'Dem say we must leave, say dem go do house to house search' - Nigerians cry out ahead of June 30 deadline for migrants to comot for South Africa

Large numbers of men gada wit sticks

Wia dis foto come from, Darren Stewart/Gallo Images via Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Nigerian trader and businessman Wilson Oghodero say Nigerian citizens wey dey live for South Africa dey under pressure as di 30 June deadline wey anti-migrant groups give undocumented foreigners dey approach.

Wilson tell BBC say di groups don warn say dem go carry out house to house search for documentation afta di deadline.

Dis don make tension dey rise among Nigerians wey still dey South Africa wey don register to leave di kontri.

Anti-migration groups for South Africa wey dey call for tougher immigration enforcement don set 30 June as di deadline for all foreigners wey no get legal documents to dey for di kontri to leave.

Wilson say since dat announcement and since Nigeria govment don declare interest to repatriate dia citizens from South Africa, most of dem don already leave dia houses, end dia rental agreement and don move closer to di Nigerian mission for Pretoria dey await for di evacuation flight.

Earlier dis month, one flight wey carry 268 Nigerians bin land for Lagos from Johannesburg as part of ongoing evacuation efforts. Nigerian authorities say around 1,000 pipo bin register to leave.

"Some pipo come from far places and dem dey camp for Nigerian commission, becos dem no fit go back home, dem don sell dia property. Just like me, I no get anytin for my house, na just my bag, I ready, na dia call I dey wait for."

E say e dey worry am as di mata no clear.

"Right now, I dey stranded, I no even know wetin I go do for di end of di month. I don already tell my landlord say I dey go."

Wilson say pipo wey wan comot dey wait for clear communication from authorities. "Dem no give any particular date, we still dey wait and we dey under pressure," e add.

Nigerian government bin earlier tok say di second batch, out of five approved flights, go leave on 15 June, but dem neva provide any update on di delay or new schedule for dose wey still dey await repatriation.

BBC don reach out to officials for comment and dem say dem go release statement.

Oda Nigerians for South Africa don also complain say dem dey stranded for di High Commission office as dem dey wait for Nigerian govment to evacuate dem bifor di June 30 deadline.

For video wey show face for social media, some of di stranded Nigerians follow tori pipo tok on how dem dey struggle to feed for di High Commission.

Nigeria, like some oda African kontris wey include Ghana, Malawi, Zimbabwe and Mozambique don dey move dia citizens from South Africa following weeks of protests.

Reports of some incidents of violence against foreign nationals also dey ground, although authorities no release full details and official figures of dis incidents.

Demonstrators argue say undocumented migration dey put pressure on public services and dem dey call for tighter border enforcement.

South African govment say dem dey work to address illegal migration concerns and don urge di public say make dem no target foreign nationals.

Wilson, however, tok say pressure from protesters don continue for local communities. "Dem no dey work under immigration; dem be just normal citizens," e tok.

'So many pipo dey sick' - Nigerian for South Africa

Anoda Nigerian, Christian Onyenweaku, wey tok to local media News Central say pipo dey sick for di High Commission office wia dem dey.

E say di situation dey painful and Nigerian govment no fulfil di promises wey dem make.

"Pipo dey stranded and dey sleep for streets. So many of dem dey sick, if you go inside you go see so many of dem wey dey sick becos of di situation."

"E dey so embarrassing, e dey painful. Dem dey promise us today, anytime dem promise us, dem dey always fail."

According to di Nigerian, dem no see food chop, if no be some churches and organisations wey dey help dem.

"Right now, to see food chop dey difficult, if no be for some pastors from Nigeria wey come wit some food and some oda organisations wey make sure say dis pipo get food."

'No pesin suppose carry dangerous weapons or firearms' - Police

South African Police say dem no go allow make anybodi carry weapon during di June 30 planned protest against illegal migrants.

Di police say dem dey ready across all di eight districts for South Africa and go deploy law enforcements ahead of di protests.

Provincial Commissioner for Eastern Cape, Lt Gen Vuyisile Ncata, say dem no go allow any act of violence during di protests across South Africa.

"While we acknowledge and respect di constitutional right of citizens to engage in peaceful demonstrations, we no go allow any act of lawlessness, violence, intimidation, or criminality," Lieutenant General Ncata tok.

"We also call on organisers of marches to play dia part by discouraging participants from carrying weapons or engage in conduct wey go provoke violence or place odas at risk."

Police say dia officers go stand gidigba to enforce di law and dem go take necessary actions against anyone wey dem catch wey violate di law.