Who be Senator Francis Fadahunsi wey pipo dey attack ova im viral 'kill dem' comment

Francis Fadahunsi

Wia dis foto come from, Francis Fadahunsi/X

Published
Read am in 6 mins

Osun state police command don invite Senator Francis Fadahunsi ova im now viral comment to 'kill members of di Accord party'.

Police invite Fadahunsi, wey dey represent Osun East Senatorial District for di National Assembly afta plenty reactions for social media afta one viral video show as e dey order im supporters to attack members of di rival Accord Party during one campaign rally for Ilesa, Osun state, southwest Nigeria.

Di senator for di video allegedly tell im supporters to "kill" any Acord party member dem see during di electoral process for some part of di state. Im comment bin come ahead of di state govnorship election wey go hold on Saturday, 15 August.

Police don ask di senator, wey be member of di All Progressives Congress (APC) to appear bifor di State Criminal Investigation Department (SCID) for Osogbo, on Wednesday, 12 August.

Di senator don deny di video, e say di video na AI generated and wetin e tok na to "kill dem by dia votes".

For inside one letter dated 11 August, di police summon di senator to "clarify di circumstances" wey surround di statements e allegedly make during di APC campaign on Tuesday.

Di letter wey di Commissioner of Police wey dey in charge of election duties for Osun State, Samuel Erale sign order Fadahunsi to report to di State Criminal Investigation Department (SCID) for Osogbo on Wednesday, 12 August at 11:00 am.

"Di invitation na based on di information for di hand of di Nigeria Police wey claim during your address for di aforementioned programme, you make statements wey dey considered to be threatening, inciting, and intimidating in nature, and di statement don already dey in circulation on various electronic and social media platforms," di letter read.

Tok-tok pesin for di Osun state police Abiodun Ojelabi, also tok say Police no go support violent public incitement.

"E be senator of di Federal Republic of Nigeria. We no dey tok about immunity for here. Even pipo wey no reach im status, we dey normally write invitation letters give dem. " If dem honour am, fine, If dem no come, den we go afta dem" Ojelabi tok as e appear for Channels TV to discuss di mata

"We don invite am, and wen e come, anytin e tok we go make am available to di public.

Di tok-tok pesin say bifor now, police don issue warnings against inciting statements.

"Seeing dat video, e call for serious concern, and dat na why we invite am. Make e come tell us wetin e dey try to tok and wetin e mean by "kill dem" for dat video.

"Make di speaker come and explain wetin e mean for di video bicos I fit try to interpret am and e fit dey be different from wetin e mean. But we all hear na wetin e toksaid, and we get very large community of Yorubas wey understand wetin e tok very well."

Wetin Fadahunsi tok for di video

Francis Fadahunsi

Wia dis foto come from, Francis Fadahunsi/X

For di video, Fadahunsi bin dey address one cheering crowd for Yoruba language, e instruct dem to violently confront members of di Accord Party.

"Which kind life be dis? We no want hear anytin about di Accord Party again for Ilesa. "how many pipo APC pipo don kill, no be una pipo dem dey kill? We don come tell una, until di day of di election, if you see dem, kill dem". Di Senator say na AI dem use change wetin im tok.

Di video wey Afrobeats star David Adeleke alias Davido wey be di nephew of di Osun state govnor wey dey seek re-election for second term post on social media go viral and e trigger swift condemnation across Nigeria.

Di video make di govnor Ademola Adeleke and im campaign council call on di Inspector-General of Police to arrest and investigate di lawmaker for voter intimidation and inciting political violence.

'Di video na AI' - Fadahunsi react

For one statement on Tuesday, Fadahunsi debunk di claim, e say na "deliberate misrepresentation", plus im speak for Yoruba and pipo dey misquote am.

Di lawmaker explain say im bin dey address di "continued killing of APC members" by alleged thugs for Ilesa, as e maintain say im party go "defend dia pipo" if di violence continue.

"Dem deliberately edit di video to change wetin I really tok.

"Wetin I tok na say if alleged killing of our party members by Accord Party thugs no stop, our party go retaliate. I bin dey refer to di continued violence and attacks against our members for Ilesa and oda parts of di state," Senator Fadahunsi tok.

"My statement dey very clear: if di killings no stop, we too go retaliate. We dey here to lodge complaints and demand justice. E dey unacceptable for human beings to kill fellow human beings di way dem dey allegedly kill our members for Ilesa.

"All di pipo wey dem kill na Nigerians and, indeed, sons and daughters of di same communities. I tok am clearly say if dem kill our party members again, we no go just fold our arms and watch. We go defend our pipo, even if dat kain incident happun on election day.

"Unfortunately, Davido and Olajengbesi bin take less dan two minutes from di speech wey last about 24 minutes and circulate am to achieve cheap political objectives. Dis na clear case of deliberate misrepresentation and manipulation," e add.

Who be Senator Francis Fadahunsi

Senator Francis Adenigba Fadahunsi wey currently dey di eye of di storm na Nigerian politician and retired customs officer.

Dem born am for 12 July 1952 for Ilase-Ijesa Oyo State, southwest Nigeria.

Di lawmaker wey currently dey serve im second term as senator wey dey represent Osun East Senatorial District under di platform of di All Progressive Congress (APC) for di 10th Assembly.

Bifor e join politics, di 74-year-old bin serve for Nigeria custom until im retirement.

Dem elect am first into di Nigerian Senate for 2019, and dem re-elect am to di 10th Assembly.

Senator Fadahunsi don serve and lead for different committees;

Govnorship election for Osun state go happun on Saturday 15 August across di 30 Local Govment Areas of di state.

Dis na di 7th time dem go conduct govnorship election for di state since civilian rule return for 1999.

Govnorship elections don happun for di state for 1999, 2003, 2007, 2010, 2014, 2018 and 2022.

Di election na one of di off cycle elections wey dey happun across Nigeria. Dis na sake of court judgement wey bin remove one sitting govnor and install im opponent for di seat after three years.