UK Prime Minister Keir Starmer don resign

Keir Starmer announce im resignation dis Monday morning

Wia dis foto come from, Reuters

Published
Read am in 4 mins

UK Prime Minister Keir Starmer don resign, afta less dan two years in office.

Starmer enta office as Prime Minister on July 5, 2024 afta im Labour Party win landslide victory for di general election,

For im broadcast dis Monday morning, Starmer tok say e don tok wit di King to inform am of im decision to resign.

Howeva, Starmer go remain in office until di Labour Party conclude plans to elect a new leader bifor di parliament go return from dia summer recess by September dis year.

E tok say di National Executive Committee of di Labour Party go set out timetable on 9 July, to open nominations for di leadership position, and di process go dey completed by di summer recess.

This will mean a new leader is in place before parliament returns in September.

"To waka go Downing Street two years ago na di proudest moment of my life, Starmer tok.

Afta leaving di "biggest job for di kontri", Starmer tok say e go now spend more time to do "di most important job".

"To be di best husband I fit, to my fantastic wife Vic, wey don stand by my side like rock through good times and bad. And to be di best dad wey I fit be to my beautiful children, who be my pride and joy," e tok.

Starmer tok say im see coming into politics as opportunity for am to change di lives of millions of pipo.

E say di objective of im administration, no be just to take power for power sake, "but to change Britain for di beta. To build a fairer kontri wit dignity and respect, wia evrione go dey see, evrione go dey valued, wealth and opportunity for all, no be for just di privileged few".

Starmer promise say e go do evritin e fit do to make sure say e handover power in orderly mana and e go give im successor im full support.

E tok say di pesin wey go take ova from am know say e dey inherit a Britain wey dey stronger and fairer dan two years ago.

Di Prime Minister tok say e bin inherit Labour Party wey bin dey "politically, financially and morally bankrupt".

E say pipo bin tell am say di party don scatter but e don prove dose pipo wrong.

According to am, e change di party by "ripping out di poison of antisemitism, and restoring trust for di economy, defence and national security".

Cabinet ministers - including di Deputy Prime Minister David Lammy - dey watch as Keir Starmer announce say e go resign.

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Cabinet ministers - including di Deputy Prime Minister David Lammy - dey watch as Keir Starmer announce say e go resign.

Starmer say im don tell di Labour Party governing body to set out timetable to replace am as di leader of di party, and say nominations go open on 9 July and close one week afta, on 16 July.

For months now, pressure don dey mount on Keir Starmer to resign as Prime Minister, especially afta di Labour Party bin do very poorly for local elections for England and Wales for May dis year.

More dan 150 Labour Party members for di British Parliament bin call for am to step down as di pipo don show by dia votes say dem no longer get confidence for im leadership.

Labour Party bin lose almost 1,500 councillor seats for local elections across England, sake of say plenty pipo don turn dia support to di Reform UK Party, and di Green Party also don chop part of Labour Party support for London and oda urban areas.

Voters bin also kick di party out of power for Wales, wia dem bin dey enjoy political dominance for more dan 100 years.

For Scotland too, Labour bin win only 17 out of di 129 seats for di Scottish Parliament, dia worst eva result for parliamentary elections for di kontri.

But Starmer for im speech afta di elections, even though e admit say im govment bin make some mistakes, e insist say dem "get di political choices right" and say im go prove di "doubters" wrong and e no go quit.