Nigerian singer Davido cry out to Trump, international community ova Osun State govnorship election

Wia dis foto come from, Frazer Harrison/Getty Images, Eric Lee/Getty Images
Nigerian singer David Adeleke wey pipo sabi as Davido don call on United States President Donald Trump to pay attention to di situation for Osun State ahead of di govnorship election wey go happun on Saturday, 15 August.
E make di call on im official X account on Tuesday, 11 August, wia e also call on di international community.
Davido say "growing concern dey about tension and di possibility of violence, intimidation, or disruption of democratic process" for di state.
"Osun pipo deserve to exercise dia constitutional right to vote freely, peacefully, and witout fear.
"I appeal to di United States and di international community to pay close attention to di election and encourage all relevant authorities to ensure say evri voter dey protected and evri vote dey respected," e write on X.
"We no want bloodshed. We no want intimidation. We want peace, transparency, and a free and fair election. @realDonaldTrump."
Wetin bin happun bifor Davido cry out
Davido na nephew of di current govnor, Ademola Adeleke, wey dey run for re-election under Accord party.
Davido call to Trump and di international community dey come afta di controversy wey trail di freezing of Osun State account by di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).
Di EFCC say dem bin don dey investigate di Osun State account sake of say dem suspect some magomago wey dey go on.
Di anti-graft agency say dem gatz freeze di account wen dem observe how money bin dey move from dia to "different suspicious accounts since 2 August".
According to di letter wey di EFCC write to direct di banks to freeze di Osun State govment account, dem tok say section 38(1) and (2) of di EFCC Act 2004 and section 24 of di Money Laundering Act 2022, give dem di power to take di action.
As di controversy dey continue, President Bola Tinubu direct EFCC to vacate di court order dem get to freeze Osun State govment account.
For one statement wey e personally issue on Thursday, Tinubu say im feel "deeply embarrassed no be bicos EFCC exercise dia mandate wey dey backed by court order, but by di timing of di agency action".
E order say make di commission stop whatever action dem get against di state govment.
Di Nigerian leader add say since e enta office, im don consistently maintain say anti-corruption and law enforcement agencies gatz dey allowed to discharge dia statutory responsibilities independently, professionally, witout fear or favour, or political interference.
E say sake of dat, im deliberately no dey chook mouth for dia operational activities.
Di president condemn di timing of di EFCC action as e say di time wey e happun go make pipo feel say di federal govment dey interfere wit di election.
Before Tinubu decision to chook mouth ontop di mata, many Nigerians condemn di action of di EFCC including di Nigerian Bar Association (NBA) president, Afam Osigwe, wey tok say di move to freeze a state govment account na abuse of power.
"No govment agency or any pesin get di right or di power to restrict withdrawal from di account of any state bicos, first of all, di order fit ground di activities of govment," oga Osigwe tell local tori pipo, Punch.
"If di EFCC know say pipo dey use any particular account for di purpose of fraud, dem fit get court order, but dem no fit make blanket order freezing di accounts of any state."
"Such an order dey unconstitutional and e also violate di powers of di EFCC and e fit amount to abuse of power. Such situation no suppose hapun," e tok.
Meanwhile, sake of di action of di EFCC, Govnor Adeleke sue di EFCC for 2 billion naira.









