'Wetin happun to me go discourage Nigerians from voting for 2027 elections' - Emeka Ike

- Author, Tamara Ebiwei
- Role, Broadcast Journalist
- Reporting from, Abuja, Nigeria
- Published
- Read am in 3 mins
Veteran Nollywood actor, Emeka Ike don continue to tok about how im wake up to see say im voter details dey go viral for social media.
Di actor voter details bin spread online some weeks ago afta media aide to one politician post Emeka Ike details for im page.
Dis action bin generate social media tok-tok online as pipo begin ask questions about how safe pipo data dey for di Independent Nigeria Electoral Commission (Inec) hand and how secure dia system be if ordinary pesin fit just post anoda pesin details like dat.
Inec don respond to dis mata since and dem tok for press release say wia dem confam say no be outsider do am.
"No external breach of di CVR data base happun, no hacking incident and no unauthorized external access to di Commission ICT infrastructure."
Inec add say di pesin wey do am access di data wit valid user credentials wey dey assigned to personnel wey dey engaged with di ongoing CVR exercise, but di pesin disclose am without proper authorisation. Dem tok say Investigation still dey go on.
But for exclusive interview wit BBC News Pidgin, Emeka Ike tok say im surprise as im see in voter details online.
"Wen I see my voter details online, e shock me becos na di highest level of irresponsibility of a serving govment official wey know say im no suppose do am.
"Na arrant abuse of power, e show say somebody feel say notin fit happun and na shock to me, plus di fact say I dey exposed to my fans, dem expose my details evritin.
'Inec explanation no make sense to me'
According to wetin inec tok, wey dem claim say na 'insider' do am di Mechanical Engineer say Inec explanation no make sen to am and wetin dey pain am pass be say dem tok say dem still dey investigate di mata and dem neva arrest anybody yet.
"inec explanation no make sense, dem no tink di mata well-well bifor dem make dat Press release. I accept say na una do am, who you come dey investigate again?" Im ask.
"Na una do am, pesin wey una employ be una sef,... ed ey smell connivance, e be like say dem take us like mumu na wetin I dey see."
Di Nollywood veteran actor say dem don report di mata to di IGP but dem neva invite dem to come yet, im add say dem don petition di mata to DSS wey neva call dem too, and im allege say Inec neva still arrest di inec staff wey get access to pipo data and bring out Emeka Ike own.
Im tok say na only Data Protection pipo wey don call am to hear im own side of di mata for Nigeria, however some international organizations wey dey monitor elections don reachout to am to hear im side of wetin happun.
Di Yabatech graduate wey tok say im enta politics to serve explain to BBC Pidgin say wit wetin happun to am Nigerians go dey discouraged to vote for 2027 but im dey encourage dem mak dem no give up on di system.
NDC Primaries wahala
About di Nigeria Democratic Congress [NDC] primary elections wey bin happun, Emeka Ike tok say im no wan chook mouth for data mata for now untill official results for di House of Representatives wey im contest for comeout.
Im tell BBC say na wen im no see im name dem to explain wetin happun. According to am dis one wey im come out to contest so no to test di ground and na im sponsor imsef sake of say im no want anybody wey go begin call am anyhow.
"I wan know who dis pipo be, dis kontri na only una get am? if pesin like me no dey legitimate enuf to contest for di House of Representatives, den na who qualify





