Meet di 28 governorship candidates of opposition ADC for 2027 elections

Wia dis foto come from, ADC/X
Former Labour Party govnorship candidate for di 2023 election, Gbadebo Rhodes Vivour and former Attorney General of Nigeria, Abubakar Malami names dey for di list of govnorship candidates wey di African Democratic Congress (ADC) release.
Di opposition party for Nigeria publish di names of di pipo wey dey contest for govnorship positions plus dia deputies for di 2027 general elections for 28 states.
One popular name for di list na Great Ogboru of Delta State wey don dey contest to be govnor since year 2000. E bin contest against former Delta State govnor James Ibori.
Since year 2000, Ogboru don join different political parties back to back, but e no ever emerge as winner.
For post wey di National Publicity Secretary of di political party, Mallam Bolaji Abdullahi sign for dia official page, e tok say dem bring out dis list " to offer Nigerians credible leadership and real alternative."
Di Action Democratic Congress dey face serious internal gbege sake of di kasala wey dey happun for some states wey get factions.
Even though dem bin dey try to solve di mata, e drag sotay di two factions land for court and court still dey do back and front for di mata.
Full list of ADC govnorship candidates and dia states
Abia State govnorship candidate - Kalu Kalu Agu
Kalu Kelechi na Lawyer and Nigerian politician. E bin contest for di 2023 Abia State House of Representatives election under di African Democratic Congress (ADC) candidate but e lose di election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Alozie Ogadinma Darlington go serve as di Deputy govnor.
Adamawa State govnorship candidate - Modibbo Hamman Tukur Ribadu
Modibbo Hamman Tukur Ribadu bin serve as di director of di Nigerian Financial Intelligence Unit for 2019. E get Master of Science (MSc) degree in International Business and e bin serve as assistant director for NFIU bifor di appointment.
E dey among di first set of staff wey start for NFIU, under di EFCC. E join di intelligence group for March 2005 as Financial Intelligence/Transaction Analyst and Bank Compliance Examiner.
Aguwa Kevin Iliya - Deputy govnor
Akwa Ibom - Akpanudoedehe John James
Akpanudoedehe John James serve as senator for Akwa Ibom North-East Senatorial District for 1999.
James work as Sales Manager for Dajucom for di 1980s, bifor e establish im own company John Silver Group.
Nsien Mkpombik Tommy - Deputy govnor
Bauchi State - Haliru Dauda Jika
Dem born Halliru Dauda Jika for 1976 for Bauchi State, Nigeria. Jika na businessman and politician.
E bin serve as speaker for Bauchi State House of Assembly and represent Bauchi Central.
Jika attend Sardauna Memorial College for Kaduna, Kaduna State for1999. E later move to Kaduna Polytechnic to study Civil Engineering and graduate for 2003.
Sama'lia Mohammed Kabir - Deputy govnor
Benue State - Herman Iorwase Hembe
Herman Iorwase Hembe na Nigerian politician and lawyer from Konshisha local government area of Benue State for north central Nigeria.
Dem born am on 22 June 1975.
Hembe join politics wen e dey study for Benue State University. Dem first elect am to di House of Representatives for 2011 to represent di Vandeikya/Konshisha Federal Constituency of Benue State.
During di time as a lawmaker, e serve as Chairman, House Committee on di Federal Capital Territory (FCT) and later as Chairman, House Committee on Public Procurement.
For 2022, e bicom di Labour Party candidate for di 2023 Benue state govnorship election.
Abba John Abba - Deputy govnor
Borno State
Babagana Buhari
Mamman Dauda
Cross River State - Nkoyo Toyo
Nkoyo Toyo na lawyer, development activist, and politician wit career wey cut across public service, advocacy, and policy development.
She hold degrees from Ahmadu Bello University, University of Lagos, University of Sussex, and Harvard Kennedy School.
Tokyo bin serve as Nigeria Ambassador to Ethiopia and Djibouti, she represent di kontri for di African Union, Peace and Security Council, and Economic Commission for Africa.
She also serve as House of Representatives member, wia she champion foreign affairs, gender reforms, and peacebuilding efforts.
Bifor she join politics, she co-found Gender and Development Action (GADA) for 1994, one organization wey dey improve access to economic and political opportunities for women in Nigeria.
Okwoche Andrew Adagbor - Deputy govnor
Delta State - Great Ogboru
Chief Great Ovedje Ogboru na number 4 out of 16 pikin. Dem born am on 10 April, 1958 for Port Harcourt to Ogboru family of Abraka. Im na Urhobo man.
For 1980, Great Ogboru enta Lagos go hustle. At 25 years, im start im own business Fiogret Ltd wey be frozen fish trading company.
Di company enta different different business like furniture production, shipping and even bureau de change operations.
For 1990, accuse land im head say im get hand for coup plot against Gen. Ibrahim Babangida. Di accuse make Ogboru go exile for UK from 1990 to 2000. Im later move to Angola and Namibia. But for 1999, Gen. Abdulsalam Abubakar goment clear im name.
As im dey exile for UK, im go Chartered Institute of Marketing London. Im also go Huron University of South Dakota, London Campus for MBA, den im come get Masters degree for International Relations from University of Kent in Canterbury.
Im believe say di Delta State dey very poor situation and tins must change. Na dis make am contest Guvnorship position since 2003 for different different political parties. Im contest as govnorship candidate for Alliance of Democracy for 2003, Democratic Peoples Party for 2007 and 2011, Labour Party for 2015 and for di All Progressives Congress for 2023.
Now Great Ogboru na di govnorship candidate for di African Democratic Congress for Delta State for 2027 general elections.
Afiari Gloria - deputy govnor
Ebonyi State
Ukpai Mbah Ude
Onwe Daniel Ede
Enugu State
Ochi Oboozeze Chukwuma
Eze Anrze Christopher
Gombe State
Bala Bello
Bala Sani Sisa
Jigawa State - Sabo Mohammed Nakudu
Dem born Sabo Mohammed Nakudu on 11 September 1968 in Maiduguri, the capital of Borno State, Nigeria.
Nakudu bin serve as member of di House of Representatives from 2007 to 2015. E serve for two terms representing Birnin Kudu Constituency.
For 2015, e contest for Jigawa South West Senatorial under di platform of di All Progressives Congress and e win.
For October 2022, former Nigerian president Muhammadu Buhari award Nakudu wit di National honour of di Commander of di Order of di Niger.
Now, e dey contest for govnor under di platform of di ADC.
Musa Yau Balarabe - Deputy
Kaduna State - Isa Mohammed Asiru
Isa Mohammed Ashiru na Nigerian politician and e describe imsef as development-focused leader from Kudan, Kaduna State.
According to di informate on im website, e get ova 17 years of civil service and extensive legislative leadership.
Ashiru serve as member of di federal house of representatives from 2007 to 2015.
E be PDP govnorship flagbearer for di 2019 general election.
Ashiru na di govnorship candidate for di ADC for di 2027 election.
Kantiok Rmiya Ishaku - Deputy govnor
Kano State
Ibrahim Ali Amin
Shehu Abdulkadri Bari
Katsina State - Ahmad Babba-Kaita
Ahmad Baba Kaita na former house of representative members wey represent Kankia/Ingawa/Kusada constituency from 2011 – 2018.
Dem first elect am as senator for 2018 under di platform of di APC afta one bye-election. E contest again for 2019 and e win.
Dem born Babba-Kaita on 8 September 1968.
Deputy govnor - Aminu Yar Adua Ahmed
Kebbi state - Abubakar Malami
Abubakar Malami (SAN) na ogbonge Nigerian politician and lawyer. Dem born am for 10 April, 1967 for Birnin Kebbi for Kebbi State. Im father na popular judge of di Sharia Court of Appeal wey preside ova plenty important matters on Islamic law.
Di former Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami, bin emerge as di African Democratic Congress (ADC) govnorship candidate for Kebbi State.
58-year-old Malami, na one of di most influential figures for di administration of former President Muhammadu Buhari between 2015 and 2023.
Di former chief law officer currently dey face criminal prosecution bifor di Federal High Court Abuja for inside one case wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring against am.
E dey charged wit 16 counts charges wey border on money laundering and abuse of office wey worth a total of 8.7bn naira ($6m; £4.5m).
Di lawyer, wey dey married to Buhari third child, Nana Hadiza, bin comot di ruling All Progressives Congress (APC) to join di opposition African Democratic Congress, wey dey viewed as di biggest rival to di APC for di 2027 general elections.
Kwara state - Zakari Mohammed
Zakari Mohammed na Nigerian politician, administrator and media professional.
Dem born am on 7 July 1973 for Baruten local govment area of Kwara state.
Mohammed represent di Baruten/Kaiama Federal Constituency from 2011 to 2019 for di federal house of representative. During di 7th National Assembly, e serve as Chairman of di House Committee on Media and Public Affairs.
For di 8th National Assembly, e lead di House Committee on Basic Education and Services plus di House Committee on Oil Swap Contracts.
Olawuyi Julius Olayide - Deputy govnor
Lagos state - Gbadebo Rhodes-Vivour
42-year-old Gbadebo Rhodes-Vivour na architect, public policy expert plus politician.
Dem born am for 8 March 1983 to di Rhodes-Vivour family of Lagos. According to am, e be proud Lagosian, as im root and antecedents na from Lagos state.
Gbadebo come from di family of accomplished legal luminaries. Im father, Justice Olawale Rhodes-Vivour na former Supreme Court of Nigeria justice. Di late Judge Akinwunmi Rhodes-Vivour na im grandfather, e also be di great-grand son of Judge Steven Bankole Rhodes, di second ever indigenous judge Nigeria appoint.
Sake of im interest for politics and activism, e go do im second Masters degree in Research and Public Policy for di University of Lagos (UNILAG).
For inside one exclusive interview wit BBC Pidgin for 2023, Gbadebo say as architect wey im be, im go "design Lagos wey go work for everybody."
Gbadamosi Babatunde Olalere - Deputy govnor
Nasarawa State
Nuhu Angbazo
Ahmed Yusuf
Niger State
DR. Mohammed Kpautagi
Musa Mamman
Ogun State
Biodun Collins Ogundipe
Muraina Oluwaranti Oluyemi
Oyo State
Taofeek Adegboyega Adegoke
Wahab Adeniyi
Plateau State
Brig.Gen John Sunday Sura
Pwajok-Kele Chundung Bitrus
Rivers State
Gabriel Pidomson
Okumgba David Amapakaye
Sokoto State
Manir Mohammad MOHAMMAD Daniya
Isah Bello Ambarura
Taraba State
Abubakar Umar Tutare
Kwetishe Haruna Kwenyan
Yobe State
Kassim G. Gaidam
Kori Lawan Mohammed
Zamfara State
Shinkafi Bilyaminun Yusuf
Muhammad Abdulmuddalib Auwal
Why 28 states inside of 36 and di FCT?
Di African Democratic Congress publish di names and deputy govnorship candidates sake of say na di ones wey go run for di 2027 elections.
Oda states don do dia own elections and doz states na di states wey dey do off-cycle election for Nigeria.
Di off-cycle election states na Osun State wey just do dia own last month, 15 August wey Ademola Adeleke of Accord Party win and ADC candidate na Najeem Salaam.
Bayelsa , Anambra, Imo, Ondo, Edo, Ekiti and Kogi na oda states wey dey do off- cycle elections.















