BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
'Heads suppose roll' - Nigerians react as Head of Service Didi Walson-Jack take responsibility
Di Head of di Nigeria Civil Service say her office take responsibility for not doing dia due dilligence bifor approving di 'fake agency' to take off.
US launch 'heavy' strikes on Iran afta attempted attack on American sojas
Afta a short period of relative calm wen dem pause di fight, both sides don start again wit missile attacks.
'My heart dey shattered' - wetin we know about di attack for Benue State wey kpai 13 pipo
For statement wey di Benue State Police Command release on Wednesday, tok-tok pesin, DSP Orchia Aondongu say di jaguda pipo enta di community and dia aim na carry cattle wey one resident, Peter Ambulus get.
Nigerian Army appoint General Officers Commanding for new Army divisions
Nigeria Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Waidi Shaibu don approve di appointment of General Officers Commanding (GOCs) to di newly established Army Divisions
South Africa govment to prosecute citizens wey cause kasala during anti-migrant protests
Tok-tok pesin for South Africa Department of International Relations and Cooperation tok say govment dey willing to prosecute citizens wey act unlawfully.
'Migrants no suppose be scapegoats for unemployment or crime for South Africa' - Ramaphosa react to anti-migrants violence
Ramaphosa bin take firm stand against attacks on foreign nationals for South Africa during di Ordinary Session of di 7th Legislature of di Pan-African Parliament
13 pipo dead and ova 100 aftershocks afta powerful earthquake hit Japan
Many odas dey for "cardiopulmonary arrest" - one term dem dey often use for preliminary reports for Japan bifor dem officially confam say pesin don die.
Why US support Chad afta dem join Mali, Niger and Burkina Faso to withdraw from ICC
Di US don back Chad under Mahamat Déby afta dem become di latest kontri to wthdraw from di ICC sake of bias. But wetin di exits mean for di ICC?
Kaduna govment react to gunmen killing for community wia attackers kpai about 30 pipo
One catholic priest wey dey work for di community tell BBC Pidgin say dis no be di first time wey dem go face attack like dis inside dis 2026.
Special Tori
'Nigerian nationals don lose dia life, South Africa dey use xenophobia as distraction' - Wetin Nigeria and Ghana tok so far
Di Foreign minister Ablakwa tell di BBC say South Africa no dey do enough to stop attacks on foreigners.
Ghana Appeal Court free ex-govment official Sedina Tamakloe wey di US extradite to serve her 10-year jail term for corruption and stealing
Ghana Appeal Court decision to acquit and discharge ex-govment official Sedina Tamakloe afta she return to serve her 10-year jail term for corruption and stealing, dey cause kasala.
US court jail Ghanaian businessman Derrick Yeboah for seven years ova $10m romance scam
Derrick Van Yeboah be di latest Ghanaian wey dem sentence for di US ova romance scam, di court go deliver verdict for anoda businessman 'Dada Joe Remix' on 28 September 2026.
Front line of Ecuador drugs war wia police dey fight gangs, guns and corruption
Di BBC go on patrol wit Ecuador police, wey dey battle huge increase in drug crime.
Nigeria Super Falcons suffer 3-2 defeat against first-timer Malawi as dem dey chase dia 11th Wafcon title
Nigeria dey face Malawi, Zambia and Egypt for di 2026 Women's Africa Cup of Nations, looking to defend dia crown and claim an 11th title.
Di tallest man for Ghana wey popular as 'Awuche' don die
32-year-old Abdul-Samed Sulemana aka Awuche wey be 'di tallest man' for Ghana don die.
Anthony Joshua win first fight afta accident wey kill im friends for Nigeria
Anthony Joshua suffer two knockdowns bifor e recover to dramatically stop Kristian Prenga for di second round.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.












































