'Within one year we go control insurgency and insecurity for Nigeria' - Atiku Abubakar
Former vice president of Nigeria Atiku Abubakar don assure Nigerians say im go control di insurgency and insecurity problem for Nigeria within one year if e enta office.
Di presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC) give dis assurance for exclusive interview wit di BBC.
Since di official window for presidential campaign open, Atiku dey grant interviews wia e dey tok about im plans for Nigeria if im becom president.
Atiku wey don contest plenty times to becom president of Nigeria but neva dey successful tok say Nigeria need to invest for police and di armed forces.
E also tok how e go take control one of di biggest problems for Nigeria and di West Africa subregion.

According to di ogbonge politician, Nigeria get 200 million pipo, and yet di number of police officers and men dey small.
"We dey ova 200 million pipo, and yet we get less dan 200,000 policemen," Atiku tok.
Di businessman wey come from northern Nigeria say e no go waste time bifor Nigeria start to see positive changes for security mata if e becom president.
"And believe me, within one year we fit control dis insurgency and insecurity wey dey evriwia."
E explain say one of di reasons why di problem of insecurity dey increase na becos of di relationship between West African kontris wey no too good and bandits dey enta Nigeria from dose kontris."
2027 opposition and why e dey contest evritime
On weda di opposition go come togeda as one for di 2027 presidential election, Atiku say dem still dey do tok-tok about am.
"We still dey tok to oursefs, na issue of strategy. No worry. We go come togeda".
About why e dey contest evritime for presidency even though e no win," Atiku tok say to contest na im constitutional right and if im lose dis election e no go contest again.
However Atiku add say im dey strong, agile and healthy to contest di presidential election. Im also allege say if na about age, e young pass di current president of Nigeria and im go prove am for court say President Bola Tinubu don reach 90 years.
Atiku say im don do tok-tok wit economists and experts wey tok say Nigeria govment fuel subsidy removal and di money wey dem don realise from am neva benefit di ordinary Nigerian as e add say e don further throw di pipo into poverty.
"Di govment claim say dem don make plenty money. Okay, if you don make plenty money, you don invest di money for di welfare of di pipo, for dia well-being, for dia security?
"You neva do am. Our security don worse. Our unemployment don worse. Our debt don worse. We be one of di poorest kontris today for di world. I mean, with all di resources wey we get. So, I mean, issue also dey on mismanagement of di economy," e tok.











