Who be Katie Zachariah wey no last five days as White House Press Secretary?

Katie Zacharia
Published
Read am in 4 mins

Katie Zacharia don comot for her post as White House press secretary, just five days afta her first public appearance wey shake small.

US President Donald Trump tell reporters small time bifor dem announce say she don comot .

Im tok say e tell her say "you no need to do am if you no want" and "honestly, if I be you, I for reconsider."

Zacharia collect heavy criticism for her first press briefing on Tuesday, wey last less dan 15 minutes and na only three questions reporters ask.

Di 42-year-old spend di days afta dat to defend herself, and answer tough questions from tori pipo about her credentials and weda she ready for di job.

Trump hint say she go soon comot early Friday afternoon, during one emergency press conference for front of Marine One helicopter.

"I tell am, 'Na dis one you want, Katie? Becos honestly, you no need dis kind stress,'" Trump tok.

"You no need make dem treat you like dis," e continue, add say e believe media treat am "pretty nastily.

"Hours later, she praise Trump as "kind, wonderful, gracious, thoughtful, enthusiastic, and di most hardworking man" for X, write say na honour to work for am.

Wetin bin really happun?

For di press briefing on Tuesday Zacharia bin show say she bin dey nervous during her first White House press briefing, wia she dey read her tok-tok points from notebook.

She answer only few questions and even refer to her husband as di president.

During di briefing, one reporter ask Zacharia — wey Trump and odas don call attorney and wey graduate from Pepperdine University law school — wia she pass bar exam.

To practise law for US, attorney must enta state bar association by passing one hard exam.

"When I dey for China," na how she ansa.

Afta tori pipo do serious digging and scrutiny, Zacharia admit on Thursday say she no pass bar exam.

She still tok for statement say she practise international transaction law for China wit "appropriate credentials.

"Questions about her legal credentials becom major points for tok-tok throughout di week, wit Sean Hannity from conservative- Fox News wey dey throw pointed questions for her during interview on Thursday.

Wen she tok say she no pass bar, im reply: "Why you no just tok say, 'I neva practise law?'

Zacharia also describe how quickly she take di press secretary role — dem hire am less dan one week bifor her first outing — wey make am ask: "I dey hear say you tink say staff for don prepare you well-well?"

Wen she appear for Fox & Friends, wey Trump dey watch evritime, on Friday, Zacharia face di same line of questioning.

She tell di show hosts say she no tell Trump say she no be attorney because "dem no ask those questions,".

She tok say dem hire her for communications role, no be legal one.

Host Lawrence Jones kon ask her: "You tink say you still get di president confidence?"

She avoid to give direct answer but end wit: "I dey hope to fit build di confidence and trust of evribody around me."

Zacharia early exit na di quickest among Trump White House press team.

Anthony Scaramucci comot for im post as White House communications director afta only 10 days during Trump first term.

Katie Zacharia profile

Katie Zacharia dey 42 years wen US President appoint her as di sixth tok-tok pesin for im two administrations.

She be political commentator wey bin dey regularly show face for conservative media like Newsmax and Fox News.

She bin work small as tok-tok pesin for di Department of Homeland Security (DHS).

Her LinkedIn also show say she bin work as communications adviser for Trump social media Platform wey dem dey call Truth Social.

Wen she first start her career, Zacharia bin work as intern for di Republican National Committee.

She bin also work for di White House Office of Political Affairs wen Bush bin dey office for 2006.