Tupac Shakur murder trial start – wetin to know about case wey dey start 30 years afta

American rapper, songwriter, and actor Tupac Shakur

Wia dis foto come from, Bob Berg/Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Di trial of Duane Keith Davis, di only pesin police charge in connection to di 1996 murder of ogbonge rapper Tupac Shakur go begin on Monday, 10 August, wit jury selection.

Dis dey come 30 years afta di rap icon die from gunshots for Las Vegas Strip.

63-year-old Duane "Keffe D" Davis dey face one charge of murder wit deadly weapon wit di intent to promote further or assist one criminal gang for Shakur death.

Di jury selection go begin Monday, and di trial dey expected to last for about one month.

US police bin arrest di former gang leader for September 2023 and charge am wit di 1996 murder of rapper Tupac Shakur.

Prosecutors no tok say e kill Tupac Shakur, but dem say na im provide di gun wey dem use kill am for di drive-by shooting.

Di trial go bring to end one of di biggest mysteries for hip-hop world wey grab di world for decades.

Shakur, wey also go by di stage names 2Pac and Makaveli, dey considered as one of di most influential rappers of all time.

How Tupac take die

E don pass three decades since dem kill rapper Tupac Shakur.

E die on 13 September 1996 at di age of 25, afta dem shoot am four times for Las Vegas.

Dem shoot am shortly afta e comot one Mike Tyson fight for Las Vegas. Shakur bin dey inside one black BMW wey Suge Knight, one founder of Death Row Records drive.

At about 11:15 p.m., Knight stop di car for one red light for one intersection just outside di Strip.

One white Cadillac pull up next to di BMW and someone start to dey shoot Shakur motor.

Four bullets hit di rapper and e die for hospital six days later, however, Knight survive.

Wen and wia dem go do di trial

Di trial go take place for Clark County District Court for Las Vegas. Judge Carli Kierny dey preside ova di case.

Di trial dey scheduled to begin on Monday wit jury selection wey fit take up to one week. Di prosecution and the defense go then give dia arguments in opening statements and witness testimony go start.

Inside di courtroom, seats for pipo no go too much, as daily lottery go dey for a chance to get one.

But one room go dey for di second floor of di court wey go dey open to di public and e go show live feed of di trial.

Who be Tupac Shakur?

Dem born Tupac Shakur for East Harlem, New York City. E release im debut album 2Pacalypse Now for 1991.

Tupac, wey im stage na 2Pac, bin go on to enjoy chart success wit multiple hits wey include California Love, All Eyez on Me, Changes and I Ain't Mad at Cha.

Pipo tok say im music dey often touch on themes around social issues like inequality.

Plus im contribution to di music world continue even afta im death.

For 2004, di posthumous single Ghetto Gospel, wey feature one sample from Elton John Indian Sunset, bin number one for UK singles chart.

Tupac don sell more dan 75 million records worldwide - and for 2017, dem induct am into di Rock & Roll Hall of Fame.

E also feature for feems like Juice, Poetic Justice, Above The Rim, Gridlock'd and Gang Related.

For 2023, e receive one star on di Hollywood Walk of Fame – wey make am one of only 12 rap artists to collect am.

Duane Davis charged wit 1996 murder of rapper

Wen police arrest Davis for 2023, dem say na im plan di deadly shooting afta im nephew bin dey involved for one fight wit Shakur for one casino.

Dem arrest Davis near im Las Vegas home early on Friday, and e go appear for court within days. Las Vegas police (LVMPD) tok.

Greg Kading, one retired Los Angeles police detective wey spend years investigating Shakur murder, bin tell Associated Press say im no dey surprised by Mr Davis' arrest.

"All di oda direct conspirators or participants, all of dem don die" Oga Kading tok, as e call Mr Davis "di last man standing" for di case.

For court, prosecutor Marc DiaGiacomo describe Mr Davis - one former leader of di South Side Compton Crips street gang - as di "on-ground, on-site commander" wey "order di death" of Shakur.

For one news conference later on Friday, police officer Jason Johansson say di force persistence for di investigation bin "ultimately pay off", bifor e explain wetin lead to di breakthrough.

E say Orlando Anderson, di suspect late nephew, and Shakur bin get fight for one casino shortly bifor pesin shoot di rapper on 7 September 1996. E die for one hospital a few days later.

Mr Johansson show tori pipo hotel security camera footage of how dem dey beat Anderson.

E say dis lead to di retaliatory shooting of Shakur as e dey inside im car for one red light.

Davis don admit on multiple occasions, wey include im 2019 tell-all memoir, Compton Street Legend, say im dey inside di car wey dem take fire di gunshots.