Osun State election result across 30 LGAs

Ademola Adeleke, Bola Oyebamiji, Najeem Salam

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke, Bola Oyebamiji, Najeem Salam/Facebook

Published
Read am in 3 mins

Residents of Osun State don cast dia votes to elect di next govnor for di state across 30 local goment areas during di Saturday, 15 August poll.

Na 15 candidates dey contest for di election, including di top contenders, Ademola Adeleke of Accord Party and Bola Oyebamiji of All Progressive Party.

Accord candidate Ademola Adeleke na di sitting govnor of di state and im dey bid to return for second term.

Bola Oyebamiji wey be di preferred candidate of di former govnor of di state, Gboyega Oyetola, dey contest under di All Progressives Congress to win di position back for Nigeria ruling party.

Osun get 2,339,233 registered voters, but na only 1,906,390 of dem, wey be 81.50%, don collect dia Permanent Voter Cards (PVCs) wey dey eligible to participate for di Saturday poll.

Di voting wey start by 8:30am end by 2:30pm but e extend beyond dat time for some polling units.

Meanwhile, di Independent National Electoral Commission (Inec) don begin upload results for dia Result Viewing Portal (IRev).

Di kontri electoral bodi begin upload di results shortly afta voting end for several polling units across di state.

As of di time wey BBC News Pidgin file dis report, dem don upload 663 polling units results to di IReV portal out of 3,763, wey represent 17.62% of di total results expected.

Dis development show di commencement of di electronic transmission and public viewing of polling unit results as officials proceed wit di collation of results from di election.

Di IReV portal dey allow members of di public plus oda stakeholders to view results dem upload from polling units. E dey provide more transparency for di electoral process.

Hia na wia you go see all di result wen Inec start to announce am.