E go serve out di rest of Mr Rajapaksa's term, wey go ends in November 2024.

    Sri Lanka currently dey bankrupt and dem dey face acute shortage of food, fuel and oda basic supplies.