'Na hard day' for Weinstein survivors - Ashley Judd

Wetin we call dis Video, Ashley Judd: 'Na hard day' for Weinstein survivors
Published

Hollywood actress Ashley Judd say di overturning of disgrace movie entrepreneur Harvey Weinstein 2020 rape conviction na "hard day for survivors".

"But we live in our truth," Judd tell BBC News for one interview.

Di case against Weinstein bin be landmark moment for di #MeToo movement.

Di New York Court of Appeals don order new trial, as e say di original one bin dey full of bias from witnesses wit wey no get anytin to do wit di charges wey dem bin judge.

Weinstein maintain say im dey innocent.

Di 72-year-old go still remain for prison as anoda court for for Los Angeles bin sama am separate rape conviction.

But plenty pipo dey criticise di overturning of di New York conviction, dem include lawyers and #MeToo activists wey see am as say di survivors just return to square.

Judd, di first actress to come forward wit claim against Weinstein, say her day scata as she hear say dem order am new trial.

Di actress – wey be star for feems like Ruby in Paradise, Heat and Norma Jean & Marilyn, and also be part of Silence Breakers group – add say di court decision na betrayal for sexual assault survivors.

"Many times survivors dey say di betrayal and di moral injury we suffer inside di system dey worse dan di sexual body invasion we experience in di first place," Judd say.

She also commend pipo wey bin come forward for New York case against Weinstein.

"We know wetin happun and di truth dey constant," she say.

Di New York Appeals court bin reach four-three ruling, wey say Weinstein 2020 trial bin "wrongly add testimony of cases wey dem no charge, alleged sexual acts from before, against pipo wey no follow complain about di original crimes".

E also say di trial judge bin allow dem question Weinstein inside court in way wey make am look like say im dey "highly prejudicial". "The remedy for dis shocking errors na new trial," e add.

Harvey Weinstein for court

Wia dis foto come from, Getty Images

For im trial for 2020, Weinstein bin chop conviction for sexually assaulting former production assistant Mimi Haleyi for 2006 and raping Jessica Mann, one former aspiring actress, for 2013. Court jail am for 23 years.

Weinstein lawyers say sex between di movie executive and di accusers bin dey consensual or di two bin dey in agreement to have sex.

Dem sentence Weinstein for California last year to 16 years for raping one Italian model and actress for one Beverly Hills hotel for 2013.

Di conviction no dey affected by di for New York.

Im go remain for Mohawk Correctional Facility for New York state while Manhattan district lawyers dey consider weda to launch new trial.

Complainants, lawyers and campaigners describe Thursday ruling as "tragic" and "leap backwards" for di right of victims of sexual abuse by powerful men.

Gloria Allred, one lawyer wey represent Mimi Haley, di main prosecution witness for New York case, say her client go consider testifying again "even though di process of testifying dey tough and e go traumatise Mimi again".

"I commend Mimi on her courage and willingness to keep standing up for di truth," she say, come add say "although victims don lost dis battle dem never loss di war. We go continue to fight for justice".

Di Silence Breakers earlier say im members no go bow decision wey dem regard as "strongly unjust".

For one news conference for New York, members including Judd say dem go continue to fight for justice for victims of sexual abuse and violence.

Katherine Kendall, wey allege say Weinstein bin chase her around one hotel room naked, say di decision na "terrible reminder say victims of sexual assault just no dey get justice". "I dey completely let down by di justice system right now," she add.

Tomi-Ann Roberts, one professor of psychology for Colorado College wey allege say Weinstein sexually harass her for 1984, say she hope say di overturning of im conviction go "give #MeToo movement new energy again".

She add say sexual assault victims "wey go up against powerful men dey hardly get justice. But di important tin be say we no go stop to speak out".

Douglas Wigdor, na lawyer wey represent eight of Weinstein accusers, im say di appeal court decision na "major step back for holding pipo wey dey accountable for acts of sexual violence".

"Courts dey sometimes allow evidence of oda acts wey dem no charge... dem explain to di jury di relevance of dis testimony," im add. "E go require di victims to endure anoda trial."

Lindsay Goldbrum, wey represent six Weinstein victims, say di appeal court criticism of di use of witnesses wey no directly connect to di charges na "leap backwards" and damaging to future cases.

She say di witnesses get "notin to gain personally from participating for di trial. Dia only goal na to give voice to dozens of oda women wey don suffer so much".

Madeline Singas, one of di judges wey disagree wit di appeal ruling, say wit di decision, "dis court continue to stop di steady gains survivors of sexual violence don fight for for our criminal justice system".

How dis case overturn go affect Harvey Weinstein

Court sketch of Harvey Weinstein as dem bin dey read im sentencing for 2020

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Court sketch of Harvey Weinstein as dem bin dey read im sentencing for 2020

Harvey Weinstein still get di 16 years prison sentence from di Los Angeles case so e no dey comot from prison even as dem dey try decide if new trial go happun as per wetin di court order.

Now e go be di decision of Manhattan District Attorney Alvin Bragg to decide weda dem go retry Wein stein.

But e no mean say di lawyers of di case no get opinion of wetin dis mata mean to Harvey Weinstein.

Oga Weinstein lawyer, Arthur Aidala tell di New York Times say dis decision na victory to both im client and "for everi criminal defendant for di New York state", and hail di appeals court say dem "uphold di basic principles wey criminal defendant suppose get for trial".

Even as im tok say dem neva tell Weinstein about di ruling.

One lawyer wey bin represent eight of di pipo wey accuse Weinstein say, di ruling dey "tragic" and and na "major step back for holding di pipo wey get hand for acts of sexual violence".

E add say, "Courts dey normally admit evidence of oda uncharged acts... di jury go get instruction on di relevance of dis kain testimony. Dis go make di victims to endure anoda trial."

How di New York Case come about?

Weinstein bin dey tried on top five charges for im New York Trial but dem bin find am guilty for only two for 2020.

Di first na di first degree criminal sexual act against one production assistant wey her name be Miriam Haley for 2006. Di second one na third degree rape of one upcoming actress Jessica Mann for 2013.

Even wit di 23 years imprisonment, di jurors find am not guilty for di more serious charges wey include predatory sexual assault, wey for give am even longer prison sentence.